Bobrisky marriage proposal to Oba of Benin don cause serious gbege since last week. Eventhough Bobrisky don apologise, we hear say he/she don run comot for Benin. Many Edo youth don put mouth for de tori as dem talk say 'Benin nor be Eko', and we hear say for Benin kingdom, Oba get respect wel, nai be say Bobrisky don do pass him/her self. Na de tori we wan put mouth today for Everyday Tori. Make una join us talk how de mata take end.