As plenty mama come de busy nowadays sake of say them de do work or business, pikin dem come de busy also....o, sake of say some mama dem de comot for house and no body to leave pikin for, the pikin go come need to start school or the one when dem de call day care. But the tin be say, wetin some pikin dem their eye de see for day care....eeeh, Na only God fit talk am.... o. Some pikin never talk but den don start school, sake of say say mama de do work. Na this one we wan chuk mouth put today... o.  Make una join us my people.