Re-visiting The Very Essence of Our Nigerianess One Knowledge Byte at a Time... Visit our website https://everyevery.ng/ Subscribe to our Youtube channel for mouth-watering content from Everyevery https://www.youtube.com/channel/UCnZkv3TEjr2WvSNirNu_wZg
Egbon: ( Clap…, Nawa for this Naija o, we dey shout make dem end SARS, dem say dem don dissolve am, come carry another one con meet us, which kain thing be this now self
Mazi: I don talk am before say I no know wetin all these protesters want make the government and the IGP do, abeg shey you no still like this new unit like this
Read more: https://everyevery.ng/pidgin-news-129-from-sars-to-swat-what-is-the-difference/
Mazi: This Nigerian youths don dey over do like this o, abi naa wetin remain wey dem want make government do now, why dem still dey do protests up and down.
Egbon: Sometimes, you go just open your mouth waa like goat wey wan carry bread, shey you no read abi hear for news say police still dey kill and harrass innocent Nigerians, you no hear say dem kill Jimoh Isiaq for Ogbomosho
Read more: https://everyevery.ng/pidgin-news-128-endsars-protest-continues/
Egbon: End SARS, End SARS saa everyday naa the same song we dey sing all this year, nigbawo gangan, when will government End SARS self, abi dem want make SARS kill us finish ni
Mazi: Egbon what are you talking about now, sometimes self you only listen to radio and read the newspaper, you no dey pay attention to the news, IGP don give order… (cut in)
Read more: https://everyevery.ng/pidgin-news-127-when-will-government-end-sars/
Mazi, wetin you go do for Nigeria Independence Day? Egbon, I no understand this your question o. me I no dey do anything for independence; the day dey like every other day for my eye
Aah, so you no go follow celebrate the birthday of your country.
Read more: https://everyevery.ng/pidgin-news-126-nigerian-independence-day/
Egbon good morning o. You still dey house? You never go protest for road? Mazi, good morning. As I dey so, na office I dey go from here; this labour congress strike dey full of confusion.
How e no go full of confusion when federal government don threaten people finish and police don talk say dem go pour teargas for una eye; if una go do protest
Read more: https://everyevery.ng/pidgin-news-125-dont-trek-for-anybody-trek-for-yourself/
Egbon, you don hear say court don order labour congress make dem no do any strike? Mtshw, Mazi I hear am o. I no know say court get right to stop people from going on strike.
Dem get right now. Na court you dey talk of o; the keeper of our law for this country.
Read more: https://everyevery.ng/pidgin-news-124-let-strike-go-on-strike/
Mazi, you don ready for labour congress strike? Egbon, which strike again?
Ahn Ahn, you never hear say labour congress go start strike starting from 28th of September?
Read more: https://everyevery.ng/pidgin-news-123-labour-congress-declares-strike/
Egbon, Obaseki don win Edo state election ooo. I no tell you? I tell you now. Mazi, I still no fit believe my ears. So you mean say Obaseki chop this Edo state election?
E chop am. E chop am clean mouth sef. I no tell you say Oshiomhole no get hand like that for Edo state again?
Read more: https://everyevery.ng/pidgin-news-122-obaseki-wins-edo-state-election/
Egbon, good morning o. Abeg wetin be Ferrari? Because I just read news say Otedola buy Ferrari for en children and people no dey allow me hear word because of am, even my wife and pikin. Mazi, how you go ask that kind question? You no know say Ferrari na motor
And so? If Ferrari na motor, Otedola be the first person to buy motor for en pikin?
Read more: https://everyevery.ng/pidgin-news-121-ferreri-is-a-car-not-motor/
Egbon, you know how many new corona cases we get today for this country?
Mazi, how many?
Read more: https://everyevery.ng/pidgin-news-120-ninety-is-a-good-number/
Good morning o, Mazi you just dey wake from sleep?
Mtshww, Egbon I no even know for myself again… the kind sleep wey I dey sleep these days enh.
Read more: https://everyevery.ng/pidgin-news-119-government-to-ban-alcohol/
Mazi, men don dey hear am for this country o
Egbon, wetin happen?
Read more: https://everyevery.ng/pidgin-news-118-kaduna-will-castrate/
Good morning, Mazi
Egbon, what is good about the morning… nothing dey good about the morning. You know how much I buy fuel this morning? Mazi, you still dey on top this fuel matter? I know how much you buy fuel this morning because I know the price of fuel. See enh, make I tell you something… in a way this fuel subsidy wey dem commot na good thing.
Read more: https://everyevery.ng/pidgin-news-117-to-buy-or-not-to-buy-fuel/
Thirty one billion for the account oooo Ahn ahn, Mazi this one wey you dey sing so; you get thirty one billion for your account?
Ha ha Egbon, abeg no allow me laugh this early morning; you think say you go see my break light if I get thirty one billion for my account?
Read more: https://everyevery.ng/pidgin-news-116-thirty-one-billion-for-the-account/
Egbon, you don hear say dem don increase fuel price? Mazi my brother, I don hear. I talk am… the time wey dem reduce fuel price enh, I talk say dem go still increase the fuel price and na wetin dem don do so.
Mtshw… kai I just tire, wetin dey stable for this country
Read more: https://everyevery.ng/pidgin-news-115-fuel-price-is-hurting-mazi/
Egbon, good morning o
Mazi, how far now, this wan wey your voice dey sound like frog dey inside your throat. Wetin happen?
Read more: https://everyevery.ng/pidgin-news-114-pastors-and-their-wahala/
Egbon, eighty five million naira, a whole eighty five million naira Mazi, wetin happen to eighty five million naira? Person dey owe you eighty five milliona naira?
I no know say this big brother thing wey dem dey do, the winner go win a whole eighty-five million naira
Read more: https://everyevery.ng/pidgin-news-113-eighty-five-million-reasons-why/
Mazi good morning o
Egbon, good morning… I just dey read say Aisha Buhari don come back from Dubai, thank god say the sickness wey carry am go no be anything serious. Mtshw, who tell you say na sickness carry am go Dubai?
Read more: https://everyevery.ng/pidgin-news-112-no-dubai-no-wedding/
Egbon, good morning o… since you no wan call today, I say make I phone you. How you dey?
Mazi, we thank god for everything. No mind me… I just dey read news about this former minister Femi Fani Kayode Oh, you don see the video?
Read more: https://everyevery.ng/pidgin-news-111-femi-fani-kayode-vs-journalist/
Mazi, good morning… abeg which time you dey open shop?
I like how you do Egbon, straight to the business. I dey open shop by eight o’clock sharp; na my boy dey open my shop for morning before I come. Wetin you wan buy? Praise god, Egbon wan buy something for my shop today A few things, my pikin go bring the list come.
Read more: https://everyevery.ng/pidgin-news-110-shop-the-container-that-doesnt-fall/
Mazi, it’s a good Saturday morning
Egbon, this wan wey dey rejoice for this morning, e be like say you don chop.
Read More: https://everyevery.ng/pidgin-news-109-el-rufai-did-not-meet-the-bar/
Mazi, how many years you go use take answer your phone?
Egbon, the phone no ring more than two times o, wetin happen? You never chop this morning? Because I no say na wen you never chop na em your patience dey run commot. No come faint like pondei o
Read More:https://everyevery.ng/pidgin-news-108-pondei-speaks-about-his-acting/
Mazi, this life no balance o
Egbon, wetin happen again? Wetin happen… government don thief another money
Read more: https://everyevery.ng/pidgin-news-107-kano-singer-receives-death-sentence/