Correct FM: Recent Episodes

Correct FM

Correct FM team in Lagos, Kano, Enugu, Kano, Kaduna, Ibadan (and still expanding) bring you insightful, educative and exclusive audio content all in pidgin. Listen. Subscribe. Share.

View Details

Hear all di latest tins wey dey happen ontop politics and entertainment for awa country Nigeria and obodo oyinbo. 

View Details

Na here you go hear all di latest tori wey dey happen ontop politics, entertainment for our country Nigeria and Obodo oyinbo. 

View Details

Hear all di tori wey dey happen for awa country Nigeria and Obodo Oyinbo ontop Sport, entertainment and politics.  

View Details

Hear all di latest thing wey dey happen for awa country nigeria and obodo oyinbo ontop sport, politics and entertainment. 

View Details

Hear di latest tori ontop wetin dey happen in awa country Nigeria and obodo oyinbo. 

View Details

Hear di latest tori wey dey happen currently for awa country nigeria and obodo oyinbo. 

View Details

Hear all di thot ori wey dey happen for awa country Nigeria and obodo oyinbo.

View Details

Hear all di tori wey dey happen for awa country Nigeria and Obodo Oyinbo. 

View Details

Hear all di tori wey dey happen for our country Nigeria and Obodo Oyinbo ontop sport, politics and entertainment. 

View Details

hear all di latest tori wey dey happen for awa country Nigeria and obodo oyinbo. 

View Details

Hear all di tori wey dey happen for awa country Nigeria and Obodo Oyinbo. 

View Details

Hear all di tori wey dey happen for awa country nigeria and obodo oyinbo

View Details

Hear di latest tori wey dey happen inside awa country nigeria and Obodo Oyinbo. 

View Details

Listen to all di tori wey dey happen for awa country Nigeria and obodo oyinbo. 

View Details

Listen to all the tori wey dey happen for awa country Nigeria and obodo oyinbo. 

View Details

hear di latest tori wey dey happen ontop correct fm. All di matter for Nigeria and obodo oyinbo. 

View Details

Hear all di tori wey dey happen for awa country nigeria and obodo oyinbo. 

View Details

Hear all di latest tori wey dey happen for awa countri Nigeria and obodo oyinbo.

View Details

Hear di tori wey dey happen inside awa country Nigeria ontop politics and every oda tori even for obodo oyinbo. 

View Details

Hear di latest tin wey dey happen for awa country Nigeria and Obodo Oyinbo.

View Details

Listen to all di tori wey dey hapen for awa country Nigeria and Obodo Oyinbo. 

View Details

Hear di latest tori wey dey happen inside awa country Nigeria and obodo Oyinbo

View Details

Hear di latest tori wey dey happen for di country nigeria and obodo oyinbo. 

View Details

Chairman of the Nigeria Governors’ Forum (NGF) and Ekiti Gov. Dr Kayode Fayemi, talk sey about 80 million doses of COVID-19 vaccines go soon dey available for the country, to immunize 40 percent of the country this year.

He say this na part of measures wey dem put in place to reduce the spread of the deadly virus this year, he say den dey expect another batch of 60 million to arrive for 2022.

View Details

Hear di latest news wey dey happen for the country and obodo oyinbo ontop correct fm. 

View Details

Lagos State Governor, Babjide Sanwo-Olu don make am force make pipol for the state to wear face masks or face six months jail term.

Sanwo-Olu announce the approval of N200 million to support COVID-19 patient management and treatment efforts of two Federal Government Treatment Centres for the state.

State Government say DeM dey disappointed sey lagosian no obey guidelines and protocols wey dey to reduce the spread of the infection.

View Details

Listen to di news wey dey happen for awa country Nigeria ontop poilictics and sport and everitin wey dey happen for obodo oyinbo

View Details

all di latest tin wey dey happen for inside awa country Nigeria and obodo oyinbo.

View Details

Nigeria Union of Teachers say dem dey concern about the rising coronavirus cases, plus sey dem go do meeting on Thursday to talk the pandemic and compliance with COVID-19 protocols for schools inside the country.

Secretary-General of the NUT, Mike Ene, talk this one, as primary and secondary schools for many states reopen with semi obedience to COVID-19 safety rules.

View Details

FOUR riot policemen don die after about 100 bandits attack them for Birnin-Gwari Funtua highway.

The operatives dey attached to Police Mobile Force 9 Squadron, Kano, fight the attacks con wound the criminals.

According to statement from the Force talk talk person, CP Frank Mba, one officer dey missi from the personnel wey dey attached to Operation Puff Adder.

View Details

National Identity Management Commission (NIMC) don insist sey e dey compulsory for Nigerians to visit the enrolment centres to complete them National Identification Number registration.

Dem sey e dey important make people no dey carried away with the NIN wey dem get thru Bank Verification Number (BVN) record wey join with them National Identity Database.

the agency tell pipol wey get den NIN through such a process to visit them enrolment centres to validate them number.

View Details

Lagos State Police Command say dem arrest atleast 43 persons have been arrested cos dem violate COVID-19 protocols for the state.

The state Police Public Relations Officer, CSP Muyiwa Adejobi, say them arrest the violators for Eclipse Night Club for Victoria Island on Sunday.

He say dem transfer the violators to the Task Force on Environmental Sanitation and Special Offences (Enforcement Unit) for prosecution on the orders of the state Commissioner of Police, Hakeem Odumosu.

View Details

Academic Staff Union of Universities say after den look the COVID-19 protocols for the universities them see sey the institutions no ready for safe reopening.

The union talk this one based on the directive of the National Universities Commission sey universities fit resume on January 18, but must obey COVID-19 protocols for hostels and lecture halls.

ASUU say although dem members dey ready to start work, government neva put measures in place for safe reopening of the schools.

View Details

dey informate untop di matta wey dey happen for awa country nigeria and latest news for obodo oyinbo. 

View Details

Federal Government go need about N2.44tn for the vaccination of 164.8 million Nigerians, wey no fit get access to free vaccines wey the country dey expect from the international community.

Coronavirus vaccines dey available for world like the ones Pfizer, Johnson & Johnson,  Oxford and Novavax.

View Details

Hear all di tori wey dey happen for awa country Nigeria and obodo oyinbo. 

View Details

Lagos State Government don order all public and private schools for the state to reopen for the second term 2020/21 academic session from Monday, 18th of January, 2021.

Na Commissioner for Education, Mrs Folasade Adefisayo talk this one

She say this one dey in line with the Federal Government’s directive plus the second wave of COVID-19 Pandemic.

Adefisayo tell all schools sey make dem make efforts to comply with all the outline Covid-19 requirements for resumption schools.

View Details

Hear all di tori wey dey happen for awa country Nigeria ontop politics and everi oda matter. No miss the Obodo Oyinbo news too. everything dey ontop correctfm.

View Details

hear all di tori wey dey happen for inside awa country and obodo  oyinbo ontop news sharp sharp. 

View Details

hear di latest ontop correct fm. tins wey dey happen for awa contri and obodo oyinbo

View Details

Poland and Bayern Munich striker Robert Lewandowski don get crown as 2020 Best FIFA Men’s Player of the Year.

Lewandowski beat off competition from Lionel Messi and Cristiano Ronaldo to land the award.

Lewandowski don be the favourite for the Ballon d’Or, bet France Football decide say dem no go assign am for 2020.

View Details

Federal Road Safety Corps (FRSC) Management say effective 21 December 2020 pipol go use the National Identification Number (NIN) to process of driver’s license,

This one dey happen after Federal Government’s directive for the harmonisation of citizens’ data by relevant agencies, dem explain sey “all driver’s licence applicants go present them National Identification Number before then attend to dem

View Details

Head of the UN children’s agency, UNICEF, say teachers gats dey among the pipol wey dem give priority access to the COVID-19 vaccines.

She Say Covid-19 pandemic don cus havoc for children’s education.

Henrietta Fore say to Vaccinate teachers na critical step to put things back on track.

View Details

Nigeria’s former Minister of Finance, Dr Ngozi Okonjo-Iweala, don assure Nigeria and other African countries sey dem go fit access to COVID-19 vaccines from the end of January through the first quarter of 2021.

She talk this one for inside close door meet wey she get with Minister of Foreign Affairs, Geoffrey Onyeama for Abuja.

She say international initiative dey work with World Health Organization, the Coalition for Epidemic Preparedness Innovations (CEPI), GAVI and the international community, to make sure sey the vaccines reach developing and poorer countries, cheap and fast.

View Details

Chairmo of Nigeria Governors Forum, Kayode Fayemi, say Boko Haram people wey escape from North-East part of the country dey enter other parts of Nigeria as bandits and kidnappers.

Oga Fayemi yarn dis one ontop interview for TV as e call for correct approach to take end the wahala.

E say even if na to declare state of emergency, say e no get opinion ontop am as dem never discuss matter of state of emergency for the Governors’ Forum.

View Details

Management of Arik air don sack 300 staff wey dey work with de. Na today dem yard dis one for one statement.

Arik air blame the sack to wetin dem see from the covid19 pandemic.

The company explain say dem go give the people wey dem sack … package with help of aviation unions dem.

View Details

Listen to di tori wey dey shele for awa contri nigeria and obodo oyinbo. 

View Details

Lagos State Judicial Panel on Restitution for Victims of SARS Related Abuses don dismiss petition wey wan force N300 million court judgment against the Special Anti-Robbery Squad (SARS).

Justice Rilwan Aikawa of Federal High Court been award the compensation against the police for the death of one Jimoh Kehinde in 2018.

Two years after the judge award d penalty, one Paschal Bonu carry the case before the judicial panel as the third petition.

View Details

President Muhammadu Buhari din give military march order to fight the insurgents. He talk this one

Two days after Boko Haram terrorists kill 43 farmers for Zabarmari area of Borno State.

He say the marching order no be one-off, but continuous basis, until dem root out the terrorists.

View Details

All di tori wey dey happen for awa country and obodo oyinbo. 

View Details

Defence Headquarters, say United Nations report sey na 110 pipol na him Boko Haram kill on Saturday for Jere Local Government Area of Borno State no correct.

Coordinator, Defence Media Operations, Maj. Gen. John Enenche, say na, 43 dead body dem recover from Zabarmari area of the northeast state.

View Details

House of Representatives Committee on top Public Accounts, question Federal Government officials on how dem spend the $125m loan wey den collect from the World Bank.

The committee call pipol wey sign the World Bank account wey belong to the Office of the Accountant General of the Federation where them put the money from there share am to different government bodies.

Director-General, Budget Office of the Federation, Ben Akabueze, wey appear before the panel for the second time in two weeks, say den capture the money for the 2018 Appropriation Act, plus sey Accountant General of the Federation know about the loan.

View Details

na here you go hear everything wey you need know. hear di latest tori wey dey happen for awa country naija and obodo oyinbo.

View Details

Make una hear di latest tori wey dey happen for Nigeria and obodo oyinbo. News Sharp Sharp ontop correctfm

View Details

Minister of Finance, Budget and National Planning, Zainab Ahmed, say after the Federal Executive meeting on Wednesday, the committee on border closure wey President, Muhammadu Buhari, set up go soon submit its report.

She still assure Nigerians sey the borders go soon open.

For August 20, 2019, the government close land borders to stop smuggling and encourage local production dem still tell neighbouring countries sey make dem check smuggling from them side as part of the conditions before dem open borders.

View Details

Gunmen don kill two pipol for Maigiginya community of Igabi Local Government Area of Kaduna State.

The gunmen tiff foodstuff.

Kaduna State Commissioner Internal Security, Samuel Aruwan, confirm the killing. According to am, the gunmen wey attack the community been dey run from security agents wey spoil dem attack for the Kaduna-Abuna highway late Monday night.

View Details

Presidential Task Force on COVID-19 say nothing less than 39,070 passengers, wey enter the country no pay for coronavirus test.

Chairman of the PTF, Boss Mustapha, say some travellers carry fake documents on COVID-19 tests and other information,he say some of the pipol wey pay for post-arrival test no show up for the tests.

Mustapha, say PTF dey look the complain of Nigerians with the protocols for testing by in-bound and out-bound travellers.

View Details

Listen to everytin wey de happen for awa contry and obodo oyinbo. 

View Details

Lagos State Government don call on pipol for the state sey make dem change them attitude to waste management so dem fit check environmental pollution con protect the ecosystem.

Secretary to the State Government, Mrs. Folashade Jaji, yarn this one for the ceremony of seven-day serious cleaning of Waterways by Mental and Environmental Development Initiative (MEDIC), wey dey collabo with HRM Abisogun Foundation plus other partners

View Details

EndSARS protester, Peter Eromosele Adene, don face freedom after e spend 12 days for police  hand.

One of the lawyer wey support am for legal matter share video wey show as e free ontop Twitter.

Police for Lagos bin arrest am on November 7.

View Details

Fededral gomenent say Obianuju Catherine Udeh, wey people know as DJ Switch, go face exposure soon.

This one na unto her stand for the allege shooting of #EndSARS protesters by soldiers for the Lekki toll plaza on October 20, 2020.

Minister of Informate and Culture, Lai Mohammed, yarn dis one for meeting inside Abuja on Thursday.

View Details

Federal Government don yarn say na yellow fever dey responsible for all the recent strange deaths wey dey happen for inside some states plus Delta and Enugu.

Health Minister Dr. Osagie Ehanire yarn this one as him dey address State House Correspondents after online Federal Executive Council meeting wey dem do for inside Aso Rock Presidential Villa for Abuja yesterday.

The minister yarn say Government been dey investigate d disease, say dem collect samples and do research to take understand wetin happen.

View Details

President Muhammadu Buhari don give assurance say federal government go meet all the agreements with all the unions inside the education sector.

Oga Buhari yarn this one for inside d 2020 Convocation ceremony of university of Ibadan, as him dey show him concern untop the ASUU strike wey dey go on.

Him beg the lecturers to return back to their duty post.

View Details

National Bureau of Statistics (NBS) say the average price per litre wey people wey dey use kerosene pay for October go up to N352.93 in October from N347.98 wey im be for September.

Dem yarn dis one for statement wey dem call “National Household Kerosene Price Watch (October 2020)’’ wey dem get from dia website for Abuja on Tuesday.

The report show say the state wey get the highest average price per litre of kerodsene na Taraba wey dey buy am for N437.50.

View Details

Federal goment don show concern onto teachers wey no dey qualified for inside the country.

Dem say the 1.4million teachers for the system no dey enough for over 4.2 million pupils wey dey basic schools.

Federal goment still call state to take successful candidate wey follow for

Federal Teachers Scheme examination.

View Details

MOMAS Electricity Meters Manufacturing Company (MEMMCOL) don dey set to train over 300 youth wey no get work.

Dem won train the youth on meter installation to take match with the Presidential Mass Metering Initiative.

Chairman of MOMAS MOMAS Electricity Meters Manufacturing Company, Kola Balogun, tell news people say the movement get aim to develop work capacity of NIGERIA as part of their Corporate Social Responsibility (CSR).

View Details

Petroleum Products Marketing company wey be subsidiary of  Nigerian National Petroleum Corporation, don increase ex-depot price of petrol.....  Dem increase am to N155.17 per litre from N147.67 per litre. wey mean say, filing station go dey sell like 168-170/ltr

Dem yarn dis one for one internal memo wey Tijani Ajani sign. Dem yarn say the new price go start today wey beFriday.

View Details

Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) don announce 180 new COVID-19 cases for inside the country

This one na the latest development as dem say the total number of the sickness wey dey d country now na 64,516 and na 1,162 people don die from d sickness.

For the cases dem, Lagos get 74; Oyo, 41; FCT, 19; Kaduna, 19; Bauchi, 12; Ogun, seven; Rivers, four; Cross River and Edo get two each.

View Details

Minister of Labour and Employment, Senator Chris Ngige, on Wednesday say

ASUU no fit claim say dem dey independent when goment dey pay lecturers.

Oga Ngige say dem say freedom of lecturers… the one wey dem call “autonomy” go only dey wen the university dey get dia money by diasef and meet dia needs by diasef.

E yarn dis one wen im dey defend im ministry budget befoe senate Committee ontop Labour and Employment.

View Details

sheu sani tweet am say the former governor of Kaduna state Mr. Musa Balarbe don die after living for 84 years. Na one of the  governor wey den comot for office during im time.  

View Details

Federal goment yarn say Nigerians go follow as part of people wey go take part for COVID-19 vaccine when dem develop am for commercial quantity.

Na Minister for Health, Osagie Ehanire, yarn dis one for Abuja on Tuesday say anytime wey dem release vaccine as solution for the global COVID-19 pandemic, say Nigeria people no go miss out.

Oga Ehanire, yarn dis one for two-day conference ontop COVID-19, as e say  Federal Ministry of Health dey make arrangements to make sure Nigeria get the vaccine when e come out.

View Details

One activist wey im name na Kenechukwu Okeke, don file criminal complaint before one Chief Magistrate’s court in Abuja against 50 persons for their alleged roles for the #EndSARS protests wey shele last month. 

Okeke yarn say im follow loss im property for theendsars waka and people wey promote am go need face law. 

Part of the people wey dey im list na some Nigerian musicians, social media comedians among others. 

View Details

Senate president don warn the government say make den no ignore youth unemployment, say make den put youth employment and empowerment for the 2021 budget to avoid another protest for the country. 

View Details

ASUU don accuse di federal government say Federal Government no wan answer them so den go fit stop the strike wey dey happen for Nigerian Universities. 

View Details

Lagos State Attorney-General and Justice, Commissioner Moyosore Onigbanjo (SAN) don yarn the courts to sharpaly free 253 persons wey police arrest bcos of the #ENDSARS protest inside the state.

Oga Onigbanjo yarn say the Directorate of Public Prosecution (DPP) for inside d state  don chook eye put for d temprorary charges wey police file against dem and dem no see any evidence say dem commit any crime.

View Details

Nigeria Centre for disease Control. NCDC yarn on Thursday night say Nigeria don get 180 new COVID-19 cases and ma from inside 14 states. the total number of people wey get d sickness for naija now na 63,508.

But nobody don die from the sickness since d last 24 hours. So the number of people wey the sickness don kill go remain for 1,155.

This is according to the latest statistics provided by the Nigeria Centre for Disease Control, NCDC on Thursday night.

View Details

President Muhammadu Buhari enter close door meeting with traditional rulers  across the country.

Members of National Council of Traditional Rulers of Nigeria (NCTRN) wey  Sultan of Sokoto, Alhaji Abubakar Sa’ad lead, dey the meeting.

Dem do the meeting for council chambers of presidential villa, Abuja, and important kings for the country too attend.

View Details

Senate plus Federal Government disagree on the N5 billion bailout wey dem approve for airline operators and other businesses inside the aviation sector to reduce the impact of COVID-19 pandemic for dem operations.

Senate ask Federal Government to increase the bailout fund,dem say e too small, Federal Government say dem no fit go pass that amount, as dem get other challenges to deal with.

Chairman, Senate Committee on Aviation, Senator Smart Adeyemi, say e dey important for dem to review the bailout funds for airline operators, cos Wetin d government dey offer as bailout dey too small to make any meaningful impact.

View Details

Entrance examination into secondary schools for Kaduna State go happen on Nov. 7,and Primary schools go resume for a new session on Nov. 8, while secondary schools go resume on Nov. 9 after them been dey house cos of Covid-19 pandemic.

Commissioner for Education, Shehu Muhammad, say universities for the state go resumed on Monday plus sey Ministry of Education and the Schools Quality Assurance Authority go gather arrange the secondary schools’ entrance examination and candidates must carry dem passport photographs and birth certificates before dem write the examination.

View Details

Tori be say 94 post-graduate students wey dey under Niger Delta Development Commission foreign scholarship for inside United Kingdom go start another round of “we no go gree waka” today.

This one na unto say dem still dey owe school fees and the commission never pay as dem suppose do.

Meanwhile, presido of Niger Delta Students’ Union Government, Negba Goodness, say the waka na embarrassment to Nigeria.

View Details

The free distribution for electricity meter to houses start on monday for Kano, Kaduna, Lagos and Ikeja distribution company. dis distribution na fulfillment of di promise from President Muhammadu Buhari. 

View Details

President Muhamadu Buhari don talk say den go bring all the police officer to justice, and dose wey go loot and destroy public and private properties.

View Details

West African Examinations Council don yarn say results of 2020 Senior Secondary School Certificate Examination go come out next week.

The results bin suppose come out today bet the exam wey dem bin postpone because of  violence for the country affect some of waec office and some of dia operation for the country.

Ontop waec dia twitter handle, dem say dem go yarn the date soon .

View Details

ASUU talk say den never call of the strike because den dey wait for the federal government to conduct integrity test for university transparency and accountability solution, PTAS

View Details

Federal Government say dem hand over COVID-19 palliatives from the nation’s reserve and other sources to the state governments for onward distribution to the citizens.

Secretary to the Government of the Federation and Chairman, Presidential Task Force on COVID-19, Boss Mustapha, say them hijack #EndSARS protests to inflict great economic costs through destruction, looting of warehouses, plus to enter private homes, shopping malls, jail breaks.

View Details

kaduna state government don talk say den go find and arrest all di pipu wey go carry covid 19 food wey den keep to share for the state.

View Details

National Agency for Food and Drug Administration and Control (NAFDAC) on Sunday tell Kaduna State Government say after looters destroy dia office, dem commot with drugs wey don expire.

Dem yarn say any body wey use the medicine get risk of serious sickness and death.

Director-General of NAFDAC, Prof. Mojisola Adeyeye, wey alert Governor Nasir El-Rufai about the matter praise state goment say dem take better action  to safeguard the health of dia citizens.

View Details

den say hoodlums dey scatter the peaceful protest for Lagos intentionally so e no go dey successful. 

View Details

Federal government talk say den dey owe contractors wey dey build roads for Nigeria money.

View Details

Nigerian Army headquarters don deny say dem send soldiers to Lekki tollgate to shoot for were people dey protest.

The army for their social media post say report wey say soldiers dey the toll gate na fake news as dem yarn say no soldier dey the place.

Governor Babajide Sanwo-Olu of Lagos State bin announce 24-hour curfew for the state after violence wey bin happen for the state.

View Details

Senate on Tuesday ask President, Muhammadu Buhari to address the nation immediately;.

This one na unto the current nationwide protests by youths against police brutality and bad goment.

Dem still ask police say make dem give the #EndSARS protesters protection to prevent dem from hoodlums wey won con spoil dia genuine action.

View Details

Federal Government say Agbero don take over the protest, den beg the protesters make den end am bcos gbege don dey enter inside am

View Details

Edo State don set up 12 man judicial panel make den shook eye into the situation of the End SARS protest for the State. The secretary of the state give them 90 days to complete their assignment.

View Details

President of the Senate, Ahmed Lawan and the Speaker of the House of Representatives, Femi Gbajabiamila, don call #EndSARS protesters say make dem stop the nationwide protest.

Oga Lawan and Gbajabiamila yarn dis one on Sunday as dem dey follow State House correspondents yarn after meeting with President Muhammadu Buhari.

The Senate Presido describe the ongoing protests as  trying moment for the country and dia leadership.

View Details

Tori from US Government website be say dem don ban Nigeria say dem no go follow for the US visa lottery application for 2022

For the 19-page document wey dem publish for the website, Nigeria be the only African country wey dem ban from the visa lottery.

The Department of State dey determine people wey dem dey close through  random computer drawing.

View Details

Nigerian Bar Association plus civil rights groups don strongly condemn attacks on people wey dey protest against the Special Anti-Robbery Squad of the Nigeria Police.

Protests don dey most parts of the country since Wednesday last week by Nigerians, mostly youths, wey sey make dem cancel SARS, dem accuse police squad of corruption, high-handedness and harassment

View Details

Inspector-General of Police, Mohammed Adamu, don set up Special Weapons and Tactics Team wey go replace the Special Anti-Robbery Squad wey dem bin don disband.

View Details

Presidency on Tuesday don approved the five-point demand wey youth bring forward as dem bin don dey protest for the country.

Na Special adviser to oga preside ontop Media and Publicity, Femi Adesina, yarn dis one for one statement.

Part of wetin dey tok na say dem go release the protesters wey dem bin hold without any condition to am.

View Details

Pipu wey dey do the hashtag #Endsars waka continue dere waka for different state. Other state like PH join today.

View Details

President, Muhammadu Buhari on Monday, address the nation for the first time for the protest matter wey dey go round country.

The protest don go round country and na unto killing wey dey happen by men of SARS wey be Special Anti-Robbery Squad of the Nigeria Police Force.

View Details

The Federal Government don extend the suspension ontop new electricity tariff by one week.

Prof. James Momoh, wey be Chairmo, Nigeria Electricity Regulatory Commission (NERC) yarn this when the ad hoc Technical Committee ontop Electricity Tariff submit their interim report for meeting between Federal Government and Organised Labour on Monday for Abuja.

Dem bin suspend the new tariff two weeks and e end on midnight of oct 11.

View Details

Police Service commission don approve the dismissal of 10 senior officers con reduce the rank of 9 others. 

View Details

President Muhammadu Buhari say na only federal workers wey do capture for  Integrated Personnel Payroll Information System (IPPIS) platform go collect salaries.

Oga Buhari yarn dis one wen im present the 2021 budget of N13.08trillion to  joint session of the National Assembly for Abuja on Thursday.

Meanwhile, reports tok say Academic Staff Union of Universities (ASUU), wey dey ontop strike, say dem no go key into the Integrated Personnel Payroll Information System (IPPIS) wey goment dey ask of.

View Details

NLC don come out to say many workers no get the Covid-19 palliatives wey FG promise dem. den yarn say people misuse the money wey FG talk say make den give masses. 

View Details

Nigeria Economic Society (NES), yesterday, declare say the nation economy dey go bad because dem no add members of National Economic Management Team (NEMT).

Dia Presido wey be Professor Sarah Anyanwu, wey professors Peter Shibayan and Eyilola Olaniyi of Department of Economics, University of Abuja follow… yarn dis one for visit to the Senate Minority Leader, Enyinnaya Abaribe.

Dem say people wey dey handle the country economy get small or no experience and knowledge of the economy.

View Details

nigeria candidate for the position of the director general for the world trade organization Dr.Ngozi Okonjo Iweala don chop support from the European Union government as the race dey enter the final month. 

View Details

National President of ASUU, Prof Biodun Ogunyemi, say Federal Government no dey sincere for dem negotiations with the union, he say lecturers no fit resume on empty belle.

Ogunyemi say Accountant General of the Federation, Mr Ahmed Idris, dey violate directive of oga President, sey make dem pay lecturers’ salaries.

He say make Nigerians dey ready for long strike for universities cos of the way wey government take dey handle d negotiations.

Non-Academic Staff Union say the way wey Federal Government take dey handle Integrated Payroll and Personnel Information System no dey transparent, as den dey cheat many of dem members .

View Details

Troops of Operation “Thunder Strike” don kill two bandits and wounds some other people for Abuja/Kaduna highway.

Na Coordinator of Defence Media Operations, Maj.-Gen. John Enenche yarn dis one.

E yarn say the troop overpower the bandits with heavy fire wey cause two deaths and dem still collect some weapons from the bandits.

View Details

Inspector-General of Police, Mohammed Adamu, don ban personnel of Federal Special Anti-Robbery Squad the on ewey people dey call SARS say make dem no dey do routine patrols.

E still ban other squads of the force together with the once wey dm dey call …Special Tactical Squad, Intelligence Response Team, Anti-Cultism Squad say make dem no dey check people again.

This one dey for one statement by Force Public Relations Officer, Frank Mba, on Sunday.

View Details

Vice President Yemi Osinbajo, don call Nigerian youths say make dem no surrender to the challenges wey the nation dey face.

E say na Nigerian youth get the key to wetin go make the country more united, peaceful and prosperous nation.

Vice preside, Yemi Osibajo yarn dis one ontop online meeting of the NASFAT Global Youth Seminar wey dem call “a Unified, Peaceful and Prosperous Nigeria”.

View Details

As Nigeria dey mark dia 60 years anniversary, Kaduna state governor, Nasir, El-Rufai dey advoctae for new national agreement.

E say dis one na for the nation collective goals, ontop citizenship, rule of law, diversity, merit, governance, and how powers and responsibilities fit go round between states and federal goment for wellbeing of the country.

Oga El-Rufai tell Nigeria people say dem go need dey confident and hopeful say dem fit make the country dey alright again.

View Details

Hear di tin wey dey happen for inside awa dear kontri

View Details

Federal Goment don declare tomorrow wey be 1st of October as public holiday to mark the nation’s 60th Independence anniversary.

Na Interior Minister Rauf Aregbesola announce this one on behalf of federal goment for Abuja yesterday.

Oga Aregebsola say Nigeria be the leading black African country for the world and e no get doubt say Nigeria be pride of Africa and hope to Africa.

View Details

Central Bank of Nigeria say one commercial court for London don order the release of $200 million wey dem use as deposit for the case against Process & Industrial Development (P&ID) to the Nigerian government.

Central Bank Governor Godwin Emefiele confirm the news, he say the ruling dey come after the court see sey the case na primo facie fraud.

The court still reject P&ID’s application to increase them guarantee.

View Details

AS part of measures to address flood wey dey claim lives and property every year, tori be say Federal Government don perfect plan to establish establish flood control project along the banks of River for Kaduna.

The project go protect residents wey dey battle with flood as dem dey loose farmlands and property when heavy rain fall.

This one na as Kaduna State Goment raise alarm over threat of pollution to River Kaduna.

View Details

Lagos State Government don reduce transport fares for Lagos state ferries by 40 per cent.

Managing Director of Lagos Ferry Services, Hon. Abdoulbaq Ladi-Balogun, say the state government do this one to appreciate public cos dem embrace water transportation as alternative means to reduce road traffic, dem do this one to celebrate Nigeria 60th Independence from 30th September to 2nd October.

View Details

Bad government na n dey cause security challenges for the country - President CAN Dr.Olasupo Ayokunle.

View Details

INEC say dem don learn from Edo State governorship election say better election dey possible for Nigeria with cooperation of all stakeholders.

Chief Press Secretary to the INEC chairmo wey be Rotimi Oyekanmi, yarn dis one for one interview with news people.

Oga Oyekanmi still thanl Oba of Benin, security agencies, civil society organizations, media, National Peace Committee and development partners for the role wey dem play to the peaceful election for Edo state.

View Details

Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) say dem no record any death for 24 hours for Nigeria inside 24 hours.

Dem yarn dis one for the latest report wey dem give ontop dia twitter handle.

NCDC still yarn say dem record 125 new cases wey bring the total number to 57, 849.

View Details

Nigeria no dey build any rail wey go lead to niger republic, di idea na to buil the one wey go reach the border. Minister for Transportation - Rotimi Ameachi na n talk this one.

View Details

Federal Government don talk say den go celebrate Nigeria 60th Anniversary on a lowkey because of COVID-19 pandemic. here di full tori here

View Details

Justice Oluwatoyin Taiwo of the Lagos State Special Offences Court, don sentence one dismissed policeman, Ologunowa Ojo, to seven years’ for prison cos he kill one man Taiye Akande.

Ojo, wey be part of the Special Protection Unit, Oduduwa, Ikeja been dey guard one company on February 3, 2016, when he get argument with Akande around 7pm, con shoot am inside Shapati, for Ajah area of the state.

View Details

Federal High Court for Abuja rule sey President, Muhammadu Buhari (retd), follow to break the law when he send the names of 11 candidates wey National Judicial Council suggest for appointment as judges for High Court wey dey Federal Capital Territory to the Senate for screening and confirmation.

Justice Inyang Ekwo make the pronouncement for suit wey Abuja-based lawyer, Oladimeji Ekengba, file wey dey challenge the forwarding of the names of the 11 nominees by oga Buhari to the Senate he sey e breach section 256(2) of the Nigerian Constitution.

Oga Buhari without explanation  been pick 11 names from 33 wey dem recommend to am for April this year by NJC for appointment as FCT High Court judges.

View Details

Gov. Nasir El-Rufai of Kaduna state, say im administration don attract 25 new business wey worth over $500 million.

E yarn dis one for opening of the 5th Kaduna Investments Summit as e say the investment na both by local and foreign companies.

Governor Elrufai explain say the summit na one of the means wey goment dey use showcase and market Kaduna State to national and international audiences.

View Details

Nigeria Labour Congress NLC don promise to go ahead with the strike wey dem plan and protest from September 28.

Dem say dis one na as Federal Government fail to change electricity tariff and fuel price wey go up.

NLC Presido, Ayuba Wabba, say the action by organised labour go start from next week.

Oga Wabba still yarn say na 36 chiarmo of the 36 states plus FCT chapter of NLC make the decision.

View Details

hear di latest tori for correctfm

View Details

Presidential Task Force (PTF),on COVID-19, don warn sey pipol don dey abandon non-pharmaceutical protocols and other measures wey dem put to tackle the spread of the Coronavirus (COVID-19) pandemic for the country.

PTF chairman and Secretary to the Government of the Federation, Mr Boss Mustapha, say pipol don turn face masks to chin masks, plus sey social distancing and gatherings don return to the pre-COVID era.

Mustapha, say make pipol dey alert in order to prevent any danger of the second wave of the pandemic as countries for Europe dey face na.

View Details

Accident Investigation Bureau (AIB) say the Bell 206-B3 helicopter wey crash for Ikeja area of Lagos state on August 28, come down cos of to inadequate fuel for d tank.

According to 15-page report wey Accident Investigation Bureau (AIB) release,na that one dem first find plus sey the helicopter get valid certificate of airworthiness con get full-tank capacity on August 27 when dem do 20-minute test-flight.

AIB’s report still talk sey the helicopter no get fuel jettisoning capacity even though sey eyewitnesses talk sey the pilot release fuel from up, before the crash.

View Details

Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, don give assurance say the state go start programmes wey go make transportation easy for inside Lagos.

Im yarn dis one through in  Commissioner for Informate, Mr Gbenga Omotosho for one Traffic Radio.

Governor Babajide Sanwo-olu hail dem for the creativity and the one wey oyibo dedy call  innovation.

View Details

Anti-corruption Unit for Kaduna State Ministry of Justice don train heads of Ministries, Department and Agencies for the state ontop whistleblowing matter.

Tori be say this one na to make sure say dem dey accountable and dem sabi dia work well for better delivery inside public service.

The commissioner, still caution say Kaduna state goment whistle blower law still dey in place.

View Details

Here di full tori on wetin happen for inside di country ontop correctfm

View Details

Central Bank of Nigeria don announce N200 billion mortgage finance loan to Family Homes Fund (FHF).

The fund na to build 300,000 homes for the 36 states inside the country and  Federal Capital Territory.

Dem still dey expect say e go create up to 1.5 million jobs for five years.

View Details

Central Bank of Nigeria (CBN) don introduce one Solar Connection Intervention Facility.

Tori be say dis one na to match Federal government scheme wey get focus to expand energy access to 25 million people through provision of solar home systems.>>https://correct.fm/podcast/news-sharp-sharp-15th-serptember-2020/

View Details

Federal Government dey talk about di increment for nepa money and Fuel matter for di country.

View Details

Lagos State Governor, Mr Babajide Sanwo-Olu, and Minister of Transportation, Mr Rotimi Amaechi go visit the area of the accident wey involve train and two vehicles.

Sanwo-Olu sympathise with the families of the victims, He say the accident happen on the day wey the state government and Federal Government reach agreement to close down the shopping complex’s gates for the railway line because of safety concerns.

Two persons die for the Monday accident, wey happen along the driveway to Nigerian Army Shopping Arena inside Oshodi

View Details

Kano State Government don order the immediate reopening of six Technical Colleges for the state to allow students for final year class to join for the forthcoming  National Business and Technical Examinations Board (NABTEB) examinations.

Commissioner for Education, Malam Sanusi Kiru, say the order na follow-up to the approval wey Gov. Abdullahi Ganduje grant.

The commissioner say the state government don order the immediate payment of the NABTEB examinations fees for all SS3 students inside the technical schools.

He say dem keep N15.6 million for students’ feeding, while another N860,000   for the upkeep of the respective colleges.

View Details

Some bandits don kidnap 16 farmers, wey children and women dey among for Uduwa village, inside Chikun Local Government Area of Kaduna State.

Tori be say the people wey face the kidnap bin dey go farm wen gunmen attack dem for weekend.

Four of the people wey dem shoot wound n aim make dem no carry dem bet dem carry the 16 other people wey come from the same family.

Representative of African Student Union Parliament hail Dr Janet Ekpenyong as im dey present leadership award to am per say she be Director General of the Cross River State Primary Healthcare Development Agency.

Speaker African Student Union Parliament, Honourable Temple Oliseh, describe Dr Janet Ekpenyong as one of young and hardworking administrator for African.

This one na unto say e yarn say dem don see ideas wey she don introduce to  Cross River State Primary Healthcare Agency.

View Details

Manufacturers Association of Nigeria (MAN) don announce say dia members  donate N8 billion cash and N300 million palliative materials to both Federal and state Governments during the outbreak of COVID-19 pandemic.

View Details

Nigeria Police Force don arrest some people wey dey do “we no go gree “ waka for Lagos unto increase for petrol price and electricity tariff.

Dem arrest dem around Ojuelegba area of Lagos on Thursday.

Tori be say apart from the people wey dem arrest, dem sgtill carry materials of news people wey dey where e happen.

One of the people wey lead the group say na 18 person dem arrest and 4 news people dey inside.

View Details

Federal, state and local government never talk anything Two weeks after for the release of the students wey armed men carry when dem enter Prince Academy, wey dey Damba-Kasaya village inside Chikun Local Government Area of Kaduna State to kidnap seven students and 1 teacher.

News Report talk sey the mata happen around 8 a.m. when the students dey prepare for them junior secondary school examination‎. According to the report, the students na JSS3 students wey follow for the students for exit classes wey the government talk sey make dem resume for their Junior Secondary School examination.

View Details

Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) say Nigeria don record 296 new COVID-19 cases.

For the latest update, dem see the new cases dem for Lagos, Federal Capital Territory (FCT) and 13 other states of the country.

Na plateau get the highest for the list with 183 cases, Lagos come second with 33 infections while FCT get 25 new cases.

View Details

Federation Accounts Allocation Committee (FAAC) say dem share N3.879 trillion to both Federal, states, and local gomengt areas and other constitutional areas for the first half of 2020.

The breakdown showed that N1.53 trillion go to Federal Government, while states get N1.29 trillion and the 774 local government areas get N771.34 billion.

Na Director Communications and Advocacy of Nigeria Extractive Industries Transparency Initiative (NEITI) Dr. Orji Ogbonnaya Orji open dis one for one statement on Tuesday.

View Details

Ministry for Basic Education inside Anambra stat don approve gradual reopening of schools for the state, in line with the ministry’s approved timetable for the completion of the 2019/2020 academic session.

Permanent Secretary of the ministry, Mr Nwabueze Nwankwo, say   third term go dey short, plus dem dey expect schools to make maximum use of the time, plus the different e-platform teaching.

View Details

Lagos State Government don announce the reopening of two of dem recreational parks for public use, dem say visitors must obey the COVID-19 protocols.

Assistant Director, Public Affairs, Lagos State Parks and Gardens, Mrs Titilayo Ajirotutu, say the recreational facilities na Ndubisi Kanu Park for Alausa and Dr Abayomi Finnish Park for Oregun, Ikeja.

The state been close down all parks cos of Coronavirus pandemic to take reduce the community spread of the virus.

View Details

Muslim and Christian leaders for Kaduna State don call religions say make dem stop behaviour wey no dey well for dia faith and dem go need embrace peace instead.

The leaders of faith yarn for Ibrahim House, Kaduna, when Governor Nasir El-Rufai inaugurate House of Kaduna Family.

The houseof Kaduna family na platform wey dem design for leaders of faith to discuss and help people of faith to up way go promote peace and unity.

View Details

Lagos State Ministry of Education, through the Office of Education Quality Assurance say dem go train school owners, leaders for schools, school associations, school networks and educators for the State on the measures to reopen schools for COVID-19.

Director-General, Office of Education Quality Assurance, Mrs. Abiola Seriki-Ayeni say the plan na to prepare schools for safe reopening plus provision of templates and processes to know if d school don ready to reopen for the State.

View Details

LAGOS State Health Commissioner Prof. Akin Abayomi don announce say 1,696 COVID-19 patients never show for admission for the COVID-19 care centres.

Oga Abayomi, yarn dis one for im official Twitter handle on Tuesday.

Oga Abayomi still yarn say 3,803 of the confirmed cases wey Covid19 Lagos Response team dey monitor for communities don dey well or dem dey respond to treatments

View Details

Kano State Elder’s Forum don ask President Muhammadu Buhari say make e chook mouth and still stop Governor Abdullahi Ganduje move to borrow N300 billion from China.

Governor Ganduje won use am for light rail project for Kano State bet the Elders say e go make the state owe plenty money.

The forum don call other authorities too say make dem beg oga Ganduje to leave the loan matter.

View Details

Education Quality Assurance (OEQA) unit of the Lagos State Ministry of Education don warn the public sey make dem ignore the resumption time table wey dey fly around social media.

For inside the time-table the 2020/2021 academic calendar, first term of the session go start September 21, 2020 con end December 18, 2020 even tho sey Governor Babajide Sanwo-Olu talk for weekend sey  the resumption date wey he  announce never dey pure.

Public Affairs Officer, OEQA, Mr. Emmanuel Olaniran, say the calendar na fake coe e no come from dem office .

View Details

Newly appointed Akwa Ibom Commissioner of Police, Amiengheme Andrew, don resume duty for the State Police Command headquarters inside Uyo.

Na talk talk pesin for the command CSP Nnudam Frederick, na him yarn this one,Fredrick say the new commissioner took over as the 30th Commissioner of Police for the state plus sey the commissioner join  Nigeria Police Force as cadet Assistant Superintendent of Police (ASP) for 1988.

View Details

APC for inside Lagos don clear say dem never pick candidates for the Lagos East senatorial and Kosofe Constituency 2 House of Assembly by-elections.

The seat dey open after end of Senator Bayo Osinowo and Tunde Braimoh.

The primaries go happen for this Thursday and tori be say the election go happen on October 31.

View Details

2 pipu wey dey never identify don die this friday as helicopter go land on top one house for Ikeja, Lagos.

View Details

Federal Government don postpone the resumption date for international flight from 29th of August, 2020 to 5th September, 2020.

View Details

Nigerian Electricity Regulatory Commission say President, Muhammadu Buhari , don order operators for power sector sey make dem carry out mass metering to customers wey no get meter for the country.

NERC say dem no approve any increase for electricity tariffs.

The commission say oga President arrange the nationwide mass-metering programme so that Federal Government go fit stop estimate and expensive billing for electricity.

View Details

Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu don swear in new Governing Council for all tertiary institutions inside Lagos state.

The ceremony happen for Lagos House, Alausa, Ikeja on Tuesday.

The schools wey dey involve na Lagos State University (LASU), Ojo, Lagos State Polytechnic, Ikorodu, Adeniran Ogunsanya College of Education, Ijanikin and Michael Otedola College of Primary Education Epe.

View Details

Enugu State Police Command, carry one traditional ruler-elect of the Ogugu community in the Awgu Local Government Area Chief Emmanuel Ogbonna, go Enugu South Magistrates’ Court for perjury.

The police accuse Ogbonna sey he claim on oath sey he be onengineer when he no get certificate to back the claim.

police prosecutor, ASP Austin Aguodoh, say he no go oppose the bail application as long as d defendant go provide reasonable surety wey get verifiable address

View Details

Federal Government don approve the establishment of oil and gas logistics facility for Akwa Ibom State.

Na Minister of State for Petroleum Resources, Timipre Sylva say work go soon start for the site of the project.

Sylvia say the decision to establish the facility for Akwa Ibom dey strongly influenced by the prevailing peace and security of lives and property for the state.

View Details

Former Nigerian President, Goodluck Jonathan, go lead other West African leaders to coup-torn Mali on Saturday “to help the search for solutions”.

Mali’s president, Ibrahim Keita, comot on Tuesday by soliders, wey take him Prime Minister Boubou Cisse and other senior officials into custody.

View Details

President Muhammadu Buhari don call for strong sanction to the new military regime for Republic of Mali. 

View Details

Kano State Government don declare Thursday, August 20, 2020, as public holiday to mark the new Islamic year 1442, After Hijrah (AH).

View Details

PDP people don reject the slot wey den give them for the youth employment. Na 1000 people President Muhammadu Buhari been dey talk say go benefit from this opportunity. 

View Details

Today tori on wetin dey happen for awa country and obodo oyinbo.

View Details

Today tori on wetin dey happen for awa country and obodo oyinbo. 

View Details

Make Una enjoy all the tori wey dey happen for awa country Nigeria and Obodo Oyinbo. 

View Details

Fuel tanker drivers under the backing of Nigeria Union of Petroleum and Natural Gas Workers (NUPENG) don suspend them strike for Lagos State.

Independent National Electoral Commission (INEC) don announce sey dem go waka to Supreme Court to appeal the judgement of the Abuja Court of Appeal wey cancel the deregistration of 23 political parties. 

View Details

Make Una enjoy all the tori wey dey happen for awa country Nigeria and Obodo Oyinbo. 

View Details

Make Una enjoy all the tori wey dey happen for awa country Nigeria and Obodo Oyinbo. 

View Details

Listen to this episode of awa Correct Radio drama. Adventures of Akpors, the taxi driver (drama) whose daring moves sees him exploring opportunities in the bustling city of Lagos. Every week on CorrectFM Network.

View Details

Dis Life brings you a story that spans the whole week captivating listeners with music to go, and may take call as to how people feel about that story and how it should play out.

View Details

Adventures of Akpors, the taxi driver (drama) whose daring moves sees him exploring opportunities in the bustling city of Lagos. Every week on CorrectFM Network.

View Details

Make Una enjoy all the tori wey dey happen for awa country Nigeria and Obodo Oyinbo. 

View Details

Make Una enjoy all the tori wey dey happen for awa country Nigeria and Obodo Oyinbo. 

View Details

Make Una enjoy all the tori wey dey happen for awa country Nigeria and Obodo Oyinbo. 

View Details

Make Una enjoy all the tori wey dey happen for awa country Nigeria and Obodo Oyinbo. 

View Details

Make Una enjoy all the tori wey dey happen for awa country Nigeria and Obodo Oyinbo. 

View Details

make una enjoy awa news sharp sharp ontop correctfm. All the Tori wey dey happen for Nigeria and Obodo Oyinbo 

View Details

make una enjoy awa news sharp sharp. the tori wey dey happen for awa country Nigeria and obodo oyinbo

View Details

Make una enjoy the latest sport news ontop awa correctfm station. 

View Details

Make una catch all the tori wey happen for Nigeria and obodo oyinbo ontop our station CorrectFM. 

View Details

Make una catch all the tori wey happen for Nigeria and obodo oyinbo ontop our station CorrectFM. 

View Details

make una hear the latest tori wey dey happen for the awa coubtry Nigeria and Obodo Oyinbo. 

View Details

Catch the latest tori ontop awa correctfm today. Ogbonge news ontop the things wey dey happen during the corona period. 

View Details

Make you catch awa news sharp sharp on top Correct FM.

View Details

Shan George talk about her journey in life, how she start and where she dey today. Nollywood actress Shan George talk about how she take dey live her life as an actress

View Details

Enjoy all the things wey dey happen for the sport world on top Sport Correct today

View Details

For dis episode of Correct Woman, di torchlight na on top everything about Coronavirus and How coro coro as we call am dey affect di African Woman with Eva D Diva and Ona. 'CORRECT WOMAN' only on top CorrectFM as doctor join dem to talk di Covid19 mata well.

Let us know wetin you think. Drop comment and subscribe abeg. Well done!

View Details

Comedian and Instagram sensation Taooma spoke Eva, Correct Mama on 'Awa Visitor' Show

View Details

Many pipol dey trapped and some don die for one building wey fall for Ebute Metta area of Lagos State on Friday.

The building dey opposite Health Centre Ebute Metta along Cemetery Street.Tok tok person for Lagos State Emergency Management Agency, Nosa Okunbor, confirmed the mata plus sey dem dey work to comot pipol from the building.

Federal Government don officially launch the implementation of the second phase of the Partnership for Expanded Water Sanitation and Hygiene (PEWASH) programme to improve access to safe water supply and sanitation for 10 states.

The 10 states for the project na; Katsina, Plateau, Bauchi, Jigawa, Sokoto, Zamfara, Ondo, Osun, Imo and Delta.

Minister of Water Resources, Mr Suleiman Adamu, say e dey important for communities for the 10 states to take ownership of the programme to enable them benefit from the gains.

National

People’s Democratic Party(PDP) don demand for the resignation of President Muhammadu Buhari cos of the cases of corruption for federal agencies.

National chairman for the opposition party, Prince Uche Secondus, yarn this for media talk inside Abuja.

He talk the ongoing corruption investigations of the NDDC, MIC, NEDC, NSITF, EFCC and others, he say Nigeria, under Buhari’s watch, dey on ventilator dey fight to breath.

Secondus say corruption don become way of life for Nigerians while Buhari plays the ostrich.

National

Lawmakers for House of Reps want make President Muhammadu Buhari to call the management of the Nigeria Social Insurance Trust Fund (NSITF) wey dey suspension back to work.

The House make the resolution when dem read the report of dem committee wey investigate wetin them describe as the arbitrary breach of presidential directives by the minister of labour and employment, Senator Chris Ngige

AFRICA

data from the health ministry say authorities for Kenya never fit to trace 13,000 people wey come in contact with people wey later test positive for Covid-19,

for inside 14,168 cases wey dem record, dem never fit track about 10,433 people wey come in contact with them.

The capital, Nairobi, get the highest number of contacts wey dem gats trace followed by the coastal town of Mombasa.

Foreign

President Donald Trump don scrap plans for Republican National Convention celebration for Florida wey suppose draw more than 10,000 people to place where be pandemic hot spot to celebrate him renomination.

Trump been don already move the convention’s public events comot North Carolina because of virus concerns.

Sports

Former world heavyweight championMike Tyson, wey retire for 2005, say he go make comeback for age 54, fight Roy Jones Jr. on September 12 for Los Angeles.

For him Legends Only League website, Tyson announce the eight-round exhibition bout against Jones, wey be 51-year-old fighter wey been hold the heavyweight title con fight enter him 50s.

View Details

Sharp sharp news ontop correctfm. na here you go hear all the tori wey dey happen for awa country and obodo oyinbo for 24th July, 2020

View Details

"This is not a pipeline blast, it is a bomb blast" - as CorrectFM's Mayowa spoke to Abule Ado in Amuwo Odofin Blast survivors in this Special coverage by Correct FM.  Properties worth billions were lost in the pipeline explosion which occurred at the Abule-Ado area around Festac town in Amuwo Odofin Local Government area of Lagos State with Many people were feared dead and several collapsed buildings and Correct FM Mayowa was on ground to speak to witness, survivors and friends of the explosion - he tells Ona all about it.

Correct FM Presents the Abule Ado in Amuwo Odofin Blast Special Report.