AWR- Voice wen dey ginger Hope: Recent Episodes

Adventist World Radio

De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday

View Details

God plan say de man naim go bi pastor for hin house so make papa and mama train de boy pikin make e know God well well.Today message of Hope say bikos Jesus win devo, we too as God pikin don win sin and evry yama-yama wen devo dey do

View Details

Today lesin na say Kata-kata wen enta marrage na norma tin e no mean say de love for de marrage don finish.De message of Hope say de waka wen we dey forlow God waka bi like pipo wen dey run so make we run well so we go win prize.

View Details

De kain food wen pipo sorpose dey chop wen deir bodi go take balance and sikness no go enta naim bi today mataToday message of Hope say to be kristian mean say you dey forlow Jesus waka and you dey waka as Jesus waka.

View Details

De kain wok wen pikin go plan wen e go do for hin life we e big and watin e sorpose know bifor e go choose dat wok naim bi today mataToday message of Hope say God dey give evry pesin wen give Jesus in life new dress wen go make de pesin resembo Jesus

View Details

De wok wen God give man as e take make de man put am for dis world naim bi watin we dey put mout today.Today message of Hope say beta kristian na pesin wen go grow come resembo Jesus for evrytin wen e dey do

View Details

Today praya na for all hawa pikin dem wen dey rite exam, make God epp dem make dem pass beta passDe message of Hope say pesin wen wan bi beta kristian must give Jesus hin life and let de Holy Spirit bon am so e go bi new pesin

View Details

Hawa fess song na de hymn "Christ Arose" and de sekond song na "Celebrate Jesus" De message of Hope say make we dey praise bikos de get up wen Jesus get up naim bi hawa hope for new life for heaven

View Details

Make papa and mama train deir boy pikin make e know say na hi God take do kartaka so make e do well make God fit tell am weldon.De message of Hope say make we serve God like Mary wen come bi de fess pesin wen see Jesus wen Jesus get up from grave.

View Details

De tin dem wen husband and wife go fit do to take make trust enta deir marrage again naim bi today advise.Today message of Hope say make we bi like Mary wen forlow Jesus waka go de cross and hin grave, e no run commot like Jesus discipo dem.

View Details

De way wen pesin go take manage stress dat wahala wen fit carri odar sikness come your bodi naim bi today tork.Today message of Hope say make we bi like Mary wen save plenti mony take buy pafum tay rob Jesus bodi and Jesus praise am for watin e do

View Details

De tin dem wen hawa pikin dem go fit do to take get sef kontro for deir life naim bi today mata.Today message of Hope say as Jesus dey bring Lazarus wen don die come life na so e fit bring enitin wen don die for hawa life come back to life

View Details

Small small tin dem wen husband and wife go do togeda wen deir marrage go take go front and sweet naim bi today mata.De message of Hope say make we bi like Mary wen dey siddon dey put ear for de tin wen Jesus dey tork.

View Details

Today praya na make God for epp all family dem make marrage for no scatar and make God kiore man dem wen dey marray man.De message of Hope say Jesus no dey kondem sinna but e dey give dem sekond chance to change and forlow God.

View Details

Today fess song na praya say make Jesus hold hawa hand and de sekond song say make we no de fite but make we dey togeda.De message of Hope say make we get strong fait make we no let enitin commot hawa eye from God bikos God dey hawa side

View Details

Anoda kain work wen papa and mama go epp deir pikin learn na work wen dem dey take brain and sense take do.Today message of Hope say pesin wen bi beta kristian musto sabi tell odar pipo abat Jesus bikos dat na sometin wen God say make we do

View Details

De way wen husband and wife go take trust demsef and forgive itsh odar even wen one pesin make mistake forlow anoda man or woman.Today message of Hope say beta kristian na pesin wen give Jesus hin life and e dey go shursh with odar pipo wen bi God pikin

View Details

De way wen de wahala wen dey bring odar sikness come bodi take dey do small pikin dem and how papa and mama go take know naim bi today mata.Today message of Hope say beta kristian musto bi pesin wen dey pray as Jesus pray.

View Details

Pikin wen sabi kontro hinsef na pesin wen go fit commot hin hand from eni bad tin and hin life go bi beta life.Today message of Hope say as pipo wen don bon again we go dey forlow Jesus and de do watin Jesus say make we do bikos we bi disiapo

View Details

De tin wen husband and wife go do wen deir marrage go take stand gidigba and sweet naim bi today mata.Today message of Hope say as we don bon again we go de chop God word as de food for hawa spirit so dat we go grow come resembo Jesus.

View Details

Today praya na for God to torsh hawa life and de life of hawa leda dem make all of us dey fear God and do watin God want so kontree go beta.De message of Hope say eni pesin wen want bi kristian musto give Jesus hin life and bon again as Jesus tork.

View Details

Today fess song say make we no troway hawa fait for Jesus and de sekond song say e no go tay again, Jesus go come.De message of Hope say make we no bikos of enitin wen dey dis life troway hawa fait bikos we get crown for heaven wen God go give us.

View Details

E good make papa and mana tish deir boy pikin make e work with hin two hand bikos God give Adam work and work de make man bi beta man.Today message of Hope say even doh wahala go dey make we hold God strong so dat we no go miss heaven wen Jesus come.

View Details

De mata wen konsign as husband and wife go take trust demsef for deir marrage naim still bide mata for ground.Today message of Hope say God want hawa mind and devo sef want hawa mind so make we do watin God want make devo for no take hawa mind

View Details

De two kain levo wen dey de wahala wen dey carri odar sikness come hawa bodi if we no manage am well naim bi today mata.Today message of Hope say make we no let devo put yama-yama for hawa mind so dat we no go dey do yama-yama tins

View Details

Wen we bi pipo wen dey kontro hawa sef, we go fit do beta tin for life and go ton to beta pipo too.De message of Hope say make we bi pipo wen go dey praise God no mata watin we see for life bikos we know say na so so good tin God dey do for us.

View Details

Propati wen make get brekete no go give am happiness, man wen want happi musto put God fess for hin life.Today message of Hope say life fit no bi as we want but make we dey tank God bikos na God wen dey hawa side naim make devo neva kill us.

View Details

Today praya na make God epp all hawa pikin wen dey rite exam make dem pass beta pass wen dem go take go front.De message of Hope say for de lass day wen we dey now so, make we shine hawa eye make devo no desive us.

View Details

Today fess song say na Jesus bi de tiket wen we go take go heaven and de sekond song say evrybodi go happi for hinside heaven.De message of Hope say as we dey redi de wait Jesus, make we shine hawa eye make devo no take sin blind us we con miss heaven.

View Details

De tin de wen papa and mama go do wen dem go take train deir boy pikin make e fit bi beta man tomoro naim bi today tork.Today message of Hope say Jesus no go hide come but e go come as de big king wen e bi and evry eye go see am wen e come.

View Details

God give us pawa to take trust pipo and de mata dey hawa hand weda we go trust hawa husband or wife.Today message of Hope say even doh wayo abat how Jesus go take come go plenti, if we put God word for hawa mind, nobodi go fit desive us.

View Details

Watin pesin go see for bodi wen go show say wahala wen oyibo dey call stress don dey covaside hin life naim bi today mataToday message of Hope say evrybodi go hear say na only Jesus fit save dem bifor Jesus go come again.

View Details

De tin wen hawa pikin dem go do wen dem go take fit kontro demsef wen dem no go carri tork or fight naim bi today mata.Today message of Hope say bifor Jesus go come sin go brekete and pipo go dey swim for hinside sin like say God no dey again.

View Details

De sleep wen husband and wife dey sleep togeda na beta tin but e no go fit make man happi. Na Jesus for man life dey give am happinessToday message of Hope say bifor Jesus go come, war, sikness and onga go dey but make we put hawa life for Jesus hand

View Details

Today praya na for pipo wen sorpose don marray, make God for epp dem see beta pesin and moni to take marray.De message of Hope dey tell us see bifor Jesus go come, wayo go brekete and Jesus say make we no let enibodi desive us.

View Details

Today two song dey tell us say Jesus dey give piss for hinside kata-kata wen life dey give us.De message of Hope say wen Jesus dey hawa life, e no mata de wahala wen devo take stone us, we go win if we put hawa fait for Jesus.

View Details

Make we train hawa pikin dem make dem sabi open hand give pipo wen no get bikos as dem dey do dat one God go dey bless demToday message of Hope say, wahala dey come but make we no fear bikos wen Jesus dey hawa life, no wahala go fit kill us.

View Details

Stori wen papa and mama dey tell pikin wen dey make am no fit trust pipo and how we go take commot for dat wahala naim bi today mata.Today message of Hope say God no dey change and enitin wen God tork e go do am even if e tay so make we get fait.

View Details

De tin wen pipo go do wen de blood sikness wen no get cure no go take enta bodi naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen sometin de make us fear, make we pray like Jacob and make we pray ontil God ansa.

View Details

De special tin wen God put for hawa bodi and how we go take take-am work for God naim bi today mata.Today message of Hope say e no mata de bad tin wen we don do , if we come mit Jesus and beg am, e go forgive us and commot all hawa sin.

View Details

Today mata bi say moni no go fit make man happi for hin marrage but if e give Jesus hin life, God go give an happiness.De message of Hope say hinside hawa sin God dey see us and e get plan for hawa life if we go give am hawa life and do watin e tork.

View Details

Today praya na for hawa pipo wen dey farm, make God for bless deir farm and make melu and watar no scatar deir farm.De message of Hope say wen we come de place wen God dey, we go see hawa sin and we go pray make God commot hawa sin.

View Details

Hawa fess song say na only hinside Jesus we go fit get life and de sekond song say we bi new pipo bikos we don give Jesus hawa life.Today message of Hope dey tell us say God pikin dem na one family so make we dey do good for itsh odar.

View Details

Wen we train hawa girl pikin make e get fait for hinside God, dat girl go bi beta woman wen go fit build beta house.Today message of Hope dey tell us say make we resembo God as hin pikin and make we dey happi wen odar pipo join us for God family

View Details

Trust naim bi de rock wen husband and wife build deir house put wen no go let deir marrge scatar.Today message of Hope dey tell us say even wen we don waka commot for de place wen God put us, if we come back, God go forgive us and take us back.

View Details

De blood sikness wen papa and mama dey give deir pikin from deir own blood naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say na devo dey decive pipo commot from de place wen God say make dem dey.

View Details

Moni mata for kontree don dey let hawa pikin dem dey put hand for mani bad tin wen God no want make dem doToday message of Hope na abat de pikin wen korlet hin papa propati, commot for house go scatar am for anoda kontree.

View Details

Wife, pikin, moni and all de tin wen man de porchue no go fit give an happiness unless God dey in life.Today message of Hope dey tell us say as de woman happi wen e see hib moni wen loss na so God dey happi wen we give Jesus hawa life

View Details

Today praya na for hawa pipo wen want make God bless deir bizness, de pipo wen want work and hawa pastor dem.De message of Hope dey tell us say we bi like de sheep wen loss for de parabo and Jesus die to take save we.

View Details

Today fess song say God no go let you fall and de sekond song say Jesus naim bi de place wen we dey hid wen wahala come.De message of Hope say God de gidigba and e dey hear wen we pray so make we dey pray and pray like Elijah ontil God ansa.

View Details

Make we train hawa pikin dem to bi pipo wen go sabi love pipo as Jesus Christ love us.Today message of Hope dey tell us say evrytin wen start get end and no mata how mata bad now e go get end.

View Details

Love get hin own language and husband and wife sorpose know deir love language and dey speak de language togeda.Today message of Hope dey tell us say de pesin wen we marrage go fit make us beta pipo or bad pipo for God eye.

View Details

Watin pesin go do wen e go take maintain hin bodi as hin bodi sorpose bi naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say make we put God fess for hawa life and make we no forlow God waka as devo pipo dey forlow devo waka.

View Details

God want make we bi de friend of even pipo wen dey do us wicked just like God wen dey let hin sun shine for good and bad pipo.Today message of Hope dey tell is say wen hawa life get wahala make we go mit God and beg am make e repair hawa life

View Details

Man wen want make hin family go front go know how to waka hin own road and no dey let watin odar pipo dey do or watin dem bi worri am.Today message of Hope dey tell us say make we no let fear dey hawa life but make we trust God and forlow am waka.

View Details

Today praya na for hawa old pipo make God give dem long life and bless dem and make God make Nigeria beta.De message of Hope dey tell us say Elijah know say God neva die but God dey gidigba and we too sorpose know say God dey.

View Details

Today fess song say we put hawa trust for God name and de sekond song say God dey ansa praya.De message of Hope tell us say wen e get as e bi make we pray ontil God ansa like as God ansa Elijah wen e pray for de wido pikin wen die.

View Details

Eni woman wen wan bi beta woman musto get pachense for hin life bikos na pachense naim pesin dey take win for life.De message of Hope dey tell us say God no dey change hin word so make we believe God word for hawa life.

View Details

De four pillar wen dey make love fit stand gidigba naim bi today mata.Today message of Hope say wen God send pesin message, de pesin no sorpose fear bikos God go waka for hin front as e dey go de message.

View Details

Watin dey make pikin get kobo leg and watin we fit do put for de mata naim bi today mata.De message of Hope dey tell us say even wen we do watin God tork, devo go still fit put wahala for hawa life but make we trust God.

View Details

De tin dem wen we go know and do wen go make us fit selet beta friend naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say one tin wen go make us fit see God pawa for hawa life na wen we dey do watin God tell us to do.

View Details

Wen husband find new and beta way wen e go take manage hin family and de plan wen dem get, e go make deir plan work well.Today message of Hope tell us say wen we dey do watin God tork, we go see God pawa for hawa life like Elijah.

View Details

Today praya na for hawa pipo wen send praya rekwest make God for epp dem find deir pikin wen dey loss and make who sik well.De message of Hope dey tell us say one big lesin wen dey Elijah life bi say e do watin God tell am to do.

View Details

Hawa fess son na praya make God ansa hawa praya and de sekond song say we bi winna for hinside Jesus.Today message of Hope say as kristian, we bi like pipo wen dey run so make we run well so dat we go fit win heaven.

View Details

Some small-small train wen we go train pikin as e go take selet pipo wen e go take do friend and respet hin senior naim bi today mata.De message of Hope dey tell us say beta kristian na pesin wen go dey do good like de good samaritan for bybbo.

View Details

Wen pipo don marray tay e dey bi like say dem no know weda love still dey de marrage as e dey wen de marrage stat.Today message of Hope dey tell us say make we no fear but make we dey pray with strong mind bikos God go ansa wen we pray.

View Details

De tin wen dey make some pipo dey faint and watin we fit do wen pesin faint naim bi today mata.Today message of Hope say make we dey use God word take dey do hawa praya.

View Details

Jesus don tell us say eni word wen we tork wen no bi beta word, we go tell am how and why we tork dat word wen e come.De message of Hope say make we no fear bikos Jesus say hin go dey with us until e come carri us go heaven

View Details

Wen husband learn how to hold bodi and kontro how e dey buy-buy, e go fit manage moni take do watin e sorpose do for family.Today message of Hope say hawa world go dey bad mor-mor bifor Jesus go come but make we put hawa hat for God and forlow am

View Details

Today praya na say make God let de good hat wen e give us bi watin go let us fit hear and do watin God tork.De message of Hope say make we no bi pipo wen dey konplain as life dey hard dey go but make we dey pray and tell God hawa mind.

View Details

Today fess song say God no go let us suffa and de sekond song na God go do watin e plan for hin time. Today message of Hope say make we get fait bikos God get pawa to take wake watin don die for hawa life like e wake Lazarus.

View Details

Make papa and mama let deir girl pikin go skool so dat dem go bi beta pipo for hinside family and kontree.Today message of Hope say Jesus na God bread wen come from heaven and as we do watin Jesus tork hawa life go beta.

View Details

Jesus tell us say na we bi de salt for dis world so make we dey do watin go make hawa life bi like salt for hawa family.Today message of Hope say wen we dey do watin Jesus tork, we go get plenti mirako for hawa life.

View Details

All de tin dem wen we sorpose do so dat we no go get wahala wen no go let us fit shit naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say Luke show us Jesus wen get sorri mind for pipo and wen sabi commot us for hawa wahala.

View Details

De lesin today na say make we know say de word wen dey commot for hawa mout get pawa so make we no dey tork enihow.Today message of Hope say Matthew naim Jesus for tish us watin we sorpose dey do and wen do watin Jesus tork, we go get miracol.

View Details

Wen husband and wife put deir mind, deir money and deir plan togeda, den dem go see beta tin for deir family.Today message of Hope dey tell us say for de gospel wen Mark rite, we go see Jesus dey pray and na so God want make we dey pray too.

View Details

Today praya na for God to commot de tin dem wen no dey let us fit hear and do watin God tork from hawa life.De message of Hope dey tell us de tin dem wen Jesus do and how we go see am for hinside de Gospel.

View Details

Today fess song say make we trust God and de sekond song say make we do watin God say make we do.De message of Hope dey tell us say make we dey pray make we know watin God want and make we do watin God want.

View Details

Odar aria like how to wash clot, klin house, cook food wen we sorpose tish hawa girl pikin naim bi today mata.De message of Hope dey tell us say God get two kindom and na only de pipo wen dey de grace kindom go fit enta de glory kindom

View Details

Pipo wen dey lie nobodi go belive dem and who dey raise shoda no go fit forlow odar pipo waka naim make is tin bi hawa enimi.Today message of Hope dey tell us say make we dey praise god name for hawa praya and make hawa life make pipo praise God.

View Details

De tin dem wen no dey let pesin fit shit as e sorpose shit and how we go take manage dis mata naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen ebi like say God no dey hear hawa praya, make we no fear, make we get strong fait.

View Details

De tin wen pipo do dey come back come mit dem so make hawa pikin dem dey choose beta tin to do like Joseph for Bybbo.Today message of Hope dey tell us say make hawa praya no get plenti grama but make we tell God de tin wen we want.

View Details

De tin wen family go do wen dem go take fit do deir tin togeda so dat family go dey go front.Today message of Hope dey tell us how we go take pray hawa praya wen God go take hear.

View Details

Today praya na make God commot de tin dem wen dey block hin word wen no dey let am enta and grow for hawa hat.De message of Hope dey tell us say wen we dey hinside Jesus and dey do watin God want, we go bi like Jesus.

View Details

Today fess song say we go fit pray for eni-wyer weda na warta-side and de sekond song say make we knee-down as we dey pray.De message of Hope dey tell us say make we sabi tell God tank you bikos pesin wen tank God dey get yanfu-yanfu blessing

View Details

Pipo wen get hate for deir hat and wen no sabi forgive pipo wen do dem bad tin, no go fit get beta life bikos God no go bless dem.Today message of Hope dey tell us say make we dey pray onti God ansa and we get watin we dey find.

View Details

De tin wen dey make some pipo no fit shit as dem sorpose shit and watin dey korse am naim bi today tork.Today message of Hope dey tell us say pawa dey praya and if we go gree pray God go ansa and e go show hin pawa for hawa mata.

View Details

Enitin wen you do for dis life go come back come mit you so make you know watin you dey do.Today message of Hope say wahala dey but make we no let enitin stop hawa praya.

View Details

De tin wen husband go do wen e go take show say e get respet for hin wife and wen go make family kolee naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say make we pray hawa praya as Jesus show us for Bybbo so dat God go ansa hawa praya.

View Details

Today praya na make God put pawa for hin word so dat de Word go dey change pipo life.De message of Hope dey tell us say we pray, God go hear and na only praya we get wen we dey take forlow God tork.

View Details

Today fess song say God dey take hin take heal us and de sekond song say God Word na wondaful word wen dey give life.De message of Hope tell us say God Word na de sord wen we dey take fite de devo.

View Details

Make mama dem baff deir pikin well and tish deir girl pikin to know how to baff well so dat dem no go get bodi wen dey smell.Today message of Hope tell us say God word dey epp us see as we go waka wen we no go take enta sin.

View Details

Wen pesin no fit believe, wen pesin dey fear and e get doubt, dat pesin no go fit do watin e sorpose do wen go make hin life beta.Today message of Hope tell us say de Bybbo naim go fit make hawa life beta as we dey do watin God tork for hinside.

View Details

De two type of pipo wen no fit get belle and watin we wen know dem go do to take epp dem naim bi today mata.Today message of Hope say God word na abat Jesus Christ and how e dey take save we so dat we no go die trowey but we go get life and bi God pikin.

View Details

Today we learn say enitin wen pesin do for dis life go come back come mit am so make hawa pikin dem mind watin dem dey doDe message of Hope say God dey use hin word take change hawa life so dat we no go waka de waka wen we no go take go heaven.

View Details

De way wen husband and wife go take waka and do tins togeda for de marrage naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say na God naim tork all de tins wen dey de Bybbo and na only God sef selet de pipo wen rite de Bybbo

View Details

Today praya na for all de pipo wen get hand for moni mata for de kontree make God give dem sense and make we stop to dey boro-boro.De message of Hope say de Bybbo na God word and na only as we know watin God tork and dey do am naim hawa life go beta.

View Details

Today fess song na "Abide in Me" wen mean say make we stay hinside Jesus Christ and de sekond song na "De Fada's Will"De message of Hope dey tell us say God get plan for hawa life and God know how e go take make hin plan work for hawa life

View Details

Make papa and mama tish deir girl pikin to dey respet pipo wen senior am and even pipo wen hin senior.Today message of Hope say wen we dey hinside de Jesus grace kindom and we waka as e say make we waka den we go enta de glory kindom wen Jesus come again

View Details

Pesin wen sabi vex, wen dey jeloss and wen sabi carri sholda go up na pesin wen no go fit bi de pesin wen God want make e bi.Today message of Hope say wen we day hinside Jesus Christ den hawa lite go shine and people go see Jesus and come forlow am.

View Details

De tin wen dey make some man no fit give deir wife belle naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen God no kwik ansa hawa praya, make we wait bicos God go always ansa hawa praya.

View Details

De tin wen make smoke wen pipo dey smoke bad and how smoke dey take scata pesin bodi naim bi today mata.Today message of Hope tell us say if we go tru-tru stay hinside Jesus, we go commot hawa hand from sin so dat God go hear hawa praya

View Details

Husband wen know say hin don tru-tru marrage and e dey do all de tin wen God say make husband do naim bi man wen get committment.Today message of Hope dey tell us say wen we pray as Jesus say make we pray dat one go mean say we dey hinside Jesus Christ.

View Details

Today praya na for de govanor and all de pipo wen dey for sout-west make God for make deir side for hawa kontree beta.De message of Hope dey tell us say God want make we stay hinside Jesus as branch dey hinside tree.

View Details

Today two song dey tell us say Jesus richousness, we sometin wen God take sash us and naim go make us fit go Heaven.De message of Hope tell us say e no get enitin wen we go do wen we go take beta for God eye except we get Jesus richousness.

View Details

De kain train wen papa and mama go train deir girl pikin naim go make dat girl pikin bi beta woman tomoro.Today message of Hope say as we dey read God word, pray and tell odar pipo abat Jesus, na so we do take get pawa dey forlow God

View Details

Two enimi wen fit no make pesin life good and wen fit spoil marrage naim bi today mata.De message of Hope say de kain life wen Jesus show we as human being naim we sef go get wen we give am hawa life and dey forlow am waka.

View Details

De sikness wen no dey let husband and wife fit bon pikin for deir marrage naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say Jesus take human being make e for fit die for we and save me and you.

View Details

De kain tin wen dey happun wen fit make dis mata wen oyibo dey call sexual abuse happun naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say Jesus naim bi de God wen come die for we so dat e go commot us from sin.

View Details

As we dey try setto wahala for de marrage make we do all de tin wen we dey do with respet and make we know how to tork.Today message of Hope dey tell us say na only Jesus wen save us naim fit give us de richousness wen we go take forlow God waka.

View Details

Today praya na for God to come put brake for all de wahala wen Boko haram and deir pipo dey do for hawa kontree.De message of Hope dey tell us say na God dey give us hin richousness but we musto kip de richousness as we dey do beta tin.

View Details

Today fess song say we go fit do evritin bikos God give us pawa and de sekond song say na hinside God we dey hide wen wahala deyDe message of Hope dey tell us say wen God dey hawa side and we no get sin for hawa life den bad tin no fit do us.

View Details

Woman wen dey lie give anoda woman wen fit make de odar woman commot for hin husband house no bi beta pesin.De message of Hope dey tell us say Jesus don show us exampo as we go take forlow God waka wen we go take fit do watin God tork

View Details

De tin dem wen man wen get man kansa go fit do to take manage hin bodi naim doktor tork today.Today message of Hope dey tell us say God no dey forget hin pipo and wen we know say God get us for mind, we go fit do watin e want make we do.

View Details

De tin dem wen hawa pikin dem dey do wen don bi like god for deir life wen if dem no do am deir bodi no dey well naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen we know say God dey hawa side we no go fear to do watin e say make we do.

View Details

Wife dem want make deir husband sabi manage moni and make dem take all deir mind and bodi take dey hinside de marrage.Today message dey tell us say bikos we get God and God na tork-na-do, e no dey fail we sef go fit do watin God say make we do.

View Details

Today praya na make God make sik pipo well and make woman dem wen get belle bon well, make mama dey and make pikin dey.De message of Hope say wen hawa life dey God hand and we trust God, e go give us pawa take do watin e want make we do.

View Details

Today two song dey tell us say God go fit make road wen e bi like say we no get road to pass bicos God get [awa to do eni tin.De message of Hope dey tell us say God no dey forget hin pipo, de wahala fit tay but God go rememba as e rememba Rachael

View Details

Today lesin for hawa stori bi say make we as woman no dey tork or do eni tin wen go fit scatar anoda woman marrage.De message of Hope dey tell us say Jesus and all hin disiapo go shursh for sabat and we too sorpose go shursh for sabat.

View Details

Husband wen bi beta head na ma wen get beta karacta wen make am get good name wen bi blessing for hin wife and pikin dem.Today message of Hope tell us say God naim give we de sabat and since de world start naim God pipo don dey kip de sabat as God tork.

View Details

De tin wen man go see for hin bodi wen e go take know say e get prostrate kansa.Today message of Hope dey tell us say God no forget de Sabbath and e no want make we too forget de Sabbath.

View Details

Make hawa pikin den no let pipo make dem dey do bad tin but make dem strong and do watin good for deir life.Today message of Hope dey tell us safe as Israel tay for Egypt, God no forget dem, e still come save dem wen de time reach.

View Details

Tiree tins wen wife dem want make deir husband do for dem naim bi today tork.De message of Hope dey tell us say God rememba Joseph for all de suffa wen e suffa and God come do watin e promise Joseph.

View Details

Today praya na for hawa family dem, make God kip husband and wife togeda and makepikin dem enta skool.De message of Hope dey tell us say God no dey forget hin pipo and God rememba Noah commot from the boat afta watar don dry from de ground.

View Details

Today fess song na "I die to mysef" and de sekond song na "To live is Christ".De message of Hope say wen we tin say e get watin we dey do by hawasef wen we go take richus for God eye naim bi say we don fail.

View Details

Make woman dem get sense make dem no dey bikos of eni man dey fite demsef again bikos dat no bi beta tin.Today message of Hope say Sunday shursh wen pipo dey go today na watin pipo wen de Sun bi deir god dey do.

View Details

Today tork na say make hawa husband bi bood exampo for hawa pikin dem and make dem protek de family.De message of Hope dey tell us say God no want make we take eno odar tin take do God for hawa life.

View Details

Na man dey get de kansa wen doktor put mout today and eni man wen don reach 40 years sorpose dey do test make dis dis kansa no enta hin bodi.Today message of Hope say pipo wen take de sun wen God make take do deir god naim pipo wen God dey forbid.

View Details

De tin wen enta pesin ear dey from de ear enta hin hat so make hawa pikin dem mind de kain song wen dey enta deir ear.Today message of Hope say na de 144,000 pipo wen stand for God for hinside deir wahala naim pipo go come know say devo na bad devo.

View Details

Life bad now so make man no dey kip sekret for eni tin wen e dey do so dat his family go fit know if sometin wen bad happun to am.Today message of Hope dey tell us say de 144,000 pipo so go get beta blessing for heaven and nobodi go fit sing deir song.

View Details

Today praya na for hawa old pipo dem and pipo wen don ritaya so dat God go make govment pay dem deir penshion De message of Hope dey tell us say na de 144,000 pipo naim go fit stand as kristian for de wahala wen go dey bifor Jesus go come.

View Details

Today two song na de old hymn, "I have decided" and de sekond one na "Give me de Bybbo"De message of Hope say as we don give Jesus hawa life make we read hawa Bybbo bikos na God word bi de food wen we go take grow.

View Details

Make we as woman no dey get long troat dey go marray man wen don get wife for house bikos one man with plenti wife no bi God plan.Today message of Hope dey tell us say as we don give Jesus hawa life, we musto dey rememba say we bi God pikin.

View Details

Husband wen get plan for hin family and wen dey bring moni wen de family go take manage na man wen know say hin bi de head of hin family.De message of Hope say wen we dey do beta tin wen go make pipo know say we bi God pikin, we go bi beta kristian.

View Details

De tin wen pesin fit do wen kansa no go enta bodi and watin pesin wen get am fit do naim bi watin doktor tork today.Today message of Hope say kristian wen wan stand gidigba as God pikin musto forlow odar kristian go shursh and serve God

View Details

Make we tish hawa pikin dem make dem no dey take de kolor of pesin bodi take korse dem bikos dat kain korse dey make pipo go blishToday message of Hope dey tell us say make we dey praise god with beta song bikos praise dey epp us bi beta pipo for God eye

View Details

Make we tish hawa pikin dem make dem no dey take de kolor of pesin bodi take korse dem bikos dat kain korse dey make pipo go blishToday message of Hope dey tell us say make we dey praise god with beta song bikos praise dey epp us bi beta pipo for God eye

View Details

De tin dem wen we fit do make we for fit kip hawasef safe for hinside today bad world naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say if we tru-tru wan bi beta kristian, praya must dey hawa life bikos praya get pawa.

View Details

Today praya na praya for de pipo wen dey Borno state make God epp dem bikos of de warta wen don cova de state.De message of Hope dey tell us say e get five tin wen we musto do if we tru-tru wan forlow Jesus waka de waka wen we go take go heaven.

View Details

Today fess song say e no go tay now Jesus go come and de sekond song na song abat de place wen Jesus don go make for we.De message of Hope dey tell us say God pipo wen go get hin mark and wen no go dey enta sin naim Jesus go take go heaven.

View Details

De lesin wen woman dem fit learn wen deir old papa husband begin carri small small girl naim bi today mata.Today message of Hope say God pipo wen go go heaven na pipo wen go get Jesus kain karacta and dem go dey do watin God want.

View Details

Man wen bi hin wife head na man wen go join bodi with hin wife de pray and do odar tin togeda with hin wife.Today message of Hope dey tell us say bifor Jesus go come hin pipo go bi pipo wen no go dey swim for hinside sin.

View Details

De kain tin wen woman wen get dis woman kansa go see wen e go take know say de kansa don enta hin bodi.Today message of Hope say de pipo wen go enta heaven go bi pipo wen forlow God waka like Enoch and God go put hin mark for deir bodi.

View Details

Watin korse dey do for pikin bodi wen odar pikin korse am naim bi today tork.De message of Hope say as we don see say de tin wen Jesus say go happun bifor hin come again don nearly happun finish, make we dey redi hawa sef.

View Details

Watin husband dem go do wen wahala no go take enta compound come mit deir family naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us how queen Esta and God pipo pray wen dem get wahala wen God take save dem..

View Details

Today praya na for hawa family dem make God for epp us with moni mata and make e make hawa sik pipo well.De message of Hope dey tell us say God love us wel-wel and for dis time wen we dey now make we forlow God waka make we no for miss heaven.

View Details

Today two song na song wen dey enkorrage us make we pray for evry kondishion wen we dey.De message of Hope dey tell us say make we trust God even wen we see watin make us dey fear and make we know say God go do watin e say e go do.

View Details

Story wen we go take know say make we no do odar pipo watin we no want make dem do we bikos we get pawa pass dem.Today message of Hope dey tell us say wen pipo wen get pawa pass us dey find hawa trobo make we cari de mata give God and e go fite for we.

View Details

De tin dem wen man go do as husband and head for hin family naim bi hawa tork today.Today message of Hope dey tell us say God go ansa de praya wen we pray so dat pipo wen commot for God family go come back.

View Details

De kansa wen dey do woman dem for de road wen dey go de belle wen dem dey take carray pikin naim bi watin doktor put mout today.Today message of Hope tell us say wen we do watin make God happi, God sef go do watin big pass watin we ask am.

View Details

Watin bad for de korse wen pikin dem dey korse ish odar wen fit make some pikin go kill demsef naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen wahala wen big pass we come mit us make we pray like Samuel pray and God go fite for we.

View Details

De tin wen husband and papa for family go do wen hin family go take safe naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen e bi like say watin we dey find no dey come, make we pray like Hannah pray and God go ansa.

View Details

We pray today make God epp us fite all de kidnapa and bandit dem wen dey kill pipo for hawa kontree.Today message of Hope dey tell us say wen life no bi as e sorpose bi, make we pray as Moses pray and God go ansa us.

View Details

Today fess song dey tell us say God na gidigba God wen notin dey shake and de sekond song say na God get dis world so no yawa.De message of Hope say God put time for evrytin wen e do plus as we dey take serve am and make we sef do as Jesus do.

View Details

De kain pipo wen dey jelors and watin pesin fit do to take commot jelorsy naim bi today tork.Today message of Hope dey tell us say want make we bi kartaka wen know hin word and watin e want and we dey do am as e want am.

View Details

Wen husband and wife dey play, laff, chop and sleep togeda and den pray and forgive ish odar, deir marrage go sweet.Today message of Hope say God kartaka, na pipo wen go show Jesus for deir life and dat one go happun wen dem do watin God want

View Details

De kain tin dem wen we sorpose do make we for no get de kansa wen dey dey bress naim doktor tell us today.Today message of Hope dey tell us say as pipo wen God don take do hin kartaka, we sorpose bi pipo wen dey fear God and worship am.

View Details

De kain way wen God want make we dey dress so dat pipo go see Jesus for hawa life naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen we know say na God naim get us we sorpose dey trust God with hawa life and waka as e want make we waka.

View Details

Wen we do tins for family wen dey make pipo dey cry, dem no go happi and dem go tink say de family no want dem dat na abuse.Today message of Hope say God wen get us and wen put us for here naim sef go give us beta life and make us happi for here.

View Details

Today praya na for de pipo wen dey sik make God torsh dem make dem well and make family get peace and moni so dem no go dey buy kredit.De message of Hope dey tell us say na God get all of us and we bi God kartaka as we dey dis world.

View Details

Today two song na abat God Grace and na God Grace bi de beta korret life wen we get for hinside Jesus.De message of Hope dey tell us say as we give Jesus hawa life, we don bi God pikin and de Holy Spirit dey hawa life.

View Details

Watin Jelorsy bi, why pipo dey do jelorsy and how we go take know if we dey jelorse naim bi hawa tork today.Today message of Hope dey tell us how we sorpose de waka as God pikin wen get Jesus life and hin light for hin life.

View Details

De kain kain tin dem wen husband and wife go dey do wen deir marrage go take sweet naim bi today mata.Today message of Hope say we go baptise afta we give Jesus hawa life so dat de Holy Spirit go epp us waka as God want.

View Details

De kain tin dem we go do wen we no go take get kansa and watin we fit do if we don get am naim bi today tork.Today message of Hope say wen we give Jesus hawa life and dey do watin e tork na so we go take get de beta korret life wen no dey end

View Details

Watin respet bi, how and why God want make we dey respet pipo naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say na only hinside Jesus Christ we go fit get de beta korret life wen no dey end.

View Details

Abuse na abat how pesin go dey do watin hin no go like for anoda pesin and na bad tin for family.Today message of Hope say bikos all of us die for hinside sin, we musto give Jesus hawa life so dat we go fit get de beta korret life.

View Details

Today praya konsign moni wen family go take pay skool fees as new skool year dey start plus make God make techa dem bi beta pipo.De message of Hope dey tell us say beta life no bi plenti moni and propati wen you get but na de life wen Jesus dey give pipo

View Details

Today two song na abat God word, de fess one na "Give me de Bybbo" and de sekond song na "Ancient Words"De message of Hope dey tell us say God want make we do all de tin wen e tell us for de ten kormandment.

View Details

Wen we respet hawa husband even wen e no get moni to do watin husband sorpose do dat one go make hawa husband beta husband.Today message of Hope dey tell us say na God law wen bi de 10 commandment naim bi watin God go take jorge pipo.

View Details

De odar small small advise wen husband go take korret hin wife wen e no go get wahala for hin marrage.Today message of Hope dey tell us say wen we fear God and we commot hawa hand from sin, God go rite hawa name for hin book.

View Details

De kain tin wen pesin go see for hin bress wen e go take know say e get bress kansa naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say God get book for heaven wen e dey rite watin we dey do put and na de book e go take jorge we.

View Details

De way wen hawa pikin dem go take manage deir mind so dat deir mind no go come bi devo workshop.Today message of Hope dey tell us say God jorgement wen dey come so no get sekret oh, na open mata for God eye.

View Details

Anoda tin wen go epp papa and mama train deir pikin well na make dem dey take strong hand and mind take dey train deir pikin.Today message of Hope dey tell us say God judgement dey front dey come and e no get enitin wen we go do take dodge am.

View Details

Today praya na make God epp us setto de wahala wen dey dis gorment, de petro wahala with Dangote and worka dem salary mata.De message of Hope dey tell us say God don start to dey jorge dis world and e no go tay no Jesus go come.

View Details

Today fess song say God take dis richusness take dash we and de sekond song say make we stay hinside Jesus.De message of Hope say pesin wen say hin fit richus by hinsef na sef richus pesin and dat one no good bikos na only Jesus fit give us richusness

View Details

God want make wife dem get beta karacta so dat deir beta karacta go make deir husband give Jesus deir life too.Today message of Hope dey tell us say make we stay hinside Jesus as we dey pray and read hawa bybbo so dat sin no go get pawa for hawa life

View Details

De way wen husband go take tell hin wife watin e no life so dat de wife go hear and change naim bi today tork.Today message of Hope dey tell us watin make God take human being body take come dis world to save us.

View Details

De kain pipo wen fit get bress kancer and de rezin wen make dem get dis kancer naim bi today torkToday message of Hope dey tell us say Jesus come dis world as ordinari pesin so dat e go save we and bi hawa exampo.

View Details

De lesin today na say no bi evrytin wen korret for pesin eye e sorpose do so make pipo dey ask God bifor dem do enitin.Today message of Hope say make we know Jesus as God wen come as human being come die for we so dat we go save.

View Details

Today lesin bi say wen pikin dey play de kain play wen e go fit take wound, make we fine anoda tin wen e go like give am.De message of Hope say na only Jesus wen die for we naim fit make we richus so make know Jesus from hawa bybbo and bi like am.

View Details

Today praya na for kristian dem wen dey for Nort, for deir vilage, deir church, pastor, and evrytin wen konsign dem.De message of Hope dey tell us watin e mean to tork say pesin richus for God eye as Aposo Paul and James take tork am

View Details

Hawa fess song say na fait we take dey forlow God waka and hawa sekond song na praya make God epp us bi kristian like Jesus.De message of Hope say wen we get Jesus for hawa life, we bi winna and devo no go fit do us enitin.

View Details

Today lesin na say make we no bi pipo wen dey tork hawa husband sekret for publik and make we get beta karacta.De message of Hope say wen we forlow Jesus waka, hawa life go show say we bi kristian wen resembo Jesus.

View Details

Wen husband and wife dey play togeda, dey like demsef and dey go oliday togeda and sleep togeda, fite go commot for de family.Today message of Hope say kristian na pesin wen dey do good good tin for hin life.

View Details

Today mata na Bress Kancer wen dey do woman and wen dey make doktor dem cut woman bress and e dey kill too.De message of Hope dey tell us say kristian na God pikin wen know say God naim papa and e dey do watin God tell am

View Details

De tin wen dey happun wen pikin dem enta dis boyfren and girlfren mata naim bi today mata.Today message of Hope say wen we tru-tru give Jesus hawa life hawa life go change and we go come dey resembo Jesus.

View Details

Today advise say make papa and mama tell deir pikin hoha watin dem want make dem know or do, make dem no dey tork ben-ben tork.De message of Hope say Jesus naim die so dat we go get new life and hin dey commot hawa old life wen we give am hawa life.

View Details

Today praya na for all de pipo wen dey sick make God for kure dem.De message of Hope dey tell us say wen we say we bi kristian, e mean say we don give Jesus hawa life and we don bon again.

View Details

Today fess song say make God draw us come where hin dey and de sekond song na pray wen family dey pray take sorranda give God.De message of Hope dey tell us say make we bi pipo wen go pray and we no go stop to pray bikos na so God want am.

View Details

De tin dem wen wife go do wen go make hin husband bi beta husband for am wen kata-kata no go dey de house naim bi today mata.Today message of Hope say wen we pray as God want, we go come bi pipo wen go know God wel-wel and dey do watin God want.

View Details

Small small tins wen husband and wife go do wen go make dem no dey fite again for house naim bi today mata.Today messsage of Hope dey tell us say wen we pray make we wait bikos na God know de korret time to take do watin we want.

View Details

De tin wen pesin fit do wen no go let am get dis piss sikness naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen de dey pray and ebi like say God no dey hear, make we no stop but make we kontinue to pray.

View Details

De kain film dem wen hawa pikin dem dey look de make dem dey enta dis boyfren and girlfren mata bikos dem wen bi like de pipo for de film.Today message of Hope say if God go ansa hawa praya we musto commot fear from hawa hat and get fait.

View Details

Papa and mama go praise pikin wen e do good tin and enkorrage am to do more, na dat one go epp de pikin bi beta pikin.Today message of Hope dey tell us say pesin wen hin hat klin wen sin no dey hin bodi naim God dey hear hin praya.

View Details

Today praya na for family dem, make God for epp make family no scatar bikos of enitin as kontree hard now.De message of Hope dey tell us watin praya bi and how we sorpose do hawa praya wen God go take hear.

View Details

Today fess song say god want make we dey sing even wen life de slap us and de sekond song say make God ansa my praya.De message of Hope dey tell us say as we dey believe God, hawa fait go dey strong and we go come get big fait.

View Details

De tin dem wen wife go try do for deir marrage wen de marrage go take sweet reach evening naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say praya and fait na five and six and eni praya wen no get fait no go get God ansa.

View Details

De tin dem wen dey make pesin get dis piss sikness and watin we fit do make e no enta hawa bodi naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say fait naim bi hawa bulletproof wen no go let devo fit shoot us.

View Details

De tin wen make hawa pikin dem dey do dis boyfren and girlfren mata naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen we get fait, hawa fait go give us pawa wen we go take win de fite wen we dey fite for dis world.

View Details

Papa and mama wen want beta pikin musto dey forlow deir pikin tork so dat dey pikin go know as e go take waka for life.Today message of Hope say make we get de fait wen know say God get pawa to take do watin e say e go do.

View Details

Today praya na make God epphin pikin dem make dem know am wel-wel so dat dem go fit do hin work bifor e come.De message of Hope dey tell us watin fait bi and why we sorpose get fit bikos na only fait we go fit take make God happi.

View Details

Today fess song na hymn wen bi "I must tell Jesus" nd de sekond song na "God dey ansa praya"De message of Hope dey tell us say no mata watin we see for church and for life make we kontinue to call God bikos God dey hear hawa call and cry.

View Details

De tin wen wife dem go fit do wen go make deir husband bi beta husband and head for deir family naim bi today tork.Today message of Hope dey tell us say wen Jesus don save us make we forlow am waka as Mary Magdalene forlow an wake.

View Details

Anoda small advise wen we dey give woman wen want make deir marrage stand gidigba naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen we come mit Jesus, Jesus go change hawa life and we go get free mind take serve Jesus.

View Details

De kain sikness wen pesin fit get wen konsign as pesin take dey piss and how pesin go take know if dis sikness dey bodi naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen we do as God tork we go see beta blessing and miracle for hawa life

View Details

De kain boyfren and girlfren wen today pikin dem dey do wen dem no sorpose do naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say God redi to save evry pesin wen come mit am and e no go drive dem commot for bodi

View Details

De kain way wen papa and mama go take train deir pikin wen de pikin go take bi beta pikin naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen we come mit Jesus e go change hawa life like e change Rahab life wen e no take bi ashawo again.

View Details

Today praya na for God to put hand for moni mata for hawa kontree make Govament pay pipo wen dey work beta moni.De message of Hope dey tell us say as we dey forlow God waka, we go see say God na good God.

View Details

Today fess song na praya make God hold hawa hand make we fit enta heaven and de sekond song say make we no look back as we dey forlow Jesus waka.De message of Hope say de waka we dey forlow Jesus waka so naim bi de waka wen we go take go heaven.

View Details

De lesin wen konsign as God take tork say de husband naim bi oga kpata-kpata and watin dat one mean naim bi today mata.Today message of Hope say as we dey forlow Jesus waka make we no let fear enta hawa life bikos God no dey give hin pipo fear.

View Details

Some small small advise wen wife dem go take make deir marrage stand gidigba naim bi today mata.De message of Hope dey tell us say make we dey take God word take do hawa praya so dat God go dey ansa hawa praya shap-shap.

View Details

De kouf wen doktor dey call tubakolorsis, watin dey cos am and how we go take know if we get am naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say God want make we dey ans am for de tin dem wen we want make e do for we.

View Details

De lesin today na say make we no dey do dis lie-lie play-play wayo wen pipo dey do bikos pesin fit just die.Today message of Hope dey tell us say de good wen we dey do for even pipo wen no bi hawa friend na one tin wen de show say we bi beta kristian.

View Details

Anoda work wen God give man as husband na say naim go dey put moni for ground wen hin wife go take dey manage de family.Today message of Hope dey tell us say as we dey forlow Jesus waka, God grace dey yanfu-yanfu to take commot us from sin

View Details

Today praya na make God epp make hawa fama dem fam bring plenti food so dat hunga go commot kontree.De message of Hope dey tell us say if we tru-tru wan forlow Jesus waka, we go bi pipo wen near God as we dey pray de do watin God tork.

View Details

Today fess song na praya make God give us klin hat and de power wen dey Jesus blood go fit klin all hawa sin.De message of Hope dey tell us say man wen dey sleep with man and woman wen dey sleep with woman na pipo wen God dey forbid.

View Details

De mata wen konsign as man take bi oga kpata-kpata for woman and woman wen no get man for hin life no bi pesin for pipo eye nai bi hawa tork today.Today message of Hope say pipo wen dey kill odar pipo na bad pipo for God eye and God dey forbid dem.

View Details

Anoda small small advise wen hawa husband dem no sorpose do so dat hawa marrage go stand gidigba.Today message of Hope dey tell us say wen pesin leave God go forlow juju, e resembo wife wen dey sleep with man wen no bi hin husband and God dey forbid am

View Details

kolera na sikness wen dey kontree now and e dey make pipo shit and vomit and na sikness wen fit kill pipo shap-shap.De message of Hope dey tell us say wen we no dey do watin God tork for hin Law naim bi say we go bi pipo wen God go forbid.

View Details

De rezin wen make hawa pikin dem dey play dis lie-lie play wen dem dey play naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say God dey forbid to hear say we believe say pesin wen die neva tru-tru die.

View Details

God want make de man bi de pastor for hin family and make e dey tish hin wife and pikin watin god tork.Today message of Hope dey tell us say pesin wen go dey serve juju na pesin wen God go forbid bicos God no want make we serve juju.

View Details

Today praya na for all hawa leda dem make God give dem sense wen de go take make kontree beta.De message of Hope dey tell us all de bad bad tin wen God no wan see for hawa bodi and how we go take commot hand from dos tins dem.

View Details

Today fess song say na God word we dey take waka and de sekond song na praya make God klin hawa hat.De message of Hope dey tell us say bad bad pipo go dey church bifor Jesus come so make we hold God kakaraka make we no for fall.

View Details

God say make man no dey by hinsef naim e come make woman give am and no so woman life take dey man hand.Today message of Hope dey tell us say de kain hat wen we get naim go show weda God word go fit change hawa life.

View Details

Some tins wen wife dem no want make deir husband dey do naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say God want make we resembo am and make hawa karacta dey show say we bi hin .

View Details

De kain tin wen dey make belle wen woman get come get wahala bifor de belle fit big naim doktor tork put today.Today message of Hope say de kain savant wen bi beta savant for God eye na de savant wen dey do watin God tork.

View Details

De kain lie-lie wayo wen some pipo dey take play-play do odar pipo and de kain wahala wen dis play fit bring naim bi today mata.Today message of Hope say pesin wen do watin God tork resembo house wen dey on top of rock wen nortin go fit fall am.

View Details

De work wen God give man wen e make man put ma for dis world naim bi today tork.Today message of Hope dey tell us say Jesus naim bi dis world lite and as we give am hawa life, we sef go come bi lite for hawa korna.

View Details

Today praya na de one we take dey beg God make e give hawa husband dem work so dat moni go dey family and wahala no go enta family.De message of Hope say Jesus stori abat new drink and new borto dey tell us say we go bi new pipo wen Jesus enta hawa life

View Details

Today two song na praya make God give us fait to take forlow am and make e open hawa eye make we for fit see am.De message of Hope say God go give us fait like gold, wite klot wen go take bi like Jesus and medcin for hawa eye wen we go take see wel-wel.

View Details

Watin woman wen dey forlow man waka go do to take trust de man and to take know weda de man sef trust am naim bi today tork.Today message of Hope say God de take hawa wahala dem take make hawa fait strong so dat hawa fait go bi like fine gold.

View Details

If marrage go stand well, de husband go put god fess for hin life and e no go take hin family do yeye.Today message of Hope dey tell us say God Law naim bi de miro wen de show us hawa sin so make we dey do watin God tork for hin word.

View Details

How woman go take know say hin get belle and de kain tin dem wen de happun wen woman get belle naim bi today tork.Today message of Hope say Jesus get 3 way wen e dey take commot pipo from hin church wen no get beta mind take forlow am waka.

View Details

De tin dem wen hawa pikin dem go put for mind as dem de choose de kain work wen dem want do for life naim bi today mata.Today message of Hope say God no want make we dey church and we no get beta mind to take forlow am waka as hin want make we waka.

View Details

Watin husband go do wen e go take fit join bodi with hin wife so dat dem go bi one pesin as God tork naim bi today mata.Today message of Hope from de numba seven church bi say God jorgement don stat and na we today bi dis numba seven church

View Details

Today praya na praya of thanksgiving and blessing for de listena convenshion wen just finish for Mubi.De message of Hope dey tell us say make we hold Jesus kokoroto make anoda pesin no come take hawa crown wen Jesus wan give us.

View Details

Today fess song na "Whispering Hope" and de sekond song na "Trust in the Lord" and dem bi song of hope.De message of Hope say wen we kontinue dey rememba de tin dem wen God dey do for us we go dey always get hope and hawa hope go dey grow.

View Details

Pesin wen dey dis life musto get anoda person wen e trust but we must shine hawa eye to know de kain pipo wen we dey trust.Today message of Hope dey tell us say Praya dey let us get Hope bicos we know say God no dey fail and e dey ansa praya.

View Details

Some small small tin dem wen wife go do wen e marrage go take sweet, go take get peace and tay reach evening naim bi today tork.Today message of Hope dey tell us say wen we read God word, we go see plenti tins wen go epp us get hope.

View Details

Na lice wen dey dey for pesin head, odar place wen hair dey for de bodi dey suck blood naim bi hawa mata today.Today message of Hope dey tell us say wen we get beta pipo for bodi wen get beta mind, dem sef go fit epp us get hope wen yawa dey.

View Details

De bad tin wen dey hinside pikin wen dey play wayo dey go rite ezam for anoda pikin naim bi today tork.Today message of Hope dey tell us say wen e bi like say life wan swalow we make we get hope say God sabi save hin pipo and e go fit save dem.

View Details

De tin wen husband and wife go do wen dem go take join bodi togeda come bi one as God want naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen life take us stone ground and e bi like say notin dey, make we get Hope bicos God dey.

View Details

Today praya na for hawa pipo dem wen dey for IDP camp bicos wicked pipo bon deir village make God come setto dem.De message of Hope dey tell us watin Hope bi and watin e mean to put hawa hope for God.

View Details

Today two song dey tell us say God Law naim bi de life wen we get and naim go fit protect us from de wahala wen dey come for front.De message of Hope say devo go try deceive pipo but if we know God word and do watin God tork devo no go fit deceive we.

View Details

E good make woman trust hinsef bicos na as e take trust hinsef na so odar pipo go fit take trust am.Today message of Hope say God know watin we fit do and watin we no fit do and e no go let us get wahala wen big pass we.

View Details

Lapa-lapa na sikness wen no dey kwik commot for pesin bodi so e go good make we do watin we go do make e for no enta bodi.Today message of Hope say e no mata how bad pipo plenty reach for church, God still get hin own pipo.

View Details

De wayo wen pikin dem de do so dat dem go pass deir exam no bi beta tin bicos wayo na sin.Today message of Hope na say God tork say pipo fit dey do like say dem bi kristian but God no know dem so make we no bi like dos pipo.

View Details

De aria for marrage wen husband and wife go for join bodi togeda and how dem go take join bodi naim bi today mata.Today message of Hope na de message wen God give de church wen dey Sardis wen don die but den dey do like say dem bi church wen get life.

View Details

Today praya na for hawa farma dem and watin dem plant make God let dem get beta harvest wen melu, inset, water and odar bad tin no go scata.De message of Hope say make we no dey wey pipo go dey make us sin bicos Jesus go soon come with hin repot card.

View Details

Today fess song say hawa God dey gidigba, e neva die and e no go fit die and de sekond song say God name get beta pawa.De message of Hope say God pawa for hawa life go epp us get strong mind wen we go take do de tins wen no go let us dey sik.

View Details

Watin trust bi for hawa life, how we take dey know trust and de kain pesin we sorpose trust and watin trust for God bi naim bi today mata.Today message of Hope say wen Holy Spirit pawa enta hawa life, we no go dey take sin dey baff again.

View Details

Tiree tins wen konsign how husband no go work so tay e come forget hin family naim bi today mataDe mesage of Hope dey tell us say God pawa wen dey hawa life dey give us peace even wen wahala dey.

View Details

De eye sikness wen doktor dey call Catarat, and watin pesin sorpose know abat de sikness naim bi today tork.Today message of Hope say as we get new life wen we baptise, we go come dey read and do watin God tork make hawa new life for dey kankpe.

View Details

De kain kain bad tin wen de happun for pikin life wen e storbon naim bi today mata.Today message of Hope say wen we tru-tru give Jesus hawa life and come bon again, God go give us new life.

View Details

Make pesin no dey tell hinsef say e fit beta pass anoda pesin but make e do hin own tin as God giam pawa reach.Today message of Hope say God go give us pawa wen hawa life go take change and we go come bi as God want make we bi.

View Details

Today praya na for hawa pikin dem make God epp dem to commot hand for bad tin and make God give de one wen dey fine work work.De message of Hope dey tell us say God dey give us de pawa wen go make us give Jesus hawa life as de Holy Spirit enta hawa life

View Details

Today two song dey tell us say make we stand for God korna, get strong fait bicos e no go tay now Jesus go come.De message of Hope say make we get strong fait wen we go take stand no mata de wahala wen devo bring, we go win like Job for Bybbo.

View Details

De way wen we go take wash hawa klot dem wen dem go take last naim bi today lesin for hawa woman korna.Today message of Hope say make we get fait and trust God like Moses mama and God go do watin e go do for we.

View Details

De tin wen some woman de learn from telivishion and fone wen dem dey do for deir marrage no dey let dem bi beta wife.Today message of Hope say wen we take fait waka hawa waka like Joseph for Bybbo, we no go worry bicos God go dey hawa korna gidigba.

View Details

Today mata na how hook worm dey enta pesin bodi, de sikness wen e dey bring and watin we fit do to commot am for bodi.De message of Hope say wen we believe God word and we hold an kakaraka, notin go shake us, we no go worry.

View Details

De rezin wen make pikin dem dey get strong head no dey do watin deir papa and mama tork naim bi today mata.Today message of Hope say wen we put hawa fait for Jesus, trust am and dey do watin e tork, we no go worry.

View Details

Wen family waka and tork togeda and dem redi to change and do beta tin, God go epp dem make de beta plan for deir life work.Today message of Hope say make we no dey worry but make we get fait bicos we bi pipo wen God don bless yanfu-yanfu.

View Details

Today praya na for de pipo wen die pesin die like Charles Japhet for Adamawa and Jadu wife plus deir pikin and family pipo.De message of Hope say make we no worry bicos God neva change and God know hawa kondishion so make we trust am.

View Details

Today fess song say make we do watin God tork and de sekond song say make we come back like de prodiga pikin for bybbo.De message of Hope say as sin go boku bifor Jesus go come, God go still get pipo wen go forlow am like Samuel for Eli house.

View Details

De tin wen we go do as woman for hawa pant, brazier and shimi wen dem go take klin naim we tork today.Today message of Hope say bifor Jesus go come mani pipo go bi like Eli pikin dem wen no get kontro dey do enihow wen make dem die-troway.

View Details

Bad friend wen some woman dey get wen dey tach dem bad bad tin dey make some woman no bi beta wife.Today message of Hope say make papa and mama pray make God show dem how dem go take train deir pikin make deir pikin no for loss like Samson.

View Details

De tin wen we go do make we no for get Kwashiokor wen bi sikness wen dey do pesin wen no chop beta food naim bi today mata.Today message of Hope say bifor Jesus go come lie-lie na one sin wen go dey pipo life wen no go let dem go heaven.

View Details

De lesin for hawa pikin dem today na make dem no get strong hat dey do watin dem no sorpose do.Today message of Hope say anoda sin wen go dey yanfu-yanfu bifor Jesus go come bi say pipo wen bi God pipo no go fit stand as God want wen wahala come.

View Details

Husband and wife wen no want wahala for deir family go sabi kip deir sekret mata dem and dem no go tork am give odar pipo.De message of Hope say anoda sin wen go plenti bifor Jesus go come na drink, pipo go dey shak and dem no go know demsef.

View Details

Today praya na for kristian dem wen dey for Niger, Kaduna, Plateau and Benue area make God for kip dem safe.De message of Hope tell us say bifor Jesus go come mani pipo no go dey do watin God say make dem do and dis sin no go let dem go heaven.

View Details

Today two na praya, de fess song say make God klin hawa hat and de sekond song say make God forlow us dey.De message of Hope say make we stay hinside God as we dey read hawa bybbo and pray so dat hawa hat go klin for God to stay hinside.

View Details

Watin woman go do for hin hair wen de hair go take fine and make de woman be beta and fine woman naim bi today mata.De Message of Hope dey tell us say make we no take long troat take de forlow dis world bicos pesin wen forlow dis world no go go heaven

View Details

De kain exampo wen mama and papa dey give hin pikin dey watin dey make some woman no fit bi beta wife.Today message of Hope say make we commot hawa eye from dis world and all de tin wen dey de world and make we put hawa eye and mind for Jesus.

View Details

De kain sikness wen dey do woman wen just bon pikin and watin we fit do put naim bi today mata.Today message of Hope say anoda work wen God want make we do bi say we no go do enitin wen no go let us go heaven wen Jesus come.

View Details

De lesin wen pikin dey get as e dey do watin papa and mama say make e do and how dat one dey make am get beta life naim bi today mata.Today message of Hope say make we bring hawa life come give God like de sakrifice wen Isreal dey give God bifor bifor.

View Details

Anoda tin wen husband and wife go do to take commot wahala for family na say make dem dey hear ish odar well.Today message of Hope say God want make we bring hawasef come give am and make we commot bodi from sin

View Details

Today's praya na make God bless hin pipo make moni dey for hand so dat family go fit do watin dem sorpose do.De message of Hope dey tell us say God dey give us mercy and e want make we sef dey sorri for odar pipo.

View Details

Today fess song na "Sweet aur of Praya" and de sekond song na De Fada will"De message of Hope dey tell us say hawa praya and hawa fait musto join hand togeda if we tru-tru want make God ansa wen we pray.

View Details

Woman wen fine for bodi but e no fine for hin karacta bi like pig wen wear gold for hin nose.Today message of Hope dey tell us say beta blessing dey wen we get fait bicos with fait we go fit do watin Jesus do wen e dey here.

View Details

Wen papa and mama don teach deir pikin watin dem sorpose teach am wen e small wen de pikin big e no go fit bi beta wife.Today message of Hope dey tell us say as life bi now, na de wahala dem wen satan dey take stone us naim de let hawa fait de strong.

View Details

De tin wen we go do as sun dey waya pipo now wen de heat no go take bring sikness come bodi naim bi today mata.Today message of Hope say for today life make we get de fait wen go hold God kakaraka like supa-glue.

View Details

Today lesin na say pikin wen dey do watin papa and mama tell am na pikin wen pipo dey praise and e go sabi do beta tin wen e big.De message of Hope dey tell us say for today life if we tru-tru get fait we go bi pipo wen dey do watin God tork,

View Details

Anoda tin wen go commot wahala from marrage na wen husband and wife dey tork good tin abat ish odar and abat deir pikin.Today message of Hope say for today life, make we get de fait wen go do watin God tork bicos na dat fait go make God happi

View Details

Today praya na for all de family wen get katakata for deir marrage and for de woman dem wen de fine pikin.De message of Hope dey tell us say as life bi now na beta strong fait naim we sorpose get if we tru-tru wan forlow God waka

View Details

Today two song tell us say God na tork-na-do, e no dey change and e still dey ansa praya today as e ansa de pipo wen pray for BybboDe message of Hope show us pipo wen pray for Bybbo and how God take ansa deir praya so dat we too go pray.

View Details

Woman wen pipo go praise say na fine woman na woman wen dey fear God and e dey do watin good for God eye.Today message of Hope say wen pesin dey sin and e no dey do watin God tork for Hin Law, God no go ansa dat pesin praya.

View Details

Wen man no open belle forlow hin wife waka for de house and wen e dey lie give hin wife, de wife no go bi beta wife.Today message of Hope say wen we pray make we belive say God dey hear and if e hear, e go ansa hawa praya.

View Details

De tin dem wen woman sorpose do wen e dey see hin time so dat e go well and hin bodi go fine naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen we pray make we rememba say God naim know pass we so make we trust God even wen we no like hin ansa

View Details

De kain work wen papa and mama dey give pikin for house as e dey big make e do naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say God want make we take hawa mout take ans am watin we want make e do for we.

View Details

Anoda tin wen we go do wen wahala no go take dey hawa family na make we sabi kontro hawa sef.Today message of Hope dey tell us say de praya wen God go ansa shap-shap na praya wen get fait and know say God go do watin e tork.

View Details

Today praya na for God to make hin pipo know am well-well and serve am too and make e rememba hin pipo wen dey suffa bicos of hin name.De message of Hope dey tell us say make we dey pray bicos God dey ansa hin pipo praya.

View Details

Today fess song say make we no love de world and de sekond song na de hymn wen say we don deside to forlow Jesus.De message of Hope say Jezebel spirit wen dey kill God pipo dey church today as govament pipo dey come church but dem no redi to serve God

View Details

Watin bi de korret fine wen woman sorpose fine, watin we go see wen we go take tork say woman fine.Today message of Hope dey tell us say devo dey bring him message hinside church but make we trust God word and stand for God.

View Details

Wen husband and wife no dey tork well togeda, de wife no go get beta mind for de husband and e no go fit bi beta wife .Today message of Hope dey tell us say make we no bi like Balaam wen bicos of moni e come make God pipo fall for sin.

View Details

De tin wen woman sorpose know and do wen e get belle wen de belle and de woman go well kankpe naim bi today tork.Today message of Hope tell us say wen we suffa bicos of Jesus make we rememba say Jesus suffa too and e dey come save us.

View Details

De tin we sorpose do as we dey redi for Jesus wen go soon come naim bi today lesin.De message of Hope tell us say as de church for Ephesus no dey forlow God waka as dem dey waka bifor, na so we too dey do and God want make we repent.

View Details

Anoda tin wen fit commot wahala from family na make husband love and put hin family for numba 1 for hin life.Today message of Hope tell us say Jesus praise de church for Ephesus bicos dem get pachance and dem not let wayo aposto deceive dem

View Details

Today praya na for pipo wen dey sik for deir bodi make God for commot sikness from deir bodi.De message of Hope dey tell us say as de pipo wen dey de seven church wen dey Revelashion bi na so we bi so make we take dem learn lesin.

View Details

Today two song dey tell us say God dey ansa praya so make we kontinue to dey prayDe message of Hope dey tell us say make we take God word take do hawa praya and make we get fait and God go ansa.

View Details

Wen husband no dey do de kain tin dem wen go make hin wife bodi tortor-ri am, e go make de wife no bi beta wife.De message of Hope say make we get de kain mind wen Jesus get so dat we go fit pray hawa praya like Jesus praya.

View Details

De tin wen we fit do make de kouf sikness wen bi tobakolorsis no for enta hawa bodi naim bi today tork.Today message of Hope dey tell us say make we dey pray hawa own praya as Holy Spirit dey epp us bicos God like to yer hawa voice.

View Details

De wahala wen fit happun for pikin wen no sabi kip hin bodi well dey wakajugbe dey do opio work naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen we let de Holy Spirit epp us for praya, we go con sabi trust God and we go do watin God want.

View Details

Make husband and wife know say wahala dey for evry marrage and make de, get de mind say dem go fit setto evry wahala with God epp.Today message of Hope dey tell us say de Holy Spirit naim know God and Jesus pass we so make we let am teach we to pray

View Details

Today praya na for all de sik pipo make God commot sikness for deir bodi and make dem well.De message of Hope dey tell us say God wan give us de Holy Spirit so dat de Holy Spirit go epp us de pray beta praya wen God go ansa.

View Details

Today fess song say make we no commot mata for mind come say we no do again and de sekond song say we no go stand by hawasef.De message of Hope say, even wen e bi like say nobodi dey hawa korna, make we no diskorage bicos God no dey forget hin pipo.

View Details

Kweshion wen konsign de mata of how woman go take klin and fine naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen we fall for hinside sin, God pawa dey wen we go take commot for de sin and wen we no go take sin again.

View Details

Wen husband no sabi praise and salut hin wife for de mani tin wen e dey do for am, de wife no go fit bi beta wife.Today message of Hope dey tell us say wen sikness come hawa bodi, God get de pawa wen e go take commot de sikness and we go well.

View Details

Tobakolorsis wen bi sikness wen dey make pesin kouf, watin dey cos am and how pesin go take know say e get am naim bi today mata.De message of Hope say devo get mani fite wen e dey forlow us fite but God don give us pawa wen we go take win am.

View Details

De kain tin dem wen pikin dem dey see and do wen fit make deir bodi dey do jigi-jigi naim bi today tork.Today message of Hope say wen e bi like say we no get pawa take face watin big pass we, make we rememba say God pawa dey for we.

View Details

De kain tin dem wen de make kata-kata dey for family bitwin husband and wife naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say life get plenti trobo but wen Jesus dey hawa life e no go let trobo wen big pass us come hawa life.

View Details

Today praya na make God come epp we fite all de kidnapa dem and make e save de pipo wen dey deir hand for bush.De message of Hope dey tell us say wen e bi like say we no dey get de tin wen we pray make god give us make we trust God.

View Details

Today two song dey tell us say make we get strong mind for Jesus and e go show us as we go take waka wen wahala no go dey.De message of Hope dey tell us say wen we dey for wahala and we cry call Jesus, e go come save us, so make we no fear.

View Details

De way wen we go take rob pomade make hawa bodi fine as woman wen we no go take old pass hawa age naim bi today mata.Today message of Hope tell us say bifor Jesus go come but we go see plenti kata-kata but pesin wen Jesus hold hin life no go fear.

View Details

De tin wen we go fit do wen we no go take get sikness for hawa mout naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen we want make God bless we, we must redi to pray, read God word and do watin God say make we do.

View Details

De kain place wen hawa pikin dem for dey learn how to take know watin dey happun bitwin man and woman naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen we dey for wahala like Jacob, make we run come wrey God dey bicos naim fit epp us

View Details

Wen pesin get dis bitaness wen we dey tork since, de pesin no go fit forlow God waka bicos bitaness na sin for God eye.Today message of Hope dey tell us say wen wan stay with God, we go commot for sin and evrytin wen God no like and forlow God.

View Details

Today praya na for all hawa family as oliday don start, make God epp make food dey house and make trobo no enta eni family.De message of Hope dey tell us say wen we dey wery God dey we go see as God big reach and we go see hawasef as God dey see us.

View Details

Today two song dey tell us say God dey with us gidigba an hin promise so make we no dey fear, make we no worry.De message of Hope say as we get de new life wen God give us, God hinsef go tanda with us and e go stand for us gidigba.

View Details

Hinside hawa woman mata today, na de korret way wen we sorpose take wash de part of hawa bodi wen make us bi woman naim we tork.Today message of Hope say wen God give us hin new life, we go bi pipo wen know God word and we go dey do watin God tork.

View Details

Husband wen no bi beta husband and wen no fit make deir wife know God naim dey make some wife no bi beta wife.Today message of Hope say wen e bi like say life don finish and we put hawa fait for Jesus, e go make hawa life come back again.

View Details

De tin wen we go see for hawa mout and hawa bodi wen we go take know say sikness don enta hawa mout naim bi today mata.Today message of Hope say wen God give us in new life we go change and all de bad bad tin wen we dey do bifor, we no go do dem again.

View Details

De tin wen dey happun hinside hawa pikin dem bodi as dem dey big wen dem dey take know watin man and woman fit do naim bi today mata.Today message of Hope na de call wen God dey call pipo wen wan get de new life wen God dey give make dem come mit God.

View Details

De kain sikness wen no get kiour wen bitaness, dat vexnation wen dey dey pesin hat fit cos for pesin bodi naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say we sorpose know God if we tru-tru wan get de new life wen God dey give hin pipo

View Details

Today praya na for all hawa man wen bi husband, papa, broda, pikin, make God for put hand for deir life make deir life for beta.De message of Hope dey tell us say if we go get de beta life wen God dey give hin pipo, we must know God by hawasef.

View Details

Today song dem de enkorage all of us say God neva forget we and enihow ebi, God still dey for hawa korna.De message of Hope dey tell us say make we no dey worry bicos God dey hawa side and bicos God dey hawa side, no shakin.

View Details

How we go take baff hawa bodi make we no for smell and de ariya dem wen we sorpose wash well well naim we tork today.De message of Hope dey tell us watin and watin we go do as we dey forlow God waka wen hawa fait go take grow come bi big fait.

View Details

Girl pikin wem hin mama no train well and bad husband naim dey make some woman bi bad wife.De message of Hope dey tell us say pesin wen no baptise no fit tork say hin bi kristian bicos Jesus say we usto belive and baptise bifor we fit bi kristian.

View Details

De diffren diffren sikness wen fit happun for hawa mout and watin dey make pipo get dis sikness dem naim bi today tork.Today message of Hope dey tell us why we sorpose go shurch as God pikin bicos Jesus wen bi hawa exampo go shurch well-well.

View Details

Watin pipo go do wen we go take end aproko work for skool and family naim bi today advise.Today message of Hope dey tell us watin we go do wen we go take bi beta korret kristian for God eye and for pipo eye.

View Details

De way wen de bitaness take dey commot for one pesin bodi dey enta anoda pesin bodi naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say na Jesus naim bi hawa salvashion bicos na bicos e die for we we go fit enta heaven

View Details

Today praya na make God come epp hawaleda dem catch de pipo wen dey tif hawa oil and food commot for de kontree.De message of Hope na de ansa for de kweshion of weda God tru-tru dey and we dey suffa like dis for today life.

View Details

De way wen Sarah take bi korret beta wife for Abraham and watin e do as beta wife naim bi hawa lesin today.Today message of Hope na how Zacchaeus and Jesus take mit wen Zacchaeus come take give Jesus hin life come bi beta kristian.

View Details

Two kain sikness wen fit do us for hawa teet and mout and watin we sorpose do if e happun naim bi today tork.De message of Hope tell us how Peter take know say Jesus na Oga kpata-kpata wen e come take get fait forlow Jesus come bi Jesus disciple.

View Details

De kain tin dem wen aproko dey do, how aproko dey scata friend and family and why we no go do aproko naim bi today mata.Today message of Hope na how de woman wen Jesus forlow tork for well take know Jesus and call odar pipo come mit Jesus

View Details

De kain tin wen bad belle dey do wen pesin get am naim bi today mata. Bad belle dey wound pesin wen get am.Today message of Hope na de testimony wen Rehab get as e take know God wen e take save hinsef and hin family wen dem no die for Jerico.

View Details

Today praya na for de pipo wen dey manage hawa lite, make God change dem bicos de darkness wen we dey don off many pipo bizness.De message of Hope na watin King David take tell us say God na good God wen dey do beta beta tin for hin pikin dem.

View Details

Today two song na one praya say for dis bad time wen we dey so, make God remember we.De message of Hope say as like dey now make we no put hand for jaw dey do siddon look bicos devo dey give siddon look pipo work wen no go let de go heaven.

View Details

De kain tin dem wen we sorpose do as woman wen konsign how we go take klin hawa bodi make we fine naim bi today mata.Today message of Hope say as we dey forlow Jesus, make we dey do watin e tell us bicos na dat one dey show say naim bi hawa Oga.

View Details

De way wen Noah wife take forlow hin husband waka wen we take bi korret beta wife naim bi today lesin.Today message of Hope say make we no lazy but make we bi like de five wise virgin dem wen carri extra oil and deir lamp no off.

View Details

De kain sikness wen fit do pesin for mout, for teeth, for tongue naim bi today mata.Today message of Hope say as we dey wait for Jesus to come, make we no dey do enihow but make we commot hawa hand from sin and waka as God say make we waka.

View Details

De tin wen make pikin dey do aproko and watin pipo dey take do de aproke naim we tork put today.Today message of Hope dey tell us say as life bi now, God want make we commot hawa hand from bad tins make we no resembo de pipo wen de hinside sin.

View Details

De kain bad belle wen pesin get for you wen oyibo dey call "Bitaness" naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen life hard and tins get as dem bi make we rememba say Jesus na hawa korret beta friend wen go epp us.

View Details

Today praya na for all of us and hawa kontree bicos porvaty plenti now and hunga dey yanfu-yanfu make God epp us.De message of Hope say as life dey hard, we go dey ask God why but make we trust God bicos God no dey forget hin pipo.

View Details

Today fess song na praya make God klin hawa hat and make e give us beta hat so dat we go fit forlow am well-well.De message of Hope say make we dey tink beta tin for hawa hat bicos na hawa hat naim God for dey forlow us tork.

View Details

De woman wen hin name na Lois wen bi Timoti grandmama naim we tork abat today for hawa woman korna.Today message of Hope say make we give Jesus hawa life bicos Jesus dey come carri us go de place wen e don go arrange for me and you.

View Details

De kain tin dem wen Eve do as Adam wife wen good and de one wen no good naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say god Love naim bi hin Law wen no dey change and make we love hawa sef so dat we go fit love odar pipo too.

View Details

New sikness wen dem dey call NOMA and watin we go do wen de sikness no go take branch hawa bodi naim bi today mata.De message of Hope take de ten vejin stori take tell us say make we get sense to take do watin good for God eye and make we trust God.

View Details

Aproko and tafia no bi sometin wen pikin dem sorpose put deir hand bicos aproko dey scatar tins.De message of Hope say make we dey shine hawa eye wen we get watin we wan choose so dat we no go bi like de five foolish virgin dem

View Details

Today praya na for hawa kontree, make God commot leda dem wen bi ole and give us beta Leda, beta Jorge and beta pipo to make Law.De message of Hope dey tell us say if we want forlow God waka, we go commot from darkness come lite bicos Jesus na Lite.

View Details

Today two songs dey tell us say God dey ansa praya and e go ansa hawa praya.De message of Hope dey enkorrage us say no mata how we bizy reach make we find tie take dey pray bicos na as we dey pray God dey take epp us.

View Details

Dorcas stori tell us say as woman make we dey do good bicos de good wen we do today go come back come mit us tomoro.Today message of Hope dey tell us say make we put hawa eye for Jesus and tell odar pipo make dem give Jesus deir life.

View Details

Anoda tin wen wife musto do as wife bi say e no go get sekrit bicos God say husband and wife naked and shame no dey.De message of Hope say as God pipo de Holy Spirit musto dey hawa life and we go put hawa eye and mind for God word

View Details

Meat dey sweet but if we too chop am e fit bring de kain wahala wen doktor no dey fit cure come hawa bodi.Today message of Hope say if we wan bi like John de baptist, we go commot hand from sin, pray den we sef go preach make pipo repent

View Details

De tin wen dey make pipo dey do do-mi-I-do-you naim bi today tork.Today message of Hope dey tell us say as God pipo we sorpose know watin dey and watin we sorpose to do as Jesus dey redi to come again.

View Details

Anoda sekret family dey get na wen pesin rape girl pikin for family and family dey kip dis sekret bicos of shame.De message of Hope say as John de baptist tell pipo to commot hand from sin we sef go commot hand from sin.

View Details

Today praya na make God epp hawa pikin dem pass deir exam dis year so dat dem go go deir ness klass.De message of Hope say as John de Baptist tell pipo say Jesus dey come de fess time na so God want make we tell pipo now say Jesus dey come.

View Details

Today fess song say make we dey tell God thank you and de sekond song say make we dey count de blessing wen God dey bless us.De message of Hope say make we sabi thank God evrytime bicos we know say God na good God wen dey do only good tin for hin pipo.

View Details

Priscillia wen bi Aquila wife and how e take forlow hin husband do God work naim bi today lesin.Today message of Hope say as God pipo wen dey wait for Jesus, make we dey do good tin and epp pipo wen we meet.

View Details

Anoda tin wen we go take know wife bi say wife go join bodi with hin husband and dem go get one mind dey do togeda.Today message of Hope say as we dey wait for Jesus make we get strong mind for God wen notin go fit shake and hold God kakaraka.

View Details

De kain wahala wen scabies sikness fit give pesin, watin we go do wen we no go take get dis sikness and how we go take treat am naim bi today mata.Today message of Hope say make we pray as Jesus say make we pray make God for ansa hawa praya shap-shap.

View Details

De kain vex wen dey bring do-mi-I-do-you wen fit wound pesin naim bi today mata.Today message of Hope say anoda tin wen go make hawa fait stand gidigba as we dey wait for Jesus bi say we go dey fast as God say make we fast.

View Details

Sikness no bi sometin wen pipo sorpose hide for family bicos wen pipo hide sikness watin bad pass de sikness fit happun for de family.Today message of Hope say make we dey wait for God time bicos wen we wait for God, e dey give us hin korret blessing.

View Details

Today praya na for de pipo wen wound for de Ibadan exploshun, de family wen deir pipo die and de govment for Oyo state.De message of Hope say as we dey wait for Jesus make hawa eye no dey for propati wen we wan gada but make hawa eye dey for Jesus.

View Details

Today two song dey tell us say wen we forlow Jesus, God go make us new pipo and we go get happiness.De message of Hope say as we leave evrytin forlow Jesus, god go give us plenti blessing yanfu-yanfu for here plus life wen no dey finish.

View Details

De fait wen de woman wen blood dey commot for hin bodi for 12 years. wen torsh Jesus dress, e come well naim bi today lesin.Today message of Hope say wen we bi beta kristian dey waka as God say make we waka, wen Jesus come, heaven go bi hawa house.

View Details

Beta wife na wife wen dey make hin husband happi and de happiness dey make deir house bi beta place for pipo.Today message of Hope say pesin wen give Jesus hin life and commot hand for sin na pesin wen Jesus go save and carri go heaven wen e come again.

View Details

One sikness wen dey dey pesin bodi and e dey make bodi scratch pesin wen doktor dey call scabies naim bi today mata.Today message of Hope say beta kristian na pesin wen dey hear watin God tork and e dey do watin e hear.

View Details

One bid tin wen dey make pipo get vexnation for bodi bi say dem take de vexnation spirit from deir papa or mama side.De message of Hope say pesin wen bi beta kristian na pesin we dey forlow Jesus and e dey do watin Jesus tork say make e do.

View Details

One secret wen dey dey for family na de secret of marrage wen scata bicos of de shame wen dey hinside.Today message of Hope dey tell us say beta kristian na pesin wen believe say Jesus tru-tru die for am and e go come give Jesus hin life.

View Details

Today praya na abat all de kidnap mata wen dey for kontree make God for put hand make kidnapa no dey kidnap pipo again.De message of Hope dey tell us say if we tru-tru bi kristian, pipo go see Jesus for hawa life and karacta.

View Details

Today two song na "I shall not be moved" and "Bigger that any mountain", dem be song wen we go take get fait.De message of Hope say God na big God and e dey do watin e want do and e know de favour wen e go give us as we dey do hin work.

View Details

Safira wen bi Ananayas wife and de bad tin wen e forlow hin husband do wen dem take die naim bi today lesin for woman dem.De message of Hope say make we trust God bicos God no de forget hin pipo, e dey rememba we for eni kondishion wen we dey.

View Details

De tin dem wen we go fit do make we for fit sleep beta sleep for nite wen go make bodi strong kakaraka naim bi today mata.Today message of Hope say make we know say God know and e dey see evrytin so we no go fit hide from God.

View Details

De kain kain tin dem wen dey make pipo for family vex naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say make we dey do watin God say make we do even wen odar pipo dey tork bad tins abat us.

View Details

Today mata na de mata wen konsign de kain secret wen pipo for family dey hide.De message of Hope de tell us say make we bi pipo wen no go forget who we bi just like Moses wen no forget say hin bi God pikin even wen e day pharoah house.

View Details

Today praya na make God klin hin church make bad pastor wen dey do bad tin no dey de church again.De message of Hope na de lesin dem wen we see as we dey luk Moses life. Na God miraco naim dem take bon Moses.

View Details

Today two song na bat de Sabbath wen God tork say we sorpose rest and take worship am as our God and papa.De message of Hope say make we worship God and do good for de Sabbath as Jesus do wen e dey here.

View Details

Anoda korret woman na Mary wen bon Jesus Christ and we see say na bicos na beta girl naim make God choose am to bi Jesus mama.Today message of Hope say God caretaka must bi pesin wen no dey do wayo and jipiti but e go take God time take do God tin.

View Details

Today lesin bi say wife na woman wen sabi respet hin husband and do watin hin husband tork.De message of Hope say bicos na we bi God caretaka for hin propari, we must be pipo wen go forlow God waka and resembo God.

View Details

De kain tin wen fit happun for hawa bodi if we no dey sleep as we sorpose sleep naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say as pipo wen God give hin propati make dem dey luk dem, we sorpose fear God and dey serve am wel-wel.

View Details

Vexnation and watin dey make pikin and odar pipo dey vex and watin God tork for de mata naim bi today tork.Today message of Hope say as na god naim get all of us, we sorpose trust God bicos na only him fit to watin anoda pesin no fit do for we.

View Details

Today praya na make God come epp us stop all de kidnap, kili-kili and wahala dem wen full hawa kontree now.De message of Hope dey tell us say na God naim make we and naim make evrytin wen dey dis world and naim get evrytin.

View Details

Today fess song na "Ancient Words" and de sekond song say "God neva fail"De message of Hope dey tell us say na praya we dey take forlow God tork and wen we wan pray make we take sense take pray beta praya.

View Details

De story of Abigail wen bi Nabal wife and how e take sense take save hin family naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us de tin dem wen God go do for hawa life as e dey give us beta new life.

View Details

De pesin wen we fit call wife and watin go happun wen we go fit call woman wife naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say sometin neva happun no mean say e no go happun so make we get fait and wait for God time.

View Details

De vex wen pesin go vex tay wen go make de pesin come do de pesin wen make am vex bad tin no bi watin God want make we do.Today message of Hope dey tell us say even wen pipo do us bad tin make we no take bad pay dem but make we do good.

View Details

Husband and wife wen wan make trust dey deir marrage again sorpose commot vexnation for belle.De message of Hope dey tell us say wen we want make go repair hawa life again, we go get fait and do watin God tork.

View Details

Today praya na make God give hawa pipo sense pipo wen bi oga for family, church, for konmumity and for kontree.De message of Hope dey tell us say God know watin de devil don do for hawa life and e go fit repair hawa life make e good again.

View Details

Today two song na hawa praya make God let us dey wer hin dey and de songs bi "At Your Feet" and "I just want to be where you are"De message of Hope dey tell us say God don arrange special place wer we and am go dey and e go come take us go der.

View Details

De stori of Ruth and hin morda-in-law Naomi and de lesin wen dey naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say God go jorge de world and no bodi go fit dodge de jorgement.

View Details

De kain tin wen papa and mama dey tell deir pikin as dem de big wen no dey let dem bi beta husband and papa naim bi today mata.Today message of Hope say make we put hawa hope for God and do watin God tork bicos na only God fit hold us wen we no go fall.

View Details

De kain tin wen fit happun for pesin bodi wen e too chop salt naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say God na tork-na-do bicos as God tork am na so e dey do am so make we believe God word.

View Details

God give us put pawa wen we dey take make pipo do watin we want dem do and oyibo call dat pawa Influence.Today message of Hope say make we put hawa life for God hand, dey pray and read hawa Bybbo bicos na only God fit hold us wen we no go fall.

View Details

Wen wahala enta marrage wen scata trust, make de husband and wife tork de mata reach ground make trust for come de marrage again.De messae of Hope say de love wen Jesus love we naim make am die for we and e want make we give am hawa life.

View Details

We pray to tank God say we don enta 2024 and we pray say make hin hand dey hawa life and family dis year.De message of Hope tell us say de love wen God love we no get pat two and e wan commot us from sin so dat he go fit bless us yanfu-yanfu dis year

View Details

Today two songs na abat God ten Kormandment wen we dey call God Law.De message of Hope dey tell us God Law wen dey for Exodus 20 and how God want make we do watin e tork for hin law.

View Details

Today message for husband and wife na make dem know say e no get how marrage scata reach wen God no go fit repair am.De message of Hope dey tell us say na de 10 kormandment wen bi god law naim e go take jorge evrybodi wen dey dis world.

View Details

Today message na make husband and wife know say e no get how marrage God go scata reach wen God no go fit repair am.De message of Hope tell us say if we want kip hawa name for hinside God book make we fear God and make we no put hawa hand for sin.

View Details

Today mata na say hawa fone dem dey carri mani jems wen fit give us plenti sikness.De message of Hope dey tell us say God get book wen angel dey rite all de tin wen we dey do and na de book God go dey jorge us.

View Details

De kain kain tin wen we go see for de life of pesin wen no sabi kontro hinsef naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say God jorgement go bring all de sekret wen we dey hide come out bicos God know all hawa sekret.

View Details

Husband and wife wen want make deir marrage reach evening go try gada de marrage again and learn to trust ish odar again.Today message of Hope say make we put am for hawa mind say God go tru-tru jorge dis world no mata how e tay reach.

View Details

Today praya na to tank God for all de tins wen e do for we for 2023, for hawa family and kontree wen get peace.De message of Hope dey tell us say God jorgement dey and e no get eni pesin wen go fit dodge de jorgement wen de time reach.

View Details

Today fess song say God dey ansa Praya and de sekond song na God Love.De message of Hope dey tell us say God wen love we reach to take send Jesus come die for we go do enitin and evrytin for we as hin pikin.

View Details

Moses mama wen hin name na Jocabed naim we hear hin stori today and we see say hin bi korret mama wen we go fit resembo.Today message of Hope tell us say God want make we trust and believe am and as we believe am e go do beta beta tin for hawa life.

View Details

Today lesin na say no two pipo bi de same so make we no let devo tell us say we too diffren to fit stay togeda as husband and wife.De message of Hope dey enkorage us say make we trust God bicos naim bi hawa Shephad wen no go let we hungry.

View Details

De bad bad tin wen korfi dey do for pesin bodi and why we no sorpose dey drink korfi naim bi today mata.Today message of Hope tell us say we bi God sheep and God go kip we and notin wen bad go fit do we bicos God na hawa Shephad.

View Details

Watin and watin hawa pikin dem go do if dem tru-tru wan kontro demsef and bi beta pipo naim bi today mata.Today message of Hope say even wen we take kro-kro eye take commot God from hawa life, like de prodiga pikin, God love go still dey draw we.

View Details

Today lesin na watin husband go do to take put trust for him marrage wen hin wife forlow anoda man.Today message of Hope say as moni wen loss no know say e loss na so we loss but God love us and e send Jesus make e die to save we.

View Details

We dey kristmas time so hawa praya na make God save us wen we travel from kidnapa, Police and Road Safety pipo.Today message of Hope tell us for hinside de stori abat de man wen hin sheep loss say God love us and God don do evrytin to take save we.

View Details

Today fess song na "Behold" wen mean say look as hawa God big reach and de sekond song dey ans how we go fit take tell God say we love am?De message of Hope say church get good and bad pipo and only God naim go fit commot de bad pipo wen de time reach.

View Details

Rebeca stori as e take bi beta pikin dey epp and respet pipo and how Isaac take marray am naim we tork today.De message of Hope tell us say hawa hat bi like ground and God want make hawa hat bi beta ground so dat hin word go grow for hawa life.

View Details

Na lie for pesin wen dey do bad tin to say hin no go fit change, with God epp, pesin wen tru-tru wan change go fit change hinsef.De message of Hope say wen we resembo Jesus for hawa karacta, odar pipo go bicos of us give Jesus deir life.

View Details

De advise na say make we no dey so so drink kold wata and drink bicos e fit make hawa head, belle and odar pat of hawa bodi no work well.Today message of Hope say we bi God savant and if we do watin God tork we go bi like de wise savant for today stori.

View Details

Today lesin bi say wen you kontro yorsef, you go bi pesin wen dey do watin you wan do for de time wen you wan take do am.De message of Hope say pipo wen dey do watin God say make dem do bi like house wen dem bild on top of rock wen notin dey shake.

View Details

De tin wen wife wen hin husband de carri odar woman fit do to take put trust make marrage no scata naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say as God pipo, na we bi de lite wen God put for de world and na hawa karacta de show God lite.

View Details

As we dey near krismas time, we dey pray make God put moni for family make de Krismas for sweet.De message of Hope say de lesin wen dey Jesus stori wen konsign new drink wen dey new borto na say as we give Jesus hawa life, we don get new life.

View Details

Today fess song say God neva fail bifor and e still no dey fail and de sekond song say na hawa fait for God naim don carri us reach weir we dey now.De message of Hope say wen we do watin God tork, get fait and dey do good God go tru-tru bless we

View Details

Sarah story, how e take bi beta wife, hin mistake and all de odar lesin for Sarah life naim bi hawa woman mata today.Today message of Hope dey tell us say make we put hawa hope for hinside God and e go bless us for de korret time.

View Details

Na lie to enta marrage with de mind say you go fit change yor husband or wife, no pesin fit change anoda pesin na only God dey change pipo.De message of Hope say make we get strong mind for God, make we no dey fear, God get pawa to do watin e tork.

View Details

De tin wen family pipo fit do to take epp pesin wen de krase wen e no go take bring wahala for de family naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen we want God blessing for hawa life make we pray and ask God and e go bless us.

View Details

De kain beta beta tin wen go happun for hawa life if we sabi kontro watin we dey do with hawa life naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say blessing go dey hawa life if we arrange hawa waka and dey do watin God say make we do

View Details

De marrage wen trust go dey na marrage wen de husband and wife no go dey play ish odar wayo dey waka kurukere waka.Today message of Hope dey tell us say God go bless us if we know say naim die to give us beta life wen get blessing.

View Details

Make God kip hawa soja dem, deir family, hawa pastor dem, deir family and church safe naim bi today praya.De message of Hope dey tell us say if we want God blessing, we go come meet God and give am hawa life.

View Details

Today fess song say Heaven go shine and de sekond song say Jesus dey come.De message of Hope dey tell us say Jesus don do evrytin wen go make us go heaven with am so make we give am hawa life.

View Details

De Woman dem wen dey Bybbo, de good an bad side for deir stori and how dem forlow God waka naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us de beta blessing wen God get for pipo wen get Jesus kain mind wen no dey carri shoda go up.

View Details

Anoda lie for marrage bi say de pesin you marray naim you marray no bi hin family. De true bi say wen you marray you marray de family join de pesin you marray.De message of Hope say if we get Jesus kain mind, we go bi pipo wen humbo.

View Details

De kain tin wen fit happun for some woman afta dem bon pikin wen fit ton deir head naim doktor put mout today.Today message of Hope dey tell us say God want make we get de kain mind wen we go take do watin we sorpose do kia-kia.

View Details

De kain beta life wen hawa pikin dem go get wen dem begin kontro watin dem dey take deir life do naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen we get Jesus kain mind we go dey do watin God tork and we no go dey argue.

View Details

Husband and wife wen want make trust dey deir marrage go do watin dem tork, wen dem promise enitin dem go do am.De message of Hope dey tell us say wen we get Jesus kain mind, we no go dey fear and we no go dey tink bad tin.

View Details

Today praya na for pipo wen no dey fit waka, tork, see, hear and for pipo wen no get papa and mama make God bless dem.De message of Hope show us de kain mind wen pipo dey get and how God want make we get de kain mind wen Jesus get.

View Details

Today fess song say Heaven go shine and de sekond song dey tell us say Jesus dey come and e no go tay now.De message of Hope dey tell us say de road to take go Heaven no hard, make we give Jesus hawa life and waka as God say make we waka.

View Details

De story of de mirako wen Jesus take open de eye of dis man wen blind since hin papa and mama bon am naim bi today story.Today message of Hope dey tell us say God want make all hin pikin join togeda like de fess church for Acts 2.

View Details

De lie-lie wen pipo wen wan marray and wen some husband and wife dey get abat marrage naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say for de lass days so life go had but God no go forget hin pipo wen trust am.

View Details

De kain tin dem wen fit make pesin get sikness wen fit ton hin head naim bi watin doktor put mout today.Today message of Hope say de time wen we dey now get plenti tin wen go make us worri but God say make e trust am and make e no worri

View Details

De kain tin wen go happun to de pikin wen dey dodge commot for skool and de wahala wen fit forlow am tomoro naim bi today tork.Today message of Hope say one tin we go do for dis time wen we dey so na say we go put God fess and waka as God want.

View Details

Husband and wife wen wan get trust for deir marrage go respet ish odar make dem no jam ish odar for de house.Today message of Hope dey tell us de kain fast wen God want make we fast wen hawa life go take beta for dis time wen we dey so.

View Details

Today praya na for all hawa pipo for radio wen de sik and all de pipo wen get asident make God make dem well.De message of Hope dey tell us say de time wen we dey now na de time to take commot hand for sin make we Holy as God Holy.

View Details

Today fess song say make we let hawa light shine for hawa kona and de sekond song for Edo and Urhobo say Na God bi God.De message of Hope say make hawa life dey shine as we dey do beta tins wen go make pipo see Jesus for hawa life.

View Details

Today story na de widow story wen dey stay for Zarephat wen give Elijah food and how God take do miraco wen hin small food no finish.De message of Hope dey tell us say eni pesin wen don give Jesus hin life na winna bicos Jesus don win for am.

View Details

De kain way wen husband and wife go take tork wen one pesin dey do pass de sekond pesin naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say de waka we dey waka wit Jesus bi like pipo wen dey run so make we run de run wen we go take win heaven.

View Details

De diffren kain sikness wen fit do pesin for hin head wen fit ton hin brain and make pesin krase naim bi today tork.Today message of Hope say as we dey forlow Jesus waka we go come dey waka as Jesus waka and we go bi pipo wen go forlow Jesus go heaven

View Details

De tin dem wen dey make pikin dem dey play wayo dey run commot for skool naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen we give Jesus hawa life, God go come give us new dress wen bi hin righteousness wen we go take forlow am waka.

View Details

Make husband and wife dey tork deir mind and if rezin dey wen go make pesin say No, make de pesin tork No, make e no fear.Today message of Hope dey tell us say wen we give Jesus hawa life finish, we go musto grow dey bi like Jesus evryday.

View Details

Today praya na for hawa pipo for radio wen dey sik and de one dem wen get asident make God make dem well.De message of Hope dey tell us say wen we give Jesus hawa life, Jesus go give us new hat wen we go take do watin e tork and we go come resembo Jesus.

View Details

Today fess song say we don tell hawasef say we go forlow Jesus and de sekond say we bi new pipo bicos Jesus don give us new life.De message of Hope say make we no forlow de world dey sin but make we bi like de tiree hebrew boys dem wen stand for God.

View Details

Jesus desipo wahala for riva as Jesus dey sleep for de boat and how Jesus come make de riva kwayet naim bi today lesin.Today message of Hope dey tell us say na hawa mind God for dey forlow us tork so make we no let yama-yama tin enta hawa mind

View Details

De kain way wen we go take tork to ish odar as husband and wife wen wahala dey de house wen house no go kash fire naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say pesin wen dey forlow God waka go arrange hin mind make hin mind bi like Jesus mind.

View Details

Watin pesin wen get stress sikness go do and de kain food wen e go chop take manage de bodi naim bi today tork.Today message of Hope dey tell us say we musto get fait as we dey forlow God waka bicos na fait we dey take make God happi.

View Details

De kain way wen pikin dem dey do wen dem take dey dodge skool and how dat mata bad riesh naim bi today tork.Today message of Hope dey tell us say if we tru-tru wan forlow God waka we musto commot hawasef from sin and do watin go make God happi.

View Details

Today lesin for de trust mata na say make husband and wife no dey hide sometin from ish odar bicos sekret dey scata trust.De message of Hope dey tell us say wen we forlow God waka as Enoch forlow am waka, God go take us go Heaven wen e come.

View Details

Today praya na for de pipo wen tanka fire bon for Ologbo, de family of pipo wen die for de fire and pipo wen dem rape.De message of Hope dey tell us de waka wen we musto waka if we tru-tru wan go Heaven wen Jesus come.

View Details

Today fess song dey tell us say na only Jesus bi de name wen we go take save and the sekond song say we bid pass pipo wen win fite.De message of Hope dey tell us say na Jesus bi de road wen we go take go meet God bicos naim die for we.

View Details

Watin Jesus do for de krase man wen get plenti demon wen de man con take well con tell odar pipo abat Jesus naim bi today story.De message of Hope dey tell us say na we no dey do watin God tork wen dey open door give devo to bring bad tin come hawa life.

View Details

De kain sikness dem wen fit enta pikin bodi wen e dey do dis LGBT naim bi hawa today tork.Today message of Hope dey tell us say if we tru-tru wan know watin God tork, we go siddon make God tish us and den we go do watin God tork.

View Details

De tin wen husband and wife go do wen dem go take put trust for hinside deir marrage naim bi today mata.Today message of Hope say na Jesus bi evrytin for hinside de Bybbo and as we dey pray dey read de Bybbo, de Holy Spirit go tish us watin God tork.

View Details

Make mago-mago and wuru-wuru no dey de elekshion dem go do for Bayelsa, Imo and Kogi pipo naim bi today praya.De message of Hope dey tell us say na Jesus dey de senta of de Bybbo and na only de Holy Spirit fit tish pesin watin God tork for hin word.

View Details

Today fess song say na God "Alfa and Omega" and de sekond song "Beulah land" dey tork abat Heaven wen we go go.De message of Hope dey tell us all de beta beta tin dem wen we go get bicos we give Jesus hawa life.

View Details

Today fess song na de hymn "Only Remembered" and de sekond song na anoda hymn wen bi "I'd rather have Jesus.De message of Hope dey tell us say notin wen we get for dis life go fit carri us go heaven except we give Jesus hawa life.

View Details

Today story na de story of one woman wen hin husband don die and den hin only pikin come die too but Jesus come bring de pikin come life again.De message of Hope say even hawa life no bi sometin wen we go put hawa hope bicos we no know wen we go die.

View Details

De mata of who go maintain each odar for hinside marrage as God arrange am naim bi today mata.Today message of Hope say friend wen pesin get no bi sometin wen go fit carri pesin go heaven bicos friend dey fail friend.

View Details

Watin Stress sikness bi and watin dey make pipo get am naim bi today mata.De message of Hope dey tell us say make we trust God with hawa tomoro bicos no bi we get tomoro and watin go happun tomoro no bi hawa mata.

View Details

De ogbonge wahala wen dey de world today wen oyibo dey call LGBT, watin dis LGBT bi naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say make we no put hawa hope for de moni wen we get bicos moni no go fit take us go heaven.

View Details

Trust naim bi de foundation for marrage and husband and wife musto get trust for each odar if deir marrage go last.De message of Hope say make we no dey put hawa trust for de promise wen pesin go promise us bicos human being dey fail for deir promise.

View Details

Today praya na make God epp us stop all de kidnapping wen dey happun and make God epp de family wen deir pipo dey for kidnapa hand.De message of Hope say make we no take hawa life take porsue fine bicos God no go look fine take carri pipo go heaven.

View Details

Today song dem na hymn and de fess one na "Leaning on de Everlasting Arms" and de sekond one na "Higher Ground"De message of Hope dey show us exampo of pipo wen pray wen God ansa deir praya wen we too go look take pray make God for ansa hawa praya.

View Details

Na anoda woman tori wen ans God for sometin wen God give am yanfu-yanfu pass watin e ans naim we tork today.Today message of Hope dey tell us watin dey happun wen dey make God no de ansa some kain praya wen we dey pray.

View Details

God wen make marrage give us wan dey hinside hawa marrage dey epp us so make we dey do watin God tork for hin word so dat God go dey hawa marrage.De message of Hope dey tell us say make we believe say God dey hear hawa praya and e gp do watin we ans am,

View Details

De kain food wen we fit chop wen go make hawa bodi balance and wen go let us fit sleep well wen we chop am for evening naim bi today tork.Today message of Hope dey tell us say wen we pray, make we bi like Jesus wen pray make God epp am do watin God want.

View Details

De kain tin wen friend bad friend go dey do as dem dey forlow you waka wen you go take know say dem no bi beta friend naim bi today mata.Today message of Hope say enitin wen we want make God do for we, we musto ans God by hawasef as we dey pray.

View Details

Today story na story of husband wen still dey maray hin wife even wen e know say hin wife dey sleep with odar man dem for hinside hin house.De message of Hope dey tell us say we musto put fait join hawa praya if we want make God ansa hawa praya.

View Details

Today praya na for hawa obodo Naija, make God give hawa leda dem sense wen dem go take do deir work make kontree for beta.De message of Hope dey tell us watin praya bi, how we sorpose pray and watin praya dey do for hawa bodi

View Details

Today fess song say ake hawa fait big pass hawa fear and de sekond song say hawa epp dey for God name.De message of Hope say na God fit epp us for eni wahala so make we give Jesus hawa life and make we dey tell God hawa wahala.

View Details

Today lesin na from de woman wen do good give Elish house and God come give am pikin wen e tink say e no go get for life again.De message of Hope dey tell us say God get resin why e make me and you and why we still dey here.

View Details

De kain tin wen pesin wen maray or wen wan maray sorpose get for mind wen no go let hin marrage scatar naim bi today tork.Today message of Hope say if we wan commot for wahala wen life go take stone us, we must bi pipo wen fit kontro hawasef.

View Details

De beta beta tin wen watar dey do for hawa bodi wen we drink am as we sorpose drink am naim bi today mata.Today message of Hope say make we no fear bicos God no want ake we fear but make we carri hawa troubo and wahala give Jesus.

View Details

De kain tin wen se sorpose see for de pesin life wen we want take make hawa friend naim bi today mata.Today message of Hope say wen wahala many, make we rememba say God love we naim make Jesus die for we and we go win wen we give Jesus hawa life.

View Details

Today story na de story of husband wen maray hin wife pikin, give am belle, bon and hin wife no know.De message of Hope say wen life take wahala take stone we, make we get fait like blind Bartimaeus, call Jesus and e go save us.

View Details

Today praya na for God to commot hawa pikin dem from dis man maray man and woman maray woman wahala.De message of Hope dey tell us say wen we get wahala and ebi like say God don forget we, make we get fait and know say God redi to come epp we.

View Details

Today fess song say Jesus dey come and de sekond song say now wen life get as e bi naim we need Jesus pass.De message of Hope dey tell us say God no dey forget hin pipo and hinside de wahala we we dey as we call am e go dey deer.

View Details

De woman for today story teach us say wen we get fait and put hawa mind for watin we dey ask God to do for we, God go do am.Today message of Hope say de only pipo wen go fit stand wen tomoro wahala come na de pipo wen dey do watin God tork for hin Word.

View Details

Fruit na sometin wen dey make hawa bodi balance and strong kakaraka so make we dey plan to chop fruit as we dey plan to chop food.De message of Hope dey tell us say make we dey pray and dey shine hawa eye so dat we no go fall hinside temtashion.

View Details

No pesin dey dis world wen no get friend but de beta rizin wen sorpose make pesin get friend naim bi today mata.Today message of Hope tell us say if we tru-tru say God na numba one for hawa life, we go dey do watin konsign God fess for hawa life.

View Details

Today lesin na say make wife wen get moni no take hin husband do boyi-boyi bicos de man fit vex do dem bad tin.De message of Hope dey tell us say wen we do watin God commandment numba 1 go reach 4 tork, naim bi say we dey put God fess.

View Details

Today praya na for all de pipo wen bad doktor don take wayo commot deir intestines and kidney, make God heal dem.De message of Hope dey tell us say make we put God fess for hawa life and for evrytin wen we dey do.

View Details

Today fess song na "Ancient Words" and de sekond song na "As de Deer"De message of Hope dey tell us say de korret beta fasting wen we sorpose do na de one wen we go take pray so dat God go epp us commot hand from sin.

View Details

De story of de prophet wife wen hin husband die and how pipo wen hin husband boro dier moni want korlet hin pikin den and watin God do for am naim bi today lesin.Today message of Hope say make we no give anoda pesin de praise we sorpose give God.

View Details

Say wahala dey for marrage na noma tin and wen husband and wife sabi say sorry and dem dey forgive ish odar dat marrage no go scatar.De message of Hope say make we put hawa trust for hinside God and make we believe God word bicos God no dey lie.

View Details

De beta food wen pesin go chop wen hin bodi go take balance and well naim bi today mata.Today message of Hope say make we no bi like Israel pipo wen no like de food wen God give dem but make we chop God word as pesin dey chop beta food.

View Details

De kain pesin wen we fit call hawa friend and watin we go look take make beta friend naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say make take beta eye take look de Word of God bicos na God word naim bi de life wen we get.

View Details

De lesin wen we fit learn from de wahala wen dey hinside Yul and May Edochie marrage wen won scatar de marrage naim bi today mata.Today message of Hope say make we no bi like Israel pipo wen deir long troat for meat make dem die.

View Details

We tank God for peace afta de tribunal say Tinubu win and we pray make God still put hin hand for de sekond court wen e start.Today message of Hope say make we put God and de tin wen konsign God first for hawa life and God go bless us yanfu-yanfu

View Details

Today two song dey tell us say make we forlow Jesus waka bicos as we dey forlow an waka, hawa lite go dey shine.De message of Hope dey tell us say de tin wen we dey do, de word wen we dey tork, na all of dem bi hawa lite wen god want make e shine.

View Details

Today kweshion na de kweshion wen Jesus ask Bartimaeus and today Jesus dey ask me and you de same kweshion.De message of Hope dey tell us say God make us make we bi winna bicos na only pipo wen win naim o enta heaven.

View Details

De lesin today na say de word wen we dey tork and how we tork am pass for scatar hawa marrage or e fit make de marrage stand.Today message of Hope say all of us dey run and na heaven we dey run go so make we no let enitin make us no run well.

View Details

De tin we we go do if pesin chop food wen no good for hin bodi and sikness come enta naim bi today mata.Today message of Hope say make we forlow Jesus waka and make we waka as Jesus waka wen e dey here, na dat bi watin God want.

View Details

Some kain tin wen pikin musto put hin eye if e tru-tru want get beta work wen e go work tomoro naim bi today mata.De message of Hope dey tell us say wen we give Jesus hawa life, God go give us new dress wen we go take fit dey wey God dey.

View Details

De mata of wife wen take kane flog hin husband naim bi de mata wen we tork today.Today message of Hope dey tell us say we sorpose grow as we dey forlow Jesus so dat we go come bi like Jesus.

View Details

Today praya na make God give family moni bicos skool don start and family need moni now to take do watin dem go do for deir pikin.De message of Hope say we must give Jesus hawa life so dat God go give us new hat wen we go take get beta karacta.

View Details

Today two songs na songs of praise wen dey tell us say make we bless hawa God wen bi big and mighty God.De message of Hope say de numba seven lesin for Moses life bi say God sabi favour and bless hin pipo and e get pawa take commot dem from wahala.

View Details

De work wen God give woman as wife for de marrage naim bi today mata.Today message of Hope for de numba sic lesin for Moses life bi say make we no sidown yakata say hawa life don finish but make we get up do sometin.

View Details

Watin Tetanus sikness bi, how pesin dey take get am and watin pesin fit do make e no get am naim bi today mata. De message of Hope say anoda lesin for Moses life bi say nobody dey fit hide from God; you no fit hide yorsef and you no fit hide yor sin.

View Details

De kain tin dem wen hawa pikin dem sorpose know if dem tru-tru wan choose beta work wen dem go work tomoro. Today message of Hope say de numba tiree lesin for Moses life bi say some time pipo no go salote you for de good wen you do dem.

View Details

De tin wen husband and wife go fit do to take commot de suspet wen dem dey suspet each odar from deir marrage. Today message of Hope say anoda lesin from Moses life bi say all de blessing wen God give us na make we for share am with odar pipo.

View Details

Today praya na for de family dem wen pipo for dey sick, pipo die. moni mata wen skool wan start so and proteshion. De message of Hope tell us say make we bi like Moses Mama wen see say hin pikin na beta pikin and e hide am so dat Pharoah no fit kill am

View Details

Hawa fess song say make God hold hawa hand and de sekond song say for de time wen we need now, we need Jesus make e save we. De message of Hope dey tell us say dis like na race, na run we dey run so make we run beta run so dat we go enta heaven

View Details

Wen we love hawasef sotay we no con dey fit love odar pipo den hawa love no bi beta love and Godno go happi. De message of Hope dey tell us say de love wen we get for hawa nebor na one tin wen dey show say we bi kristian.

View Details

Wen husband and wife do de work wen God give dem for hinside marrage and dem forlow God, deir marrage go stand. Today message of Hope dey tell us say make we no let fear or devo make us no pray bicos na praya go give us pawa to win devo.

View Details

De kain tin wen we fit do for pesin wen hin bodi burn bifor we go take am go hospito naim bi today advise. Today message of Hope dey tell us say wen we take God word take do hawa praya, God go ansa us shap-shap.

View Details

De rezin wen make pipo dey choose de kain work wen dem choose naim bi today mata for hawa pikin dem. Today message of Hope dey tell us say make we take bodi near God as we dey forlow am waka.

View Details

De kain tin dem wen husband and wife dey do wen dey make dem dey suspet each odar main bi today mata. Today message of Hope dey tell us say bifor Jesus go come bad tin go full de world but God grace plenti yanfu-yanfu to commot pipo from sin.

View Details

Husband wen dey lie given hin wife go make hin wife dey suspet am, na so to wen wife dey lie give hin husband. De message of Hope dey tell us say God grace plenti reach to commot us from sin and to give us pawa to take waka with God.

View Details

Today fess song na Emmanuel, God dey with us and de sekond song na de hymn Abide with me. De message of Hope dey tell us say God dey with us and e stand gidigba for us so no shaking, if we commot sin for hawa life.

View Details

How woman go take love all hin pikin dem de same de same so dat hin pikin dem no go get kata-kata naim bi today mata. De message of Hope dey tell us say bicos Jesus don waka de road we dey waka now, naim go fit epp us to forlow God wel-wel.

View Details

If marrage go reach evening, de husband and wife go bi pipo wen no dey carri bodi but dem dey fall for each odar. De message of Hope dey tell us say na Jesus bring light come hawa life wen dey make us fit know and do watin God want.

View Details

De kain tin wen we fit do for pesin wen dey get heart attack bifor we go take am go hospito naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say e no mata de wahala wen we see for life, God get beta plan and promise for hinside in word for we.

View Details

How hawa pikin dem go take choose watin dem go learn for skool wen dem go take work tomoro naim bi today mata. De message of Hope dey tell us say wen we know say Jesus dey waka for hawa front, we go fit do watin God want make we do.

View Details

Watin dey happun for marrage wen husband and wife begin suspet demsef naim bi today tork. De message of Hope dey tell us say wen we know say God na tork-na-do we go get strong mind take do watin God want make we do.

View Details

Today praya konsign Nnamdi Kanu and de wahala wen dey for Ibo side bicos of am and make God stop Asari Dokubo and hin wahala. De message of Hope dey tell us say wen hawa life dey God hand e no mata de wahala wen we see, we go win.

View Details

Hawa fess song say make we trust God and de sekond song say na God bi de protector of hawa soul. Today message of Hope dey tell us say na God bi hawa beta and korret epp so make we put hawa trust for God bicos e go epp us.

View Details

Woman wen wan happi na woman wen don put hin life for Jesus hand and e dey forlow God waka and dey do watin God say make e do. Today message of Hope dey tell us say wen we give Jesus hawa life, we no go fear bicos God stand gidigba for we.

View Details

Eni marrage wen go stay reach evening na marrage wen husband and wife go for trust demsef and de ask kweshion to know. De message of Hope dey tell us say na de Holy Spirit go give us sef kontrol as we dey forlow God waka.

View Details

De kain sikness wen tetanus bi, how pesin fit take get am and watin we go do make we no for get am naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say wen we get de kain fait wen blind Bartimaus get and we call Jesus e go ansa we.

View Details

De tin wen hawa pikin dem go do to take redi for eni wahala wen dey for front as dem de waka for life naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say plenti wahala dey for life but if we get Jesus for hawa life we go win.

View Details

Mama wen bi beta mama sorpose train hin pikin dem, de boy and de girl dem well so dat dem go bi beta papa and mama tomorrow. Today message of Hope dey tell us watin de cross wen Jesus for die dey tell us abat God and de love wen God get for we.

View Details

Today praya na make God put hin hand for de eleshion mata make de jorge dem for tork true and make peace dey hawa kontree. De message of Hope dey tell us say wen we know de resin wen make God make we, we go fit get de kain fait wen God want make we get.

View Details

Today fess song say make Jesus waka for hawa front and de sekond song say God go finish de beta work wen e dey do for yor life. De message of Hope dey tell us say God want make we bi like Jesus so dat pipo go dey see Jesus for hawa life.

View Details

Woman wen get strong fait to take hold God make God for do watin e want for am na woman wen go bi happi woman De message of Hope dey tell us say na sin naim bring all dey wahala wen we get today and Jesus with hin sorri-hat con commot sin for hawa life.

View Details

De kweshion of watin we go do wen de stori wen we dey hear abat hawa husband or wife na tru naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say na only Jesus go fit save us and give us de kain peace wen go make us rest koole.

View Details

Watin we go do for pesin wen get sikness wen bi like epilepsy bifor we go fit take de pesin go hospita naim bi today mata. De message of Hope dey tell us say Jesus come die so dat we go fit bi God pikin, make we sef resembo Jesus for dis good work.

View Details

God don tesh us say rest good for hawa bodi so make we dey plan rest for hinside watin we dey do make hawa bodi for well. De message of Hope dey tell us say Jesus naim God send make e come tesh us abat God make we for know God well well.

View Details

Who bi beta mama wen we fit call mama? Watin mama go do wen go make us fit say na beta mama? Na dat bi hawa mata today. De message of Hope dey tell us say Jesus and hin papa no dey kwarel, dem bi one and God want make we sef bi one for church.

View Details

Today praya na for Niger kontree bicos soja don korlet dey kontree from de pipo wen dey rule am and wahala dey dere now. De message of Hope dey tell us say God way no bi hawa way and to forlow God waka we musto forlow hin way.

View Details

Today two song na "The LightHouse" and "Shine Jesus Shine" and de song dem dey tell us say make we let pipo see Jesus for hawa life. De message of Hope say if we tru-tru forlow Jesus, dey do watin e tork, hawa life go change and we go resembo Jesus

View Details

Woman wen wan happi na woman wen no go dey carri pipo wen do am bad tin for hin mind but e go forgive dem as God tork. Today message of Hope tell us say beta praya and wayo praya dey and if we want make God ansa hawa praya, make we pray beta praya.

View Details

If eni marrage go last, de Husband and wife musto close deir ear make dem no hear enitin wen fit scata deir marrage. Today message of Hope say if we want make God ansa hawa praya like e ansa Jesus own make we no dey pray for watin no dey God word.

View Details

De tin wen we go fess do wen sometin like fire or hot worta bun pesin bifor we go take de pesin go hospito naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say Jesus say make we shine hawa eye and pray so dat we no go enta devo trap.

View Details

De lesin for hawa pikin dem today na say God no dey change watin e say e go do, e go do am so make we trust God. Today message of Hope say wen we resembo Jesus, we no go taya to do good to pipo weda de pipo good or bad.

View Details

For hawa husband and wife mata, we learn say man musto leave him papa and mama family come join hin wife as God tork. De message of Hope dey tell us say Jesus wen die for cross show us say God love us and we too sorpose show odar pipo dat kain love.

View Details

Today praya na for hawa govment make dem for do beta tin for de kontree and for de kort mata for de elekshion wahala. De message of Hope dey tell us say make we bi like Jesus Christ wen make hin friend dem know God.

View Details

Today fess song say make we stand for God promise and de sekond song say make we get fait. De message of Hope say make we know God promise dem for Bybbo and make we take de promise dem take do hawa praya.

View Details

De kain tin wen we sorpose do for hawa pikin wen bi girl naim bi today mata Today message of Hope dey tell us say if we tru-tru wan waka with God we go let de Holy Spirit dey hawa life and we go trust God and hin word.

View Details

Make we ton hawa eye commot for de bad tin wen we do for marrage and epp hawasef to change make hawa marrage no scatar. De message of Hope say wen de Holy Spirit epp us get de kain mind wen Jesus get, we go resembo Jesus and bi God beta pikin

View Details

De tin wen we fit do wen we see say pesin hat dey pain am and e bi like say dey hat wan stop naim bi today mata. Today message of Hope say God like make we dey tork to am for praya and na de Holy Spirit dey teach us how we go take pray.

View Details

De wahala wen de wayo wen pikin dem dey do take pass exam dey cause for kontree naim bi today mata. Today message of Hope say wen dey Holy Spirit don work for hawa hat well well, we go bi pipo wen go soranda make God do watin e wan do with hawa life

View Details

As husband and wife join bodi togeda as God want, dem go get trust, dem no go dey fear and dem go know each odar well. De message of Hope say wen we let de Holy Spirit work for hawa hat, we go come know God and de love wen make Jesus die for we,

View Details

As hawa pikin dem don dey holiday, today praya na make God kip dem safe and make dem pass deir exam to enta univasiti. De message of Hope dey tell us say God give us de Holy Spirit and de chance to pray as beta blessing for hawa life.

View Details

Hawa fess song say make God out beta hat hinside hawa bodi and de sekond song say make God klin hat. Today message of Hope say Jesus tru-tru wan give us hin kain hat and e dey wait make we open de door of hawa hat make hin come hinside.

View Details

Woman wen go happi na woman wen sabi manage hin pikin dem make dem for bi beta pikin wen go let am get peace tomoro. De message of Hope dey tell us say God get special blessing for pipo wen no dey carri bodi go up.

View Details

De tin dem wen husband and wife fit do to take kip deir marrage togeda wen dem go take reach evening togeda naim bi today mata. Today message of Hope say make we resembo Jesus wen bi God but e come bi human being bicos of we and e die for we.

View Details

Watin we fit do wen pesin chop food wen rotin or wen don spoil bifor we carri am go hospita naim bi today mata. De message of Hope dey tell us say wen we get Jesus kain mind, we go do watin we sorpose do kia-kia and we no go dey carri mata go front.

View Details

De kain ojoro wen hawa pikin dem dey do for exam sometime and watin make dem dey do dis ojoro naim bi today mata. Today message of Hope say wen we get Jesus kain mind, we no go take by-force serve God but we go happi to do watin God say make we do.

View Details

De husband and wife mata today na how dem go take join bodi togeda wen dem go bi one for evrytin wen dem de do. Today message of Hope dey tell us say wen we get Jesus kain mind we no go dey fear and we no go dey do bad tins

View Details

Today praya na make God come commot all de wahala wen dey for hawa kontree wen no dey let pesin fit close eye sleep. De message of Hope dey tel us say make we get de kain mind wen Jesus get so dat we go fit resembo Jesus and do watin Jesus do.

View Details

Today two song "Jesus is coming" get de same message and dem dey tell us say e no go tay now Jesus go come again. De message of Hope say make we happi bicos Jesus go soon come and all de wahala wen we dey see today go end.

View Details

Woman wen wan bi happi woman musto get hin own handwork wen e go take get hin own moni so dat e go dey fit do tins for hinsef. Today message of Hope say we go happi wen we know say God make us well and comma or mistake no dey hawa bodi

View Details

Bybbo ves dem wen konsign marrage wen husband and wife go know and take do deir praya naim bi today mata. De message of Hope say we go happi wen we no dey get long trot for odar pipo tins and we let God blessing for hawa life belleful us

View Details

Watin we sorpose do wen food, water or eni tin wen enta pikin mout no let de pikin fit breet. De message of Hope say notin good dey hinside us but wen we let Jesus lead us as we dey forlow hin word, hawa life go come beta.

View Details

De way wen pesin go take ansa exam kweshion wen e go take pass beta pass naim bi today advise for hawa pikin dem. Today message of Hope say eni suffa wen we suffa for here no mata bicos wen Jesus come, e go take us go hin beta kindom.

View Details

De kain tin dem wen papa and mama sorpose dey pray make God do for deir pikin dem life naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say wen we get God, we go fit happi even wen we dey for hinside beta wahala.

View Details

Today praya na make God come commot all de wahala and kili-kili wen dey happun for Ibo land especially Ebonyi and Enugu. De message of Hope dey tell us say we go fit happi for hinside wahala wen Jesus dey hawa life.

View Details

Today fess song na "I have decided" and de sekond song na "Take my life", two song wen dey tell us abat how we go take bi beta kristian. De message of Hope say Jesus hawa Shephad no go let enitin do us bicos e dey protect us and e stand gidigba for us.

View Details

Hapi woman na woman wen sabi take care of hin bodi, e dey chop well, dey sleep well and e no dey carri de world for hin head. De message of Hope dey tell us say Jesus hawa Shephad no dey let us work die bicos e don give us de sabat make we take rest

View Details

De kain wahala dem wen dey dey de marrage wen husband dey one kontree and hin wife dey anoda kontree naim bi today mata. Today message of Hope say God want make we dey rest naim make am give us sabat day to rest even bifor sin enta hawa life.

View Details

De tin wen we fit do wen sometin wen pesin dey chop come hook for hin troat and e no fit breet naim bi today mata. Today message of Hope say Jesus wen bi hawa Shephad naim fit give us new life and come make de tin wen devo scatar for hawa life new again.

View Details

De tin dem wen hawa pikin dem go fit do to take redi for exam and to take pass deir exam naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say bicos Jesus na hawa Shephad, we no go hungry. Jesus go give us de food wen good for hawa bodi.

View Details

God don give Papa and Mama pawa wen dem go take pray for deir pikin and God dey ansa de praya wen papa and mama dey pray for deir pikin. De message of Hope dey tell us say bicos Jesus na hawa Shephad, e go deliva we commot for eni danger.

View Details

Today praya na for de pipo wen baptise for de Numan konvenshion make God epp dem to know Jesus more more. De message of Hope dey tell us say Jesus naim bi hawa shephad and e go do evrytin for us wen we go take bi beta kristian.

View Details

Hawa two song "it is well" and "it is so" dey tell us say no mata watin happun, make we trust God bicos if e tork am, e go doam. De message of Hope dey tell us say wen we trust God word and do watin God say make we do, God go bless us.

View Details

De woman wen well na happi woman so make we no dey fear to go hospito make small sikness no come bon bad pikin for hawa bodi. Today message of Hope say wen we trust God for hinside hawa wahala, we no go come do bad tin wen no go let God hear we.

View Details

De kain wahala wen dey dey for marrage wen de husband and de wife no dey stay de same house bicos of work naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say make we dey try dey enkorage pipo wen get wahala for deir life.

View Details

De tin wen we go fit do for pesin wen wound wen blood dey commot for hin bodi bifor we go take am go hospito naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say make we no bi pipo wen go use hawa mout take kill pesin wen don dey wan die

View Details

De kweshion wen we dey ans pipo na anoda kain exam and na exam pesin dey take know watin you know. Today message of Hope dey tell us say na God naim get de pawa wen e go take commot us from eni and evry wahala wen life take stone we.

View Details

De kain karacta wen husband wen bi de pastor for hin family sorpose get and how e go dey do for family naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say for hinside eni wahala wen we see na God naim get de pawa to take commot us for de wahala.

View Details

Today praya na for all de pipo wen dey listin to hawa program wen come de Konvenshion for Numan plus de king for Numan. De message of Hope dey tell us say no mata de wahala wen we see for dis life, if we get Jesus for hawa life no yawa.

View Details

Today fess song na "Only by Grace and de sekond song na "I must work de work". De message of Hope dey tell us say say na only as we dey tell pipo abat Jesus naim dem go gree give Jesus deir life come save.

View Details

De woman wen know say God give am beta pawa wen e go take pray for hin family na happi woman. Today message of Hope dey tell us say God want make we go tell pipo say Jesus die for dem make dem and Jesus don dey redi to come take hin pipo go heaven.

View Details

De wahala wen dey happun wen husband and wife no dey stay for de same place bicos of deir work naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say God want make hin pikin dem join bodi togeda and make dem believe and tork de same tin

View Details

De kansa wen dey de place for woman bodi wen e dey take bon pikin naim bi watin doktor tork put today. Today message of Hope dey tell us say God want make hin pipo dey tork de same tin bicos na one God and one Bybbo naim we get.

View Details

Watin exam bi and watin make hawa pikin dem must do exam for deir life naim bi today mata. De message of Hope dey tell us say as church don full evrywere, make we put hawa bodi for were we go for hear God korret word make we no for loss.

View Details

De work wen husband wen bi pastor for hin family sorpose do wen go make hin wife and pikin dem bi pipo wen go forlow God waka naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say make we let the Holy Spirit teach us God word.

View Details

Today praya na for hawa pipo wen de listin for hawa program for Adamawa, Bauchi, Benue and Borno state dem plus dier new govment. De message of Hope dey tell us why e bi say we get one God, we dey read one Bybbo but we no dey tork de same tin.

View Details

Today two songs na "Standing on the Promises" and There is Hope" and dis song dem dey tell us say hope dey wen we stand for God promise. De message of Hope dey tell us say wen you rememba watin God do for you yestaday, you go get hope.

View Details

Woman na pesin wen God give korret pawa to take do de plenti work wen woman dey do plus de big praya pawa wen God give woman. Today message of Hope dey tell us say praya na one tin wen dey bring hope come hawa life bicos praya na de masta key.

View Details

De wahala wen pesin wen dey drink and smoke dey bring come hin family naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say de word of God get hope for we, if we go read am and believe am.

View Details

De tin wen pipo wen bi like orobo sorpose do if dem wan get beta bodi wen fine and balance naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us wen we dey forlow beta pipo wen get fait and hope dey waka, we sef go get fait and hope.

View Details

De tin wen hawa pikin dem sorpose know bifor dem take eni pesin take do deir friend naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say make we sef get fait for hawa sef bicos we bi pipo wen resembo God and hawa fait go give us watin we want.

View Details

Na husband dem bi pastor and fada for family wen sorpose teach deir wife and pikin how to know God and forlow God waka. Today message of Hope tell us say even wen life don scatar kpata-kpata, make we get hope bicos God na God and e know watin to do.

View Details

Today praya na for hawa family, make God let moni dey, make family no scatar and make pikin dem beta pass deir papa and mama. De message of Hope dey tell us say life hard but make we put hawa Hope for Jesus wen dey come carri us commot here go heaven.

View Details

Hawa fess song na "for hin time" and de sekond song na "4 days late". De two song dey tell us say God get hin time. Today message of Hope say de tin wen God say hin go do, e go tru-tru do am even if e tay for pesin eye, God no dey late.

View Details

Hawa woman dem mata today na say make dem no dey look demsef sakam bicos God make dem fine and e put dem for fine family and world. De message of Hope tell us say make we resembo Abraham wen open hin house for pipo wen e no know and dey give dem food.

View Details

De wahala wen drink dey cause for hinside de bodi and for de family naim bi today mata. De message of Hope dey tell us say temptashion no bi sin ontil we fall for hinside de temptashion.

View Details

De tin wen dey cause de sikness wen no dey let man fit give woman belle, and watin man go do for de sikness naim bi today mata. Today message of Hope say make we resembo Abraham wen give God hin tite bicos e know say na God give am evrytin wen hin get.

View Details

De lesin for hawa pikin dem na say make dem dey forgive pipo wen do dem bad tin so dat God sef go forgive dem. Today message of Hope tell us say Abraham na pesin wen get beta sense and e use de beta sense take choose watin commot wahala for hin family

View Details

De numba 4 and 5 for de five tins wen wife dem want make deir husband do for dem naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say bicos we dey forlow God no mean say devo no go give us wahala so make we trust God and do watin e tell us.

View Details

Today praya na make God make all de pipo wen dey sick well even if de sikness na small on like malaria or na big one like stroke. De message of Hope dey tell us say as God call Abraham na so e dey call us make we forlow am so dat we too go bi God friend.

View Details

Hawa fess song wen bi Esan song na Uwenokpa Sellobula" and hawa sekong song wen bi Isoko song na "Re ro Suo Oghene" Today message of Hope dey tell us say make we rememba say God dey see watin we dey do and one day jorgement dey come.

View Details

Woman wen wan bi happi woman musto love and respet hinself so dat odar pipo go fit love and respet am too. Today message of Hope say wen we stand for God and we no let fear make us do watin we no sorpose do, God go stand for us too and bless us.

View Details

Wen pesin dey play jogba so tay de jogba enta hin blood, e go bring povati come hin family wen fit scata de family. De message of Hope dey tell us say beta blessing and promoshion dey wen we stand for God like Shadrack, Meshak and Abednego.

View Details

De sikness wen doktor dey call low sperm count wen no dey let man fit give hin wife belle naim bi today mata. Today message of Hope na abat Joseph for life for wen e stand for God no gree forlow Portifa wife sleep.

View Details

De kain book dem wen hawa pikin dem no sorpose read naim bi de lesin for dem today. Today message of Hope na abat Shadrack, Meshak and Abednego wen no gree worship image for Babylon and watin God do for dem.

View Details

Tiree of de five tins wen wife dem want make deir husband do for dem naim we tork today.De message of Hope na abat Gideon wen get strong mind, e no fear, e scatar juju shrine and de juju no fit do Gideon eni tin.

View Details

Today praya na for women dem wen get belle, make dem for bon well and pikin and mama go dey kankpe.De message of Hope dey tell us say God want make hin pikin dem dey stand for am and for watin korret like Phinehas for Bybbo.

View Details

Today fess song na "Heaven come down" and de sekond song na "I don see hapiness"De message of Hope dey tell us say as we get Holy Spirit pawa and we dey chop watin God say make we chop, we go well kankpe for hawa bodi.

View Details

De woman wen go bi happy woman na woman wen know say God love am with hin love wen no dey quench and wen no dey die lie-lie.Today message of Hope dey tell us say de pawa wen de Holy Spirit go give us na pawa wen no go let us dey fall hinside sin.

View Details

Wen pesin dey look film wen pipo for dey sleep togeda, de pesin go come dey want do watin e see for de film for hin marrage and dat na big wahala.De message of Hope tell us say na only Jesus fit give us peace for dis world wen kata-kata dey so.

View Details

De tin wen we go do to take treat pipo wen get shikin pos make e no for catch odar pipo naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen we don bon again, we musto dey read hawa bybbo, do watin God tork and pray.

View Details

De tin wen fit make hawa pikin dem no happi and how we go take know say tins no bi as e sorpose bi for hawa pikin dem naim we tork today.Today message of Hope dey tell us say de Holy Spirit pawa naim dey make we fit give Jesus hawa life come bon again.

View Details

De tin wen papa sorpose do for hin pikin wen go make hin waka with hin pikin bi de one wen e go take bi beta papa naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say de pawa wen de Holy Spirit go give us go change hawa mind and hawa karacta.

View Details

Today praya na for hawa pikin dem wen dey write deir exam to take go de next levo for deir skool.De message of Hope dey tell us say we go get pawa as Jesus promise us wen we go take do watin God want make we do.

View Details

Today fess song say na God naim get all pawa and de sekong song na only God naim make all de tin wen dey dis world.De message of Hope dey tell us say God make one day wen we go take worship am and pesin we no dey worship God for dat day no go go heaven.

View Details

Beta korret woman na woman wen sabi kwik get up bifor odar pipo wake for hin house and cook food so hin family go chop belleful.De message of Hope dey tell us say na de true wen we know abat God and wen we forlow dat true,we go free.

View Details

Today, we don see de kain woman dem wen dey forlow odar pipo husband and watin de make dem do watin dem dey do.De message of Hope dey tell us say God Law wen bi de 10 commandment naim dey tell us watin good to do and watin we no sorpose do.

View Details

De tin dem wen pesin wen get shikin pox sikness go do to take manage de sikness naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say na Jesus Christ wen bi God naim come die to commot us from sin and de devo hand.

View Details

De tin wen hawa pikin dem go fit do wen dem no go get depreshion sikness naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say as devo wahala Job for Bybbo na so e still dey wahala God pikin dem today but make we get fait and we go win.

View Details

De plenty blessing wen go dey de life of pikin wen get beta papa naim bi today mata.Today message of Hope tell us how satan and hin wahala dey enta de beta fine world wen God make and give us to stay.

View Details

Today praya na de one wen we take ask God make e put hin hand for de mata of hawa eleshion wen dey for court.De massage of Hope dey tell us say na God naim make we and evrytin wen we dey see for de world.

View Details

Today fess song na "Heavenly Sunlight" and de sekond song na "Shine Jesus Shine"De message of Hope dey tell us say make we let pipo see Jesus light for hawa life bicos na we bi de light wen God put for dis world.

View Details

De beta korret woman na woman wen dey bring good come meet hin husband as e dey work dey sorpot hin husband.Today message of Hope dey tell us say wen we give Jesus hawa old yama-yama life, e go come give us new life.

View Details

De difren kain man dem wen de waka dey go sleep with odar woman win no bi deir wife naim we tork today.Today message of Hope dey tell us say make we forlow true and Jesus naim bi de truth.

View Details

Chicken Pox na sikness wen dey come and go for hin time ane e dey put boil for pipo bodi.De message of Hope dey call us make we cross commot from de devil side wen get sin and sikness come God side wen life dey.

View Details

De kain dress dem wen hawa pikin dem no sorpose wear naim bi de mata today.Today message of Hope dey call all of us make we come back come meet God.

View Details

Beta papa na papa wen get love, sense, and moni to take train hin pikin dem and wen hin pikin go like to resembo for evrytin.De message of Hope dey tell us say God love we and na hin love wen e take die for we naim make am bi hawa big God.

View Details

Today praya na for hawa pipo wen japa go obodo-oyibo make God for save dem for all de war, water and kili-kili wen dey happun for yonda now.De message of Hope na de ansa for de kweshion of who hawa God bi and we see say hawa God naim give us life.

View Details

Today fess song na "Shout to de Nort" and de sekond song na "Work de Work".De message of Hope tell us say na de Holy Spirit naim de make us know say we bi God pikin and God get beta plan for hawa life.

View Details

God no want make man dey forlow woman wen no bi hin wife dey sleep bicos na sin wen dey bring plenty wahala come.De message of Hope tell us say na de Holy Spirit dey baptize us put for God family wen we dey take know say we bi God pikin.

View Details

De tin wen dey make food wen pesin chop no balance for hin bodi and de bodi no come strong as e sorpose strong naim bi today mata.Today message of Hope say na de Holy Spirit dey epp us pray and naim de beg God for we wen God dey take ansa hawa praya.

View Details

De kain tin wen hawa pikin dem dey forlow say na fashon wen no good for God eye naim bi de lesin for hawa pikin today.Today message of Hope dey tell us say na de Holy Spirit naim dey tell us as we go take waka make we for waka beta waka.

View Details

Beta papa go bi beta exampo for hin pikin dem as e dey forlow God waka make hin pikin dem for fit imitate am.De message of Hope dey tell us say na de Holy Spirit dey teach us as we go dey take forlow God waka beta waka.

View Details

Today praya na for Lagos state make God for commot all de wahala wen dey for Lagos state.De message of Hope dey tell us say na de Holy Spirit naim dey make we know say we bi God pikin and naim dey epp us commot sin for hawa bodi.

View Details

Today fess song na "Give me de Bybbo" and de sekond song na "Trust and Obey".De message of Hope dey tell us say de kain pesin wen God dey show hin mercy na pesin wen dey waka for God word wen bi truth.

View Details

Woman wen no get secret wen hin an hin husband get one mind na beta korret woman wen hin husband and odar pipo dey trust.Today message of Hope tell us say wen we no dey do watin God say make we do, God go commot hin mercy from hawa bodi.

View Details

De wahala wen dey for marrage wen de husband and wife bi people wen don forlow odar pipo sleep bifor dem marray demsef naim bi today mata.Today massage of Hope tell us say make if we cry go meet God like de ten lepars, God go commot hawa sin leprosy.

View Details

De tin wen we go see for pesin bodi wen no dey chop well wen we go take know say e get sikness naim bi today mata.Today message of Hope say make we no bi pipo wen dey carri shoda go up wen we come pray so dat God go ansa hawa praya.

View Details

De wahala wen dey happun for hawa pikin dem life wen dem dey look pikshure of naked pipo wen dey sleep togeda naim bi today mata.Today message of Hope tell us say wen we cry go meet God wen wahala dey hawa life, God go ansa we.

View Details

De tin dem wen God want make evry papa do for deir pikin as beta papa naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say na now wen God still dey ansa praya naim we sorpose cry go meet God wen tins no balance for hawa life.

View Details

Today praya nd for Kaduna State make God come commot all de wahala of village wen dem dey burn, pipo wen dem de kill and kidnap.De message of Hope say Jesus come to come save wen so if wahala dey make we cry and call Jesus and e go ansa we.

View Details

Today two songs "I die to myself" and "In Christ alone" dey tell us say make we put hawa life for God hand and bi like Jesus.De message of Hope dey tell us say make we forlow de road wen Jesus don show us to forlow God waka as God want.

View Details

Beta korret woman na woman wen go take hin husband pipo like hin own pipo so dat deir family go bi beta family.De message of Hope dey tell us say n only wen we get Jesus for hawa life and we dey do watin hin word tork naim we go fit win devo and sin.

View Details

De wahala wen dey enta marrage wen de pipo wen marray forlow odar pipo sleep bifor dem marray naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say Jesus come dis world with hawa kain bodi come show us how we go take fit forlow God waka as God pikin.

View Details

De mata wen konsign food wen we dey chop and watin dey make pipo no chop beta food naim bi today mata.Today message of Hope tell us say as human being Jesus no sin wen e come dis world and if we forlow God waka as Jesus waka we no go sin.

View Details

De beta music wen God want make we dey put ear and sing na de one wen go put hawa mind for God and heaven. Today message of Hope say make we know Jesus and hin pawa bicos na dat one go make us bi beta kristian wen go fit believe God word.

View Details

De kain man wen pipo fit call papa and de tin wen de man sorpose do to be korret papa naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say make we know Jesus, do watin Jesus tork and waka as Jesus want make we waka.

View Details

Today praya na make God come put hand stop de wahala wen dey happun for Benue state wen dem dey take kill pipo and burn village kpata-kpata.De message of Hope dey tell us say to forlow God waka, you go believe an as Abraham believe God.

View Details

Today two song na "I have decided" wen bi "I don decide" and "Jesus is coming" naim bi "Jesus dey come".De message of Hope say all de tin wen sorpose happun bifor Jesus go come don happun finish so make you give Jesus your life today.

View Details

Korret beta woman na woman wen sabi arrange hinsef for evry-evry so dat hin husband no go shame wen pipo know am as de woman husband.Today message of Hope say na only pipo wen deir life dey Jesus hand go save wen God go come burn dis world with fire.

View Details

De way wen husband and wife go take fit tork beta tork for marrage wen kata-kata no go boss out naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say for hinside all de wahala wen dey de world, make we put hawa hope for Jesus.

View Details

De tin wen pipo go do make dem no get siku-sell sikness and watin pipo wen don get am fit do make dem no carri die naim bi today mata.Today message of Hope tell us de dress wen God give us make we take fite devo and win am as Jesus win am.

View Details

Joseph life tish us say de tin wen you do today go meet you tomoro and de advise for hawa pikin na make dem bi like Joseph.De message of Hope dey tell us say we go fit dodge devo wahala if we put hawa life for Jesus hand.

View Details

De kain karacta wen beta friend sorpose get naim bi today mata and make husband and wife bi beta friend for deir marrage.Today message of Hope dey tell us say bicos God enemy wen bi devo de waka de scatar de good good tin wen God make.

View Details

Today praya na make God make husband dem bi beta husband and papa, make mama bi good wife and mama and make pikin dem too bi good pikin.De message of Hope na God ansa for de kweshion wen konsign why bad tin de happun for hawa life.

View Details

Today fess song na "Behold" wen mean "Look" and de sekond song na "Great is thy Faithfulness" wen mean say "God dey gidigba".De message of Hope dey tell us ay make we no dey get doubo mind for God mata bicos God na tork-na-do, if e tork am, e go do am.

View Details

Korret beta woman sabi make hin house fine and pipo dey like to come hin house bicos evrytin dey as e sorpose dey for de house.De message of Hope dey tell us say make hawa fait no dey shake but make we hold God and God go do watin e tork for hawa life.

View Details

De wahala wen dey marrage bicos of tork wen one pesin for de marrage no sabi tork and watin we fit do for de mata naim bi tork tork.Today message of Hope say God stand gidigba for hin pipo today as e stand for hinside fire for Babylon with hin pipo.

View Details

De sikness wen dey dey de blood and wen no dey let pesin get beta blood wen plenti reach for bodi naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say God dey do watin e tork say e go do and e no get eni promise wen God tork wen e no do.

View Details

De lesin wen dey David stori wen e take korlet Uriah wife come kill uriah and how dat sin bring plenti wahala come David family naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say as we dey believe God word, hawa fait go dey grow.

View Details

De tin tin wen God want make husband and wife do wen deir marrage go take stand gidigba naim bi today tork.Today message of Hope dey tell us say fait na watin all of us must get if we want forlow God waka and if we want make God happi.

View Details

Today praya na for de praya rekwest wen we get from hawa pipo wen say make we pray make dem well, make dem fit go deir house and odar rekwest dem.De message of Hope dey tell us say God word get pawa wen go fit change hawa life.

View Details

Today two songs "Where could I go" and "Victory in Jesus" dey tell us say na only Jesus we go fit run go meet bicos na him win devo for we.De message of Hope show us pipo for Bybbo wen bi true kristian wen we go fit resembo.

View Details

Beta korret woman na woman wen sabi cook beta food give hin husband and pikin, dem dey chop belleful and deir bodi de strong kakaraka.De message of Hope tell us say true kristian na pesin wen resembo Jesus for hin karacta.

View Details

De way wen husband and wife go take do moni mata wen moni no go scatar deir marrage naim bi today tork.Today message of Hope dey tell us say true kristian na pesin wen go see God resurecshion pawa for hin bodi now and wen Jesus come again.

View Details

De tin wen dey make pesin faint, how we go take know if pesin wan faint and watin we go do if pesin dey faint naim bi today mata.Today message of Hope tell us say true kristian na pesin wen Jesus don carri sin and all sin load commot for hin life.

View Details

De lesin for hawa pikin dem today na make dem no carri do bicos de tin wen dem do today go dey wait for dem for front tomoro.Today message of Hope tell us say true kristian na pesin wen go read hin Bybbo and e go dey do watin God tork for de Bybbo.

View Details

De kain marrage wen God want and watin we sorpose do for hinside de marrage naim bi today mata.Today message of Hope tell us say true kristian na pesin wen know say na only Jesus fit save am and e give Jesus hin life make Jesus bi hin oga kpatakpata

View Details

Today praya na make God epp make hawa program dey fit reach pipo wen dey listin and make God torsh de pipo hat make dem convat.De message of Hope dey tell us de kain pipo wen bi true kristian as Bybbo tork.

View Details

Hawa fess song na "He leadeth me" wen mean say na God dey lead us and de sekond one na "I surrender" wen mean say we sorranda.De message of Hope say God plan na say we go bi hin pikin so make we commot hawa hand from sin and make we near God.

View Details

Woman wen bi beta korret woman na woman wen pipo no go fear for moni mata and hin husband no go dey hide moni bicos of am.De message of Hope say if we tru-tru want make God plan happun for hawa life, we go trust God and do watin God tork.

View Details

Watin we go do to take commot de wahala dem wen we dey see for marrage today naim bi hawa mata.De message of Hope dey tell us say God still dey tork and if we lisin well well we go hear hin voice.

View Details

Watin pesin go do make e no get de sikness wen dey happun if pesin no dey shit as e sorpose shit naim bi today mata.De message of Hope dey tell us say na de Bybbo dey tell us God plan for hawa life so make we read and do watin God tork for de Bybbo.

View Details

Eni pikin wen wan do korret tin must dey read and do watin de Bybbo tork bicos na only God fit tell us watin good to do.De message of Hope dey tell us say if we do watin God word say make we do, na so we go take do watin dey God plan for hawa life.

View Details

Hawa praya today konsign watin dey happun wen no dey let pipo hear hawa program for sometime now.De message of Hope dey tell us say we no just fall from heaven, na God make us and God get beta korret plan for hawa life.

View Details

Today fess song na "Ancient Words" and de sekond song na "Nearer my God to Thee"De message of Hope dey tell us say make we commot enitin wen bi sin wen no go let us go heaven even if dat tin na hawa eye or hand.

View Details

Who bi beta korret woman wen fit resembo de woman wen dey Proverbs 31 naim bi today mata.De message of Hope dey tell us say good and bad tin na for hawa hat e for dey start and sin wen dey hawa hat na sin even wen we neva do am.

View Details

Husband wen sabi epp hin wife and dey try to resembo Jesus for watin Jesus do wen e dey here na husband wen bi beta head.De message of Hope dey tell us say wen we and anoda pesin get wahala, make we no kip enimi but make we setto de kwarel kwik kwik.

View Details

De many tins wen dey let pesin no fit shit and odar sikness wen fit happun to pesin wen no shit.Today message of Hope dey tell us say wen we vex make we no let de vexnation tay and make we no hate and plan revenge bicos dat one na sin.

View Details

De lesin for hawa pikin dem today na say God no dey change so we go trust watin e tell us.Today message of Hope dey tell us say de waka wen we dey forlow God waka must beta pass de waka wen de Farisee for Jesus time forlow God waka.

View Details

Wen kaka-kata dey, tiree tins wen de husband go fit do to take setto dey kata-kata and bring peace come hin house naim bi today mata.De message of Hope dey tell us say Jesus say make we do all de tin wen God tork for hin commandment.

View Details

Today praya na for all de elekshion case for court, for healing for pipo wen wound and konfot for pipo wen deir pesin die.De message of Hope dey tell us say God Law still dey gidigba and Jesus come show us how we go take kip de Law.

View Details

Today fess song na "love yor neibor" and de sekond song na de hymn "higher ground".De message of Hope say de pipo God go bless go bi pipo wen sabi do for odar pipo, de tin wen dem want make pipo do for dem.

View Details

Woman dem wen no dey chop beta food bicos dem wan get figor 8 to take wear beta dress and make man for like dem go fit get bad sikness. De message of Hope say beta life wen wahala no fit scatar bi say we build hawa life for Jesus de Rock and hin word.

View Details

Beta man wen bi de head of hin wife go bi klin man wen no dey do enihow but e sabi respet hinsef for aria.De message of Hope say na two road naim dey dis life and na de pipo wen dey waka for de small tin road naim God dey bless.

View Details

De sikness wen konsign pipo wen no dey fit shit and watin dey make pesin get dis sikness naim bi today mata.Today message of Hope say make we dey do de small small tin dem wen God put for hawa hand and God go bless us and give big tins.

View Details

Make hawa pikin dem no put deir hand for dis kwik moni madness wen dey make some pipo dey deceive odar pipo dey tif deir moni.Today message of Hope say God go bless us wen we let Jesus light shine for hawa life so dat odar pipo go come forlow Jesus

View Details

De kain tin dem wen husband go fit do to take setto wahala wen hin and hin wife get for deir marrage.Today message of Hope say God go bless us if we bi like salt and we dey let hawa life make odar pipo life beta and sweet

View Details

Today praya na make God give us hawa true president as court dem go siddown jorge de case dem wen konsign de elekshion dem.De message of Hope dey tell us say God go bless all de pipo wen don suffa plenty suffa bicos dem dey forlow and serve Jesus.

View Details

Today fess song na "Forgiven", God don commot hawa sin and de sekond song na "In Christ Alone", only Jesus fit save us.De message of Hope dey tell us say we we give Jesus hawa life e go commot hawa hat of sin come give us new hat to take forlow God waka.

View Details

De kain artificial hair wen women dey sew for deir head today na watin no good for God eye.Today message of Hope dey tell us say unless we give Jesus hawa life make de Holy Spirit enta hawa life and we come born again, we no go fit forlow God waka

View Details

Beta husband wen bi korret head go dey put hin family fess bifor odar pipo and e go bi man wen sabi respet hinsef.De message of Hope dey tell us say e no get as sin big reach, God go forgive if we confess an and ask for hin forgiveness.

View Details

De tin wen we go do take sorport hawa family memba dem wen dey fine pikin naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say make we no sin but if we sin make we confessam and God go forgive us.

View Details

Make hawa pikin dem no sin, but if by mistake dem sin, God go forgive if dem Konfess and e go commot de sin and e no go rememba am again.Today message of Hope say true repentance na say wen we sin and konfess am we no go do dat same sin again

View Details

De kain tin wen dey make husband and wife dey get kata-kata for deir marrage naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us watin we go do wen we go take get de kain fait wen Abraham hawa papa get wen God take call am hin friend

View Details

Today praya na de one wen konsign de elekshion wen we just do make God no let bad pipo go change enitin for de elekshion wen fit bring wahala.De message of Hope dey tell us say we need fait to take waka dis waka wen we wan forlow God waka as Kristian.

View Details

Today fess song "There is Hope" say "Hope dey" and de sekond song "More than Conquerors" say "We win pass pipo wen fite".De message of Hope say make we no dey worri bicos as God change Job stori come giam beta life na so God go change hawa stori.

View Details

Weda God want make we dey put all de tins wen dem dey call make up for hawa bodi and face naim bi hawa mata today.De message of Hope say wahala dey wen satan go give pipo wen want forlow God but if we suffa bicos of God, God go save us las-las.

View Details

Husband wen bi head for hin family go bi pastor for hin family wen go pray for hin family make de family for no scata.De message of Hope say wen we tru-tru take fait stand we go bi like Joseph wen no go sin and go do watin God want even if we suffa.

View Details

De tin dem wen fit happun for man bodi wen no go let am fit give hin wife belle naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen we believe God word and dey do watin God tork, we no go dey worri bicos we know say God dey hawa side.

View Details

Today advise for hawa pikin dem na make dem no smoke, chop of drink yama-yama tin wen fit spoil deir bodi bicos deir bodi na God house.De message of Hope dey tell us say de life wen we get as God pikin na God life so we no sorpose worri.

View Details

De lass two commandment na advise make husband dem no take de bad word wen deir wife dey tork and make deir bad karacta no let dem no do good tin for dem,Today message of Hope dey tell us say make we no worri bicos God don bless us yanfu-yanfu.

View Details

Today praya na for all de pipo wen dey Turkey bicos of de earthquake wen scata deir ground kill many pipo.De message of Hope dey tell us say make we no worry bicos God naim get hawa life and e know watin e go do wen we dey hinside wahala.

View Details

Hawa fess song say make God klin hawa hat and de sekond song say we musto do de work wen God send we for daytime.De message of Hope say na now now wen we get life so naim we sorpose accept Jesus bicos no bi we get tomoro and Jesus go soon come.

View Details

Weda God want make we dey wear earring, ring, and all dos kain tin dem wen we dey wear today naim bi de mata wen we tork.De message of Hope dey tell us say Jesus die to commot us from sin so wen we sin make we repent so dat we no go miss heaven.

View Details

Husband wen want to maintain hin posishion as head go bi man wen no dey carri odar woman and wen trust hin wife.De message of Hope dey tell us say make we bi pipo wen dey pray like Daniel for bybbo so dat we no go fall hinside devil trap.

View Details

De tin wen fit make woman wen get husband, dey sleep with hin husband as e sorpose sleep and e no get belle naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say bad tin full de world, but wen God pipo pray God go ansa and e go change hawa kondishion.

View Details

De way wen hawa pikin dem go take commot for de wahala wen no go want make dis year beta for dem naim bi today mata. Today message of Hope say one big truth wen we go take save bi say we go sabi pray de kain praya wen God de ansa shap-shap.

View Details

De commandment numba 6 go reach 9 wen husband go obey for hinside marrage make hin marrage for sweet naim we tork today.Today message of Hope say make we shine hawa eye make we for no fall hinside de sin trap wen devil de set for God pikin dem.

View Details

Hawa praya na for de elekshion wen go happun for satorday make God put hin hand make evrytin go siriri-werere/De message of Hope dey tell us say Jesus Christ e die make we for no die for hawa sin but make we for get etana life wen God dey give.

View Details

Hawa fess song say make we worship God and de sekond song say make we and hawa family dey pray and serve God togeda.De message of Hope tell us say wen we dey fear make we rememba say wen Ezra fear e pray and God ansa so make we sef pray and God go ansa.

View Details

De mata of woman wen no sorpose wear man klot and de kain klot wen woman go fit take sew hin dress naim bi hawa mata today.Today message of Hope tell us as God take fite de kontree wen wan forlow Israel fite bicos King Hezekiah pray.

View Details

Husband wen bi beta head go get strong belief wen go kontro watin e dey do, e no go bi wayo pesin and e go sabi respet hin wife.De message of Hope tell us as Elijah take pray and God take fiya take ansa am and if we sef go pray God go ansa.

View Details

De tin wen doktor dey take epp woman make dem no carri get belle naim bi de mata wen we tork today.Today message of Hope let us know say e no get pesin wen God no fit ansa hin praya. King Solomon pray and God ansa hin praya

View Details

Today mata na de fess five commandment for marrage wen husband dem go do if dem want make deir marrage good.De message of Hope dey tell us say de God wen ansa Hannah praya wen e take born Samuel go ansa we if we pray.

View Details

Today praya na make God commot de new moni and petrol wahala for de kontree and give Buhari sense.De message of Hope dey tell us say de God wen ansa Moses praya take give Israel sweet watar go ansa we if we pray.

View Details

Hawa fess song na "God Law" and de sekond song na "Repentance".De message of Hope dey tell us say God want make we commot hand from sin and make we Holy bicos hin don make us Holy.

View Details

De kain dress wen woman dem sorpose sow and wear as God pikin naim bi de mata wen we put mout today.Today message of Hope dey tell us odar tin dem wen we go do as God pipo wen we go take forlow God waka beta waka.

View Details

Sometin wen wife dem want make deir husband dey do to take show say na dem bi de head of de family naim we tork today.De message of Hope tell us some kain tin dem wen God want make we know and do so dat hawa waka with God go bi beta waka.

View Details

De kain epp wen papa and mama plus techa go fit give pikin wen no too sabi buk wen go make am come sabi buk.Today message of Hope dey tell us de tiree tin wen God want make we do if we wan go Heaven.

View Details

Tiree tins wen husband go do wen go make hin marrage tanda gidigba and hin family den hapi.De message of Hope dey tell us say wen we forlow God and do watin God tork, God go bless us yanfu-yanfu and worry go commot for hawa life.

View Details

Today praya na make God make like beta for pipo wen dey sick, old pipo, pipo wen deir pesin die for dis new year so and hawa family dem.De message of Hope dey tell us say make we no forlow pipo dey do bad tin.

View Details

Hawa two song today na "Fait" and "God wen get all pawa". Dis son dem de let us know say God na-tork-na-do.De message of Hope say as we dey wan give hawa tin dem wen loss and wen devo tif make we know how to pray beta praya.

View Details

De tin dem wen woman dem dey do bicos of fashion and watin God tork for de mata naim we go dey put mout.Today message of Hope de tell us watin God go do wen e go take give us back hawa tin dem wen loss and wen devo tif.

View Details

De tin wen e mean wen God tork say na de husband naim bi de head of hin wife naim we wan bigin tork now.Today message of Hope say de way wen we go take get hawa tin dem wen loss and wen devo tif bi say as we porsue, we musto overtake de devo.

View Details

De tin wen dey make small pikin dem de get kobo leg and watin we fit do for de mata of de kobo leg naim bi today mata.Today message of Hope say pipo wen wan make God give dem back watin devo tif from dem musto redi to porsue devo.

View Details

De tin wen hawa pikin dem, tesha and papa and mama go do wen hawa pikin dem go take pass exam for skool naim we tork today.Total message of Hope say pipo wen wan make God give dem all deir tins wen loss no go bi pipo wen dey look odar pipo sakam.

View Details

Some odar tin dem wen husband and wife go do wen deir marrage go take strong and stand gidigba naim bi today mata.De message of Hope say pipo wen wan make God give dem deir tin wen loss musto give fait and do watin God tork say make dem do.

View Details

Today praya na make God bless pipo with moni, make God give us beta leda for 2023 elekshion and make de new Covid sikness no near us.De message of Hope dey tell us say God redi to give us hawa beta tin dem wen loss wen we dey find dis year.

View Details

Hawa fess song today say make God carri us go deep deep for hin love and de sekond one say make God give us new hat.De message of Hope say de fess praya wen God pikin go pray evryday bi say make God give am new hat wen go let am forlow God waka.

View Details

Na true say we don arrange hawa waka for de new year but devo must bring kata-kata so make we get strong mind and God go epp us.De message of Hope say make we no let de torfee wen devo dey give pipo for dis life make us miss heaven.

View Details

De moni mata and how husband and wife go take bi wen for hinside watin bank pipo dey call joint account naim we tork put today.Today message of Hope say as God pikin, God want make we separate hawa sef from de world and de tins wen de world dey do.

View Details

De kain kain tin dem wen pipo fit do wen dem too fat and dem wan commot de waite for deir bodi.Today message of Hope say make we commot hawa hand from sin, make we no dey do evrytin wen hawa bodi want make we do.

View Details

De tin dem wen hawa pikin dem go do wen dem go take dey carri fess for skool naim bi today advice.Today message of Hope dey tell us say God want make we bi pipo wen no go sefish dey tink of hawa sef and watin we want bifor odar pipo.

View Details

Odar tins wen husband and wife go do wen deir marrage go take beta, wen e no go shake and wen e go take reach evening naim bi today mata.De message of Hope say God beta pikin dem musto bi pipo wen commot deir bodi from de world and dey do watin God want.

View Details

Today praya na make God cme epp us stop de kili-kili wen dey happun for hawa kontree.De message of Hope dey tell us say as God pikin, God want make we get sorri hat for pipo make we dey show meci dat na one work wen God want make we do.

View Details

Today song dem na song wen go hep us redi bicos e no go tay now Jesus go come carry hin pipo go heaven.De message of Hope dey tell us say pipo wen go redi to forlow Jesus go heaven must commot deir hand kpata-kpata from sin.

View Details

De kain plan wen we go plan wen dis year go take beta for hawa life and wen we go take get testimoni naim bi de mata today.Today message of Hope say make we dey luk hawa life dey commot sin for hawa bodi, na so we go take redi for Jesus wen dey come.

View Details

For de mata of how husband and wife go bi one for moni mata, dem fit dey put deir moni togeda for one place for bank.De message of Hope dey tell us say na pipo wen dey hear and believe God word and dey do watin God tork go redi wen Jesus come.

View Details

De kain pain wen we dey get for hawa head, watin dey cos am and watin we fit do put naim bi hawa mata today.Today message of Hope say de pipo wen go redi wen Jesus come na pipo wen dey forlow God waka and dem dey do watin God say make dem do.

View Details

Odar tins wen hawa pikin dem go do wen go make 2023 bi beta year for deir life for skool and bizness naim bi today mata.De message of Hope dey tell us say na only de pipo wen dey do watin God tork and wen Jesus dey deir life naim go redi wen Jesus come.

View Details

De tin dem wen we go do wem hawa marrage go take beta and take stand gidigba reach evening naim bi today mata.Today message of Hope say de world today don ripe for Jesus to come so make we take dis time dey redi make we for no loss

View Details

Hawa fess song dey tell us say na only Jesus name fit save pesin and de sekond song say we don decide say we go forlow Jesus.De message of Hope dey tell us say na only Jesus bi de road wen we fit pass go heaven and get etana life

View Details

Anoda tin wen we musto do if we want make dis new year good na say we musto plan hawa waka and we musto pray for hawa plan make e for work.De message of Hope dey tell us say devil dey fite us but God don give us watin we go take win de fite.

View Details

De kain style wen husband and wife fit take put deir moni togeda dey use am togeda naim bi de mata today.Today message of Hope dey tell us say satan want make we believe say all de bad bad tin wen de happun na God de do am so dat we no go forlow God.

View Details

De way wen we dey do de medcin wen doktor say make we drink wen fit con ton to watin fit cos wahala for hawa bodi naim bi today tork.Today message of Hope dey tell us de tin wen happun wen sin come take enta hawa world and hawa life.

View Details

De kain tin dem we hawa pikin dem go do wen dis new year go take bi beta year for dem naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen God do sometin e dey happun as e tork am so make we believe God word.

View Details

Anoda tin wen papa and mama wen wan get beta pikin no go do bi say dem no go take bita hat take dey forlow de pikin de waka.De message of Hope dey tell us say de word of God dey give us life.

View Details

Today praya na make God put hin hand for hawa life dis new year make we for see beta tin and make moni dey yanfu-yanfu.De message of Hope dey tell us say de Word of God na hawa light and e dey give us sense to take waka beta waka.

View Details

Today fess song na "The Biatitude" and na song abat de message wen we hear dis wik and de sekond song abat "Peace" say Jesus give us hin peace.De message of Hope say pipo wen no dey do wahala and kwarel but dem like peace, God go bless dem.

View Details

As we dey redi for de new year, watin we go do make God for ansa hawa praya naim bi hawa mata today.De message of Hope dey tell us say de pipo wen get piour hat wen no dey tink bad tin na pipo wen God go bless.

View Details

Moni mata and how husband and wife go take bi won for moni mata naim bi hawa mata today.De message of Hope dey tell us say pipo wen dey sabi sorri for odar pipo, wen no dey revenge but dey forgive na pipo wen God go bless.

View Details

Today sikness wen we tork put na de won wen bi Artiritis wen dey make pain de for hawa leg and hand.De message of Hope wen still bi de pipo wen God go bless say pipo wen dey take all deir hat forlow God go get God blessing.

View Details

Today na small small advice wen go epp pipo as dem dey jolli-jolli wen no go bring wahala come naim we tork.De message of Hope say anoda pipo wen God go bless na de pipo wen no dey carri shoda go up but dem gento and kind too.

View Details

Papa and Mama wen want make deir pikin bi as God want make dem bi no go de take deir pikin take pratise how to be oga for house.De message of Hope dey tell us say God go bless pipo wen no dey swim for hinside sin but dey sorri and beg God wen dem sin.

View Details

Today praya na praya make God for epp all of us so dat de tin wen we wan do dis new year God go make an happun for we.De message of Hope na de preach wen Jesus preach for mountain wen e for tell us say God go bless pipo wen poor for spirit.

View Details

Today fess song na from Psalm 34 and e say make we cari God go up and de sekong song na Psalm 121 wen say na God dey epp us.De message of Hope say as we dey rememba de tin dem wen God do for us yestaday, hawa Hope go dey strong more more for God.

View Details

De way wen we go take forlow de praya wen Jesus give us for Bybbo come pray hawa praya well for de new year naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen we pray and we get strong mind say God go ansa, dat one sef dey give us hope.

View Details

One beta tin wen husband and wife fit do for demsef na make dem do watin go make dem happi for each odar.De message of Hope dey tell us where we go for see Hope wen we go take waka for de year wen dey come so.

View Details

De kain tin dem wen family go do to take manage and kontro pesin wen get sikness for hin brain naim doktor tork today.Today message of Hope dey tell us say wen we forlow pipo wen get hope bi friend dey forlow dem waka, we sef go get Hope.

View Details

De kain tin dem wen pipo sorpose do wen dem dey jolli-jolli as God tork naim bi hawa pikin dem mata today.Today message of Hope dey tell us say if we believe and forlow pipo wen get hope waka, we sef go get beta hope wen no go let us fail.

View Details

Papa and Mama wen wan make deir pikin bi beta pikin no go dey do watin go make deir pikin vex.De message of Hope say one place wen we go for get Hope na wen we see kata-kata for life bicos na Hope say e go beta pesin take dey commot for kata-kata.

View Details

As we dey redi for new year today praya na pipo give Jesus deir life and make dem forlow God waka for de new year as God pikin.De message of Hope dey tell us say na Hope dey take pipo get patience take wait for God to do watin e want do for deir life

View Details

Hawa fess song today na "God go take care of you" and de sekond song na "God big pass eni mountain"De message of Hope dey tell us say we go fit take hawa mind commot enitin wen no dey make us wen we know say God dey with us to save us.

View Details

Jesus tell us how we go pray so na dat praya wen Jesus give us naim we take learn how to pray today.De message of Hope tell us say bicos we bi watin we dey tink, e go good make we dey tink good tin so dat watin we go tork and do go bi good tin too.

View Details

Two kweshion wen husband and wife go take make deir marrage beta for de new year naim we dey find de ansa today.De message of Hope tell us say we Jesus forgive we e commot de fear wen dey dey hawa bodi wen we do bad tin so dat we no go dey run from God

View Details

De kain brain sikness wen fit do only woman plus de one wen dey make pesin see watin odar pipo no dey see naim bi today mata.Today message of Hope say make we no dey do odar pipo watin we no go like make dem do us and make we dey forgive.

View Details

De kain way wen we go take de do hawa jolli-jolli for dis kristmas time naim bi today mata with hawa pikin dem.Today message of Hope dey tell us say stress wahala don kill many pipo so make we dey pray and give Jesus all hawa wahala

View Details

Papa and Mama wen sabi give deir pikin watin good for dem na korret papa and mama wen wan make deir pikin bi beta pikin.De message of Hope dey tell us say God no want make we fear and if we wan commot fear for hawa bodi make we trust God.

View Details

Today praya na for de krismas time wen we dey so make God save pipo wen go travo and make peae dey for family too.De message of Hope dey tell us say de way hawa bodi dey do us wen dey make us happy, vex, kworel naim oyibo dey call emoshion.

View Details

Today two songs na "One day at a time" and "Because He lives" and dem bi song we dey ginger hawa fait for God side.De message of Hope na de ansa wen go make us get strong mind for God even for de wahala wen brekete yanfu-yanfu for kontree

View Details

As we dey redi for de new year, we musto pur de mata of praya for front bicos na praya bi de pawa wen go fit make us stand.De message of Hope na de ansa for de kweshion wen konsign as we go take get big fait wen we go take forlow God waka.

View Details

Eni marrage wen go last musto bi marrage wen de husband and wife for dey do beta beta tin for dem sef wen go make dem appi togeda.Today message of Hope na de ansa of why we sorpose baptise as we say we wan forlow God waka.

View Details

De kain kain tin dem wen dey make pesin brain ton wen e go bi like say e wan krase or e dey krase naim doktor tork today.Today message of Hope na de ansa of why we musto go church as God tell us.

View Details

De beta korret love wen pipo dey take marray no bi de one wen pipo dey fall enta but na de one wen God give us for Bybo.Today message of Hope na de ansa wen show us as we go take bi beta Kristian wen dey forlow God waka.

View Details

Papa and Mama wen won train deir pikin as God want go sabi take one hand beat pikin den take de sekond hand draw am near bodi.Today message of Hope na de ansa of watin Salvashion bi and how we go tru-tru give Jesus hawa life.

View Details

Today praya na for de plenti tin wen dey wahala pipo for Naija like de japa wen all hawa doktor and nurse dem de japa, ASUU, and 2023 Elekshion.De message of Hope na de ansa for de kweshion dem wen de wahala hawa mind like weda God tru-tru dey?

View Details

Today two song "They are more precious" and "The words of the Lord" dey tell us say God word and hin Law na watin we musto do.De message of Hope dey tell us say wen we do watin God Law say make we do, dat one dey show say we bi sabi pipo.

View Details

As we dey redi to enta de new year make we tell hawa sef say we no go take hawa mout tell God enitin wen we no go fit do.Today message of Hope dey tell us say wen we do watin God law say make we do, dat one de show say we love God.

View Details

Anoda ingridient wen go make marrage strong kakaraka na de kain love wen make Jesus die for we.Today message of Hope dey tell us say de grace wen God take commot sin for hawa life naim bi de pawa wen we go take kip de Law.

View Details

De sikness wen dey make pesin head ton wen e go come fit krase naim bi today mata wen doktor tork put.Today message of Hope dey tell us say god go jorge de pipo wen dey dis world and naim Law naim e go take jorge dem.

View Details

De bad kuru-kere waka wen boy and girl dey waka bifor dem marray wen God no like.Today message of Hope dey tell us why God want make we do watin e tell us to do for hinside hin Law.

View Details

Papa and mama wen want make deir pikin bi beta pikin musto dey tork to deir pikin bicos na as dem de tork de pikin go de learn watin to do.De message of Hope dey tell us watin God tork for hinside de Law wen e give us.

View Details

Today praya na for all the state wen dey for South East wen hawa Ibo pipo dey make God hep stop de kilikili wen de happun for deir.De message of Hope dey tell us say God give us hin law bicos he love us.

View Details

Today song "Love lifted me" and "I am his Righteousness" tell us as God take commot sin from hawa bodi.De message of Hope say Love wen bi de korret beta road to take forlow God na road wen we no go for dey happi hinside sin.

View Details

How we go take commot hand for de tin wen we dey do for church today wen no make God bless us dis year na bi today tork.Today message of Hope say de korret beta road wen bi Love must bi de one wen you go for forgive pipo wen do you bad.

View Details

De four leg of Love wen musto dey for marrage wen go make marrage last naim bi today mata. Today message of Hope say de korret beta road wen bi love na road wen pesin no for dey kwik vex enihow vex.

View Details

De tin wen pesin wen get de insomnia sikness fit do to manage hin bodi naim doktor tork today. Today message of Hope dey tell us say de korret beta road na de road of love wen no go let pesin dey want make na only hin own pipo go do.

View Details

De kain bad tin wen papa and mama fit see wen deir pikin dey do wen go make dem know say deir pikin don dey forlow bad gang naim bi today mata. Today message of Hope say de korret beta road wen bi Love no get pipo wen dey do yanghan-yanghan enihow.

View Details

Papa and Mama wen want train deir pikin as God want musto dey tink abat watin dem go do wen de pikin go take bi beta pikin. De message of Hope say pesin wen no dey carri shoda go up dey proud na pesin wen dey waka de korret beta road with God.

View Details

Today praya na for evrybodi wen fit hep make dem come hep put hand for de wahala wen govment and univasity teacher get. De message of Hope say de beta korret road wen we go take forlow God waka na de road of Love bicos God na Love.

View Details

Today song "Give me the Bible" and "More precious that Gold" na abat de blessing wen we go get wen we dey read, hear and do watin God tork. De message of Hope say Daniel know God word bicos e dey read am and e know say God go commot dem from Babilon

View Details

De way wen we go take go church and how we go do wen we dey hinside church wen God go take forlow us tork naim bi today mata. Today message of Hope tell us say Daniel know say pawa dey hinside praya and e use praya take win all hin fite for Babilon.

View Details

De kain love wen God dey give bicos na God bi dat Love naim bi de love wen go fit make marrage reach evening. Today message of Hope tell us say Daniel tell hinsef say hin no go do watin evrybodi dey do but hin go do watin God say make hin do.

View Details

De kain tin wen fit happun to pesin wen no dey sleep well naim doktor tork today. Today message of Hope tell us say God stand gidigba for Daniel and hin tiree friend dem and dem come beta pass de odar pipo for de skool.

View Details

Wen beta pikin forlow bad pikin waka and e come dey imitate de bad pikin dey do bad bad tin naim bi today mata. De message of Hope tell us say Daniel see plenti wahala for Babilon so tay dem even giam juju name but e still kontinue to forlow God waka.

View Details

Papa and Mama wen want train deir pikin as God want go bi papa and mama wen dey happi and dey make deir pikin happi. De message of Hope dey tell us say as life for Babilon bad reach, with juju for evrywere, Daniel still dey do watin God want make e do.

View Details

Today praya na make God hep police, soja, efcc etc do deir work well for dis end of year so make we no see kata-kata. De message of Hope dey tell us say Daniel get de korret beta life wen God want make we get.

View Details

Today two songs "Softly and Tenderly" and "Had it no been" dey tell us abat Jesus love wen e take die for us and e dey call us make we give am hawa life. De message of Hope dey tell us say make we no die for hawa sin like Pharoah die for hin sin.

View Details

Make we read hawa Bybbo and do watin de Bybbo tork so dat we go bi God koret pipo for de new year. Today message of Hope tell us say God give Pharoah plenty chance and God too dey give us plenty chance today too so make we repent.

View Details

De story wen show how husband and wife sorpose hold demsef tight make marrage for no scata naim we tork today. Today message of Hope tell us say make we no do strong hat like Pharoah bicos pipo wen dey do strong hat for God dey die troway.

View Details

Wen bad pikin forlow good pikin bi friend and de bad pikin come dey imitate de good pikin, de bad pikin go come change. De message of Hope wen bi numba tiree lesin for Pharoah mata na say make we dey believe watin God tork.

View Details

De papa and mama wen go fit train deir pikin as God want go bi papa and mama wen de hep deir pikin. Today message of Hope na de sekond lesin for Pharoah mata and na say make we dey do watin God tork bicos who no do watin God tork go suffa like Pharoah.

View Details

Today praya na for de elekshion wen dey come for 2023, make God for put hin hand make we no see kata-kata. De message of Hope dey teach us lesin from Pharoah life and today we no go bi mumu like pharoah wen no know watin God do for am yestaday.

View Details

Today two songs "In His time" and "Faithful to the End" tell us say God dey do watin e tork for hin time. De message of Hope say God give Abraham watin e say e go give am and as e do for Abraham, na so e go do for we too bicos God na tork and do.

View Details

De koret way wen we go take read hawa Bybbo wen we go take fit forlow God waka naim bi hawa mata today. Today message of Hope tell us say make we dey do good bicos like Abraham sometime we fit do good for angel wen go make God bless us.

View Details

Anoda tin wen go make marrage reach evening bi say make we put all hawa mind for de marrage make we no dey tink as we go take commot. De message of Hope tell us as Sarah take make Abraham fall hinside sin so make we wise, believe God and do watin God tork

View Details

Today mata for how hawa bodi go take well na de kain sikness wen fit enta hawa bodi if we no dey sleep as we sorpose sleep. De message of Hope dey us say Abraham give God tithe bicos e know say na God get evrytin so make we too give God hin tithe.

View Details

Wen bad pikin forlow beta pikin bi friend, as dem dey waka togeda, de bad pikin go come dey beta, dey resembo hin beta friend. De message of Hope say make we no dey drag enitin but make we bi like Abraham wen let Lot hin pikin fess choose hin side.

View Details

If we go train hawa pikin make dem be beta pikin, we go dey do watin God tell us make we do for hawa house. Today message of Hope say de numba two lesin for Abraham life bi say e see wahala of hunga so we too go see wahala as we dey forlow God waka.

View Details

Today praya na for peace for Anambra pipo, and make God hep de pipo wen watar scatar deir propaty. De message of Hope say as God call Abraham na so e call all of us and we fit take Abraham life learn how we go forlow God waka.

View Details

Today song dem de enkorrage we say make we pray like Jesus pray bicos Praya de change pipo and kondishion. De message of Hope dey tell us say as Jesus get plenty work wen e dey do e still dey pray well well so make we bi like Jesus.

View Details

If hawa waka with God go beta for de new year we go look dis year waka take make de new year waka beta. De message of Hope dey tell us say make we call God for hawa praya for eni kondishion wen we dey and God go ansa we.

View Details

Anoda ingredient for marrage to last na make we no selfish dey do like say na only we dey de marrage. De message of Hope dey tell us say as pipo wen resembo Issachar, we musto forlow de word of God and do watin God say make we do.

View Details

Watin pesin fit do wen e no go get epilepsy sikness and how e go manage de sikness if e get am. De message of Hope say one tin wen we musto do for dis time wen we dey so na to do God work wen bi make we tell pipo abat Jesus wen dey come.

View Details

De way wen some pikin de force odar pikin to do or waka de kain waka wen no plan say dem go do or waka naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say we sorpose bi like Issachar pipo wen know as deir time bi and know watin dem sorpose do.

View Details

De way wen papa and mama go take train deir pikin dem wen dem go take bi beta pikin for family and kontree naim bi today mata Today message of Hope dey tell us say make we bi like John de baptist, make we go take pipo make dem commot deir hand from sin.

View Details

Today praya na still for God hep for de warta wen don cova hawa kontree, scata pipo house and even kill some pipo. De message of Hope say as John de baptist tell pipo say Jesus go come de fess time na so we go dey tell pipo now say Jesus go come again.

View Details

Hawa two song say wen we gada bicos of God, God dey come meet us and bicos hin dey with us we no sorpose worry. De message of Hope say make we no let enitin commot hawa fait from Jesus, e fit tay but Jesus go ansa as e ansa de canaanite woman.

View Details

Watin we sorpose do as we dey redi for new year wen dey come wen hawa new year go take beta pass de old year. De message of Hope dey tell us say e no mata how hawa sin bad reach, Jesus go forgive if we come meet am.

View Details

Wen husband and wife bi friend for hinside deir marrage deir marrage go reach evening. De message of Hope dey tell us say pesin wen find Jesus with all hin hat go see Jesus and Jesus go save am like e save Zaccheaus.

View Details

Epilepsy na sikness wen dey make pesin fall, dey bring spit and foam for hin mouth and de sikness no get cure. De message of Hope dey tell us say wen we don take hawa sense do watin we fit do make we rememba to do watin God say make we do for hin word.

View Details

De kain tin wen dey happun to pikin wen pipo dey bully and de kain mark wen fit dey de pikin bodi naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say no mata de yama-yama wen dey hawa life Jesus come make e for change hawa life.

View Details

Odar exampo of watin papa and mama go do and how dem go take do am well wen deir pikin go take like to resembo dem. De message of Hope dey tell us say wen we believe God word and do watin God say make we do hawa life go change like Rehab life.

View Details

Today praya na make God hep hawa pipo bicos of de warta wen don cova plenty place for hawa kontree. De message of Hope dey tell us say na only as we take know God naim we go take fit stand for hin word like David wen e kill Goliat.

View Details

Hawa fess song na praya make God change hawa life "Renew my life" and de sekond song say make we do God work "Work the Work". De message of Hope say de numba four tin wen we go run commot na wen we fold hawa hand no do de work wen God give us pawa to do.

View Details

Wen we fear God, we go dey do watin God say make we do and dat one go make us bi beta pipo wen pipo go take beta eye look. De message of Hope say de numba tiree tin wen no go dey hawa life na say we say we know God for mout but hawa life get yama-yama.

View Details

Wen husband and wife let deir family, friend and odar pipo dey chuk mout for deir marrage, naim bi say de marrage wan scata. De message of Hope dey tell us say de sekond tin wen we must run commot na wen we no let de Holy Spirit work for hawa life.

View Details

De tin dem wen pipo go do make dem for no get breast kansa sikness bicos prevenshion beta pass cure. Today message of Hope dey tell us say make we rememba say we no know de day wen Jesus go come so make we no dey do eni how.

View Details

God plan for de dress wen we dey wear bi say hawa dress go tell pipo say we bi God pikin. De message of Hope dey tell us say we bi pipo wen God call commot for de world make we for forlow am.

View Details

Anoda tin wen papa and mama wen wan make deir pikin imitate dem go do bi say dem go let deir life and watin dem tork bi de same tin. De message of Hope dey tell us say Jesus naim bi de korret friend wen we get bicos naim die for cross for we.

View Details

De praya rekwest wen pipo wen listin to de program send come give us naim we pray for today. Today message of Hope na de kweshion wen all of us dey ask wen kata-kata happun for hawa life. We go dey ask weda God still get us for hin mind.

View Details

De song dem for today wen bi "In times like these" and We are on the edge of glory" dey tell us say Jesus go soon come. Today message of Hope dey enkorrage us say make we stand for hinside Jesus make we no dey run forlow yeye god wen pesin make.

View Details

Woman wen want make pipo take beta eye luk am musto bi pesin wen dey do good tin for odar pipo. De message of Hope dey tell us say as God tork na so e dey bi, Jesus go come again God don tork am and na so e go bi.

View Details

Wen husband and wife dey kwarel dey fite and dey do odar tin dem wen fit wound dem, de marrage fit scata. De message of Hope dey tell us say make we no put hawa trust for man bicos man go fail you. Na only God no de fail so make we trust God.

View Details

Watin we go do if we get kansa sikness and watin we sorpose do wen we no go take get kansa sikness naim dortor tork today. De message of Hope dey tell us say make we wise like de five wise vegin wen we dey choose enitin for dis life

View Details

Hawa pikin dem sorpose know say, God go jorge de tin wen dem dey do today so make dem no dey do bad tin. Today message of Hope dey tell us say we dey fite with devo wen we no dey see with hawa krokro eye and na only God pawa we go fit take win de fite.

View Details

Odar tin dem wen papa and mama wen want make deir pikin de imitate watin dem dey do make e for bi beta pikin naim bi today mata. De message of Hope today dey tell us say hawa big enimi na de devo no bi hawa nebor wen we dey forlow kwarel.

View Details

Today, na de praya rekwest wen pipo wen dey listin to de program send come naim we pray for. De message of Hope dey tell us say make we tru-tru know hawa sef make we no come bi pipo wen devo go take play panya

View Details

Today song na praya make God give we klin hat and sanctify hawa hat. De song dem bi "Create in me a clean Heart" and "Sanctify my Heart". De message of Hope dey tell us say Jesus redi to give we new heart wen we give am hawa life and forlow am waka.

View Details

Anoda tin wen fit make pipo take bad eye take look we na de kain friend wen we get and wen we dey forlow waka. De message of Hope dey tell us say wen we get de kain mind wen Jesus get we no go dey carri shouda go up dey do like say na we get de world.

View Details

De kain tin wen pesin wen get kansa sikness for hinside hin breast go see for hin bodi naim doktor tork today. Today message of Hope dey tell us say wen we get de kain mind wen Jesus get, we go dey redi hawasef for de day wen Jesus go come.

View Details

De bully mata, as e take bad and watin bully and de pesin wen dem dey bully sorpose know and do naim bi today mata. Today message of Hope say wen we get de kain mind wen Jesus get, we go do de tin dem wen God say make we do.

View Details

De tin wen papa and mama go do wen dem go fit bi beta exampo for deir pikin dem naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say wen we get Jesus kain mind, we go bi pipo wen dey hapi dey do watin God say make we do.

View Details

Today na praya for de elekshion wen we go take selet hawa leda dem for 2023. De message of Hope na how we go take get de kain mind wen Jesus get wen e day dis world.

View Details

Today song wen bi abat heaven na "In the sweet bye and bye" and Just over in the glory land". De message of Hope na de parabo wen Jesus take teach pipo say we get enimi, hin name na devo so make we shine hawa eye make devo no put san-san for hawa garri.

View Details

Wen woman wear beta dress, e klin hin bodi well and mout and bodi no get bad smell, pipo go take beta eye look dat woman. De message of hope na de parabo wen Jesus take teach pipo say hawa hat naim bi de koko for de kain waka wen we forlow God waka.

View Details

Wen man let hin wife dey do watin God say make hin do as husband and head for hin family dat family no fit scata. De message of Hope dey tell us say God want make we bi like tree wen get fruit with hawa beta karacta wen we go take resembo God.

View Details

De tin dem wen fit make pesin get breast kansa sikness naim doktor tork put today. Today message of Hope na de parabo wen Jesus take teach us say we go tell God watin we do with all de beta tin wen e give us for dis life.

View Details

De fit wen papa and mama dey fite join fite film wen pikin dem dey look, fit make pikin ton bully. Today message of Hope na de parabo of two pipo wen build house wen Jesus take teach us say wahala go come but God pipo no go fall.

View Details

De kain wahala wen no dey let mani papa and mama fit give deir pikin dem beta exampo wen dem go fit forlow naim bi today mata. Today message of Hope na de parabo wen Jesus take teach we say na we bi de lite wen dey dis world.

View Details

Today praya na for hawa family dem make God let family get moni wen dem go take pay skool fees. De message of Hope na de parabo wen Jesus take teach us say we no go fit put hawa old sin life hinside de new life wen hin dey give us.

View Details

Today song na praya make God for carri us near hinsef and de song dem bi de hymn "I need thee every hour" and "Draw me close" De message of Hope dey tell us say wen e bi like say wahala and kata-kata won kill us na dat time Jesus dey ansa wen we call am

View Details

Anoda tin wen we fit do wen go make us beta pass as we bi bifor na make we learn new tin and get beta handwork. De message of Hope dey tell us say wahala dey come wen big pass watin we dey see now but if we do watin God tork we go save.

View Details

Anoda tin wen fit scata marrage na wen pesin no dey do watin e sorpose do wen go make hin marrage work and last. Today message of Hope dey tell us say e no mata watin we see for life, God na still God and e dey do watin e tork.

View Details

De kansa sikness wen dey start for breast, wen fit do man and woman wen doktor dey call Breast Cancer naim bi today mata. Today message of Hope say na only God blessing wen dey de palce wen God dey naim fit klin hawa sin of yestaday.

View Details

Wen pikin want make pipo dey hail am and wen pikin like to revenge de tin wen odar pipo do am wen e small, dat pikin go bi bully. Today message of Hope dey tell us say na only Jesus go fit save we commot from de salary of hawa yestaday sin.

View Details

Make papa and mama get de kain karacta wen deir pikin go fit imitate and come resembo dem. Today message of Hope say wen we dey de place wen God dey, we go come dey resembo God as we dey do watin we know say God want make we do.

View Details

Today praya na make God make sik pipo well and make God hep orphan, widow and pipo wen dey fine work. De message of Hope dey tell us say wen we dey de place wen God dey hawa life go change and we go dey resembo God.

View Details

De song, "Be Strong" and "Bigger than any Mountain" dey enkorrage us make we strong bicos God big pass eni wahala wen we fit see. Today message of Hope say God fit give us pawa to start again wen e bi like say hawa mata don end.

View Details

De tin dem wen we fit do as woman wen go make pipo take beta eye look us and wen fit make man marray we naim bi hawa mata today. Today message of Hope dey tell us say God go give us pawa wen go make us stand gidigba and we no go fall.

View Details

Wen pipo wen dey for hinside marrage dey play each odar wayo and dey lie, dat marrage go scatar. De message of Hope dey tell us say wen we dey sick, God pawa go fit make we well if we pray and believe God.

View Details

Watin we fit do wen hawa pikin dem get jaundis sikness and watin dey make big pesin get Jaundis naim doktor tork today. De message of Hope dey tell us say for de fite of good and bad wen we dey hinside, na God dey give us pawa to win.

View Details

Anoda kain bully na man wen dey play yeye play with girl pikin and de kain tin dem wen make bully dey naim bi today mata. De message of Hope dey tell us say wen we no get pawa to take fite hawa fite God go give us pawa wen we go take win hawa fite.

View Details

Today mata na anode five tin wen husband go do for hin family wen go make hin wife and pikin dem happi. De message of Hope dey tell us say wen kata-kata bos and trobo dey, God go give us pawa wen we go take commot for de trobo.

View Details

Today praya na for all hawa leda dem, make God touch dem and give dem beta hat wen dem go take make kontree beta. De message of Hope dey tell us say God get pawa wen e go give we wen we no go take fall for temtashion.

View Details

Today song dem na de hymn "Just as I am" and "Pass me not" and dem bi hawa praya make God do new and beta tin for hawa life. De message of Hope dey tell us say de salvashion road wen we dey waka with God na road wen go bring beta blessing come hawa life

View Details

Man dem no dey like marray eni woman wen take deir bodi do wife give dem wen dem neva marray dem. Dat kain woman go come get bad name. De message of Hope dey tell us say wen we dey kip God Law, naim bi say we dey waka for de old road wen we go take save.

View Details

Wen husband and wife no dey sleep togeda as husband and wife sorpose sleep togeda, e day scata marrage. De message of Hope say wen God pikin dem commot deir hand from sin, deir road go dey shine as Jesus wen bi light dey waka de road with dem

View Details

De kain kain tin dem wen fit make pesin get jaundice sikness espeshally baby wen dem just bon and watin jaundice de spoil for hawa bodi naim bi today mata. Today message of Hope say as we dey waka with Jesus we go get peace even wen wahala dey de world.

View Details

De diffren way wen one pesin take dey bully anoda pesin for family, for skool and for compound sef naim we tork today. Today message of Hope dey tell us say de road of salvashion no get kuru-kere waka but pipo go see say you bi beta pesin

View Details

De numba 8, 9 and 10 tin wen Husband wen want make hin wife and pikin dem happi go do for hin family naimbi today mata. Today message of Hope dey tell us say de road wen we dey waka with God na small road and plenti pipo no dey see de road.

View Details

We still dey pray for de wahala wen Govament and ASUU get wen let hawa pikin dem dey house now for six mont. De message of Hope dey tell us say wen we obey God word and we let de Spirit of God lead us, dey road we dey waka and hawa waka go good.

View Details

Today song "Ancient Word" and "De Law of God" na abat God Word and hin Law wen no dey change but wen dey change pesin wen do watin God tork. De message of Hope say make we forlow de truth, Jesus, God Word and hin Law na truth wen fit save we.

View Details

Woman wen hin husband die fit marray anoda husband but make e marray hin husband broda as God tork make dem no scata odar pipo marrage. De message of Hope dey tell us say God want make we tell odar pipo how hin take save we so dat dem too go save.

View Details

Wen woman chuk leg for houside go dey sleep with man wen no bi hin husband, marrage fit scata for dat mata. De message of Hope dey tell us say we wen we give Jesus hawa life wen sin don scata, hin go give us new life.

View Details

De sikness wen doktor put hin mout today na Jaundice wen dey make pesin bodi and eye dey yelow. Today message of Hope dey tell us say we go fit touch Jesus with fait like de woman wen blood de commot from hin bodi for Bybbo.

View Details

De beat wen big pesin dey beat small pesin wen no do am enitin bicos e get pawa naim oyibo dey call Bullying. Today message of Hope dey tell us say wen we do watin God word say make we do, we dey eat Jesus flesh and na dat bi hawa taste of life.

View Details

De tin dem wen husband go do for hin house wen go make hin wife and hin pikin dem happi naim we still dey tork today. Today message of Hope dey tell us say God want make we cross commot for sin and make we come dey obey am.

View Details

Today praya na for God to hep de pipo wen dey kidnapa hand and make God stop all de kidnapa work wen dey hawa kontree. De message of Hope dey tell us say God dey call all of us make we come back come meet hin wen bi hawa God.

View Details

Hawa fess song na "Plenti good room" and de sekond song na "God neva fail". Today message of Hope dey tell us say hinside Christ, we get plenti good tin yanfu-yanfu wen God dey give we.

View Details

Mani Woman wen deir marrage don scata dey find new husband and na dem dey forlow odar woman dem husband come bi sekond wife. De message of Hope say as we dey hinside Christ, we dey forlow God waka and dat waka dey hep us bi God friend.

View Details

Man wen hin one wife no reach for am na man wen hin marrage no go last and na so too for woman wen no happi with hin one husband. Today message of Hope dey tell us say wen we dey hinside Jesus, we no go loss bicos de Holy Spirit go dey lead us.

View Details

De kain tin wen we go fit do if anaemia sikness dey hawa family naim doktor tell us today. Today message of Hope tell us say wen Jesus dey hawa life, we go know say we don save and sin and satan no go fit hold we again.

View Details

De tin wen hawa pikin dem go do if dem want make God ansa deir praya naim bi hawa pikin dem mata today. Today message of Hope dey tell us say na Jesus naim bi de road wen we go take meet God and naim dey make God give us blessing.

View Details

Husband wen want make hin family bi happy family musto to dey pray with hin family and do de odar tins wen we hear today. De message of Hope say wen we give hawa life to Jesus, hin go come give we peace wen no go let trobo wahala we.

View Details

Today praya na make God hep us stop de wahala of bandit, kidnap, boko haram and all de odar bad tin wen de happun. De message of Hope dey tell us say na only hinside Jesus naim we for get life bicos na Jesus bi hawa life.

View Details

Hawa fess song say "Hawa hep dey hinside God name" and de sekond song say "God naim bi hawa Protector". De message of Hope say make we no fear enitin bicos we get God.

View Details

Hawa sista dem wen don old and dem neva marray no take deir bodi do yeye but make dem get fait say God go rememba dem. De message of Hope dey tell us say God want make we let hawa karacta shine make pipo see Jesus for hawa life.

View Details

Anoda tin wen dey scata marrage na wen man dey forlow anoda woman wen no bi hin wife dey sleep. De message of Hope dey tell us say God don arrange one day wen e go take pay evrybodi salari for de tin dem wen we dey do for dis life.

View Details

Two tins wen dey balance blood na Folic Acid and Vitamin B12 and we fit get dem for food or we drink dem as medisin. De message of Hope dey tell us say e no mata de yama-yama wen dey yor life God fit change yor life as e change Saul to Aposto Paul.

View Details

De tin wen hawa pikin dem sorpose know bi say God get plan for deir life and if dem want get beta life, dem musto forlow God plan. Today message of Hope dey tell us say hawa God na big God and God get big love wen e take dey save hin pipo.

View Details

De tin dem wen papa and mama sorpose do for deir pikin wen dem go take bi beta pikin and wen family go take koret naim bi today mata. Today message of Hope say make we sabi de true God and wen we sabi God, we go do watin e say make we do.

View Details

Today praya na make God protect hawa pipo life and deir propaty and make hawa soja dem fite beta fite to free hawa kontree. De message of Hope dey tell us say make we no join pipo wen dey take moni take make deir God but make we make Jehovah hawa God.

View Details

Today song na abat Praya. De fess song say "God hear my praya" and de second song say "de tin wen God dey do no bi sekrit". De message of Hope today dey show us pipo for Bybbo wen pray and God ansa deir praya chap-chap make we for pray like dem

View Details

Woman wen dey fine husband musto arrange hin bodi well and make e no say na rich man or fine man e musto marray. De message of Hope tell us say wen we get sin and we dey ask God for watin e no say e go give us, God no go ansa hawa praya.

View Details

Wen wife dey carri bodi dey tink say hin and hin husband bi equal for de house, kata-kata go bos wen go fit scata de marrage. De message of Hope say make we believe say eni time we pray, God dey hear and as e hear, e go ansa hawa praya.

View Details

De kain tin dem wen we go do wen hawa baby and small pikin dem no go take get de blood sikness wen doktor dey call anaemia naim bi today tork Today message of Hope say God dey ansa de praya wen forlow hin plan for hawa life wen dey for Bybbo.

View Details

De tin dem wen hawa pikin dem go do wen dem go take redi for deir tomoro and de come wen Jesus go soon come naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say na wen we ask God watin we want for praya naim we go take get de tin wen we want.

View Details

Anoda tin dem wen hawa husband dem want make we do for dem na say make we dey sorpot and respet dem. De message of Hope dey tell us say de praya wen God dey ansa na praya wen get fait and na de word of God we go for get dey fait.

View Details

Today praya na make God remove wahala from hawa family and make God protect pastor dem and deir family. De message of Hope dey tell us say God want make we dey pray bicos na praya we dey take forlow God tork

View Details

Some woman take yanga troway de man wen for marray dem and some waka ashawo waka and no man gree take dem do wife. De message of Hope say de kain wahala for Noah time dey come again and pesin wen no put hin hope for Jesus go loss.

View Details

Husband wen no luv deir wife as Jesus Christ luv de church na one tin wen fit scata marrage. De message of Hope dey tell us say as de world dey scata dey go so na only pipo wen put deir hope for Jesus go fit save.

View Details

De tin wen dey make pipo blood no balance and watin fit make small baby blood no balance naim doktor tork today. Today message of Hope say na devo we dey forlow fite and na only as we wear de fite dress wen God give us we go take win de fite

View Details

De las-las tin dem wen we go do wen go commot carri bodi wen oyibo dey call price from hawa bodi naim bi hawa mata today. Today message of Hope dey tell us say God make road for hin pikin dem make dem no go chuk hand for de bad tin dem wen devil dey do.

View Details

De tin dem wen man as husband want make hin wife dey do for am for dey family wen go make de family balance naim bi today tork. Today message of Hope dey tell us say na wen we no shine hawa eye naim devo go come pour san-san for hawa garri.

View Details

Today praya na for God pipo wen God dey call hin church to commot bodi from sin so dat God go come fite for us. De message of Hope dey tell us say God na good God and e make evrytin good but na devo hawa enemy naim dey spoil de good wen God plan for we.

View Details

Hawa two song today na de hymns "De old rugged cross" and "Give me Jesus". De message of Hope dey tell us say if we put hawa life and hope for de tin wen dey dis life, we go miss heaven.

View Details

De kain wahala wen woman wen say hin no go marray for dis life go see for family and for kontree naim bi hawa mata today. Today message of Hope dey tell us say no bi we get life so make we no dey waka like say hawa tomoro dey hawa hand.

View Details

De tin dem wen pesin wen no want carri plenti wife or husband sorpose do naim bi hawa family mata today. Today message of Hope dey tell us say make we no put hawa hope for pipo wen say dem bi hawa friend bicos friend dey kill friend.

View Details

De sikness wen consign weda blood dey hawa bodi or weda e no dey naim doktor forlow us tork today. Today message of Hope dey tell us say make we no boast abat tomoro bicos na God get tomoro and if we want beta tomoro make we put hawa life for God hand

View Details

De tin wen pesin fit do wen e no go take dey carri bodi wen oyibo dey call Pride naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say make we no put hawa hope for de plenti moni wen we get bicos moni get feda wen e dey take fly.

View Details

De tin dem wen husband go do for hin wife wen de wife go take happi and wen de family go dey stand gidigba. Today message of Hope dey tell us say make we no put hawa hope for de promise wen human being dey promise us bicos mani pipo na promise and fail

View Details

Today praya na make God give hawa pipo sense wen dem go take gada bodi togeda take drive fulani commot for hawa bush. De message of Hope say make we no look as we fine take tink say na we get life bicos fine no go give beta life or take pesin go heaven.

View Details

Today song "Sanctify my Hat" and " De Hat wen dey forgive" na praya make God give we de kain hat wen Jesus get. De message of Hope dey tell us say make we get de kain Hat wen Jesus get wen e dey dis world.

View Details

Man wen dey do like woman no bi beta man to marray bicos e go forlow you dey drag de woman work for de house. De message of Hope say we bi special pipo for God hand, if we bring bodi come ground, God go protect we and we no go fear enitin

View Details

Plenti husband or plent wife dey bring kata-kata, fite and wahala wen fit scata de family kpata-kpata. Today message of Hope dey tell us say watin God plan say we go bi naim we go bi if we forlow God plan for hawa life.

View Details

Kolera sikness dey enta pesin bodi wen e drink bad watar or chop food wen deti fly shit put so make dey cova hawa food and drink klin watar. Today message of Hope say wen we get strong mind say we no go sin like Daniel for Babylon, tru-tru we no go sin.

View Details

Watin pesin wen wan commot for hinside de wahala wen carri bodi wen oyibo dey call Pride go do to take commot naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say if we no put hawa hand for sin, no juju or devo go fit do we enitin.

View Details

Two odar tin wen fit make hawa family stand gidigba for dis time wen family dey scata so na Trust and Honesty. De message of Hope dey tell us say wen hawa hand klin and we piour like Joseph, no mata de wahala wen devo bring God go save us.

View Details

Today praya na make God come scatar all de wicked pipo for govment and for de army wen dey let fulani pipo dey kill pipo for kontree. De message of Hope dey tell us say God give us pawa to commot for sin bicos hin put enimiti for sin for hawa hat.

View Details

Today two songs na praya make God hep us get beta hat so dat e go dey fit forlow us tork for deir. De message of Hope dey tell us say make all de tin wen we dey tink for hawa hat bi good good tin.

View Details

Man wen dey take wayo take make woman do watin hin want but hin no dey do enitin for anoda pesin no bi man we sorpose jump marray. De message of Hope dey tell us say God open hin hand wide and e dey call all hin pikin dem make dem come back.

View Details

Trust wen bi de gum wen dey gun husband and wife togeda no go dey eni marrage wen de man get pass one wife or de wife get pass one husband. De message of Hope dey tell us say eni pesin wen nova give Jesus hin life na pesin wen dey stay hinside darkness.

View Details

De kain treatment wen doktor go give woman wen get fibriod sikness naim be today mata. Today message of Hope dey tell us say God Law wen no dey change na Love and na dat Love make Jesus die for we.

View Details

De lesin for hawa pikin dem today na say pipo wen dey carri bodi no dey tink watin odar pipo dey feel but dem go dey mash dem for ground. Today message of Hope dey tell us say make we no dey carri bodi bicos God no dey forlow pipo wen dey carri bodi waka.

View Details

Hawa family mata today na say we musto put God fess if we want make hawa family stand gidigba. Today message of Hope dey tell us say as we dey believe God word and dey do watin God tork, na so we take dey look Jesus face.

View Details

Today praya na say we tank God as e take commot hawa pipo from kidnapa dem hand and we pray took make God scatar de kidnap bizness. De message of Hope dey tell us say God go finish de beta work wen e dey do for hawa life but we sef must forlow God.

View Details

Today song "Draw me into your presence" and "One tin naim I ask God" na praya make God put us for where hin dey. De message of Hope dey tell us say me with dey with Jesus so dat wen e come e go take us go heaven.

View Details

Man wen no know hinsef and de one wen no sabi tork tank you na man wen e go hard for woman to fit marray. Today message of Hope dey tell us say make we dey happi for hinside Jesus even if kata-kata brekete for hawa life bicos God dey.

View Details

De wahala wen dey happun wen pipo wen dey marrage get pass one husband or one wife naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say make we dey hinside Jesus so dat we no go loss wen Jesus come take hin pipo go heaven.

View Details

De kain tin wen woman go see for hin bodi and how hin bodi go dey do am if e get Fibriod sikness naim doktor tork today. Today message of Hope say make we carri Jesus go up make pipo for know say we bi kristian and Jesus go fit draw pipo come hin side.

View Details

De tin wen dey make pipo dey carri bodi and shoda wen oyibo dey call Pride naim bi hawa tork today. Today message of Hope tell us say make we resembo Jesus, kristian na pipo wen resembo Jesus and na dem Jesus go take go heaven.

View Details

Wen husband and wife join bodi for de way wen dem dey take serve God naim bi say dem get Spiritual intimacy and deir marrage no go fit scatar. De message of Hope tell us say if we waka as God want and we put God fess for hawa life, we don win Christ.

View Details

Hawa praya today na for peace for evrytin wen politishan dem go do for all de eleshion wen go happun for 2023. De message of Hope dey tell us say if we must bi kristian, we musto know Jesus like Aposto Paul tell us.

View Details

Hawa two song today na "Precious Lord" and "Just a closer walk" dem bi songs wen go enkorage us as we de waka with God. De message of Hope na de numba two for de fasting and praya mata and God dey tell us say praya musto join fasting na dem two dey waka.

View Details

Man wen dey fear and man wen tink say na only hin tribe pipo bi beta pipo na man wen no go make woman happi for marrage. De message of Hope today tell us say de beta risin wen sorpose take fast and pray na make we for fit commot hawa bodi from sin.

View Details

Anoda kain tin wen fit make woman get plenti husband na bad friend wen e dey forlow waka and long trot. De message of Hope dey tell us watin we go fit do wen we no go dey worri for dis life wen kata-kata for plenti yanfu-yanfu so.

View Details

De diffren kain sikness wen doktor dey call Fibriod wen woman fit get and watin fit make am get de fibriod naim doktor tork today. Today message of Hope dey tell us how hawa fait go take grow as we dey forlow God waka.

View Details

De tin wen we go see wen pesin dey carri bodi, dey raise shoda wen no bi beta tin to do naim bi hawa mata today. Today message of Hope dey ansa de kweshion of watin Salvashion tru-tru bi.

View Details

De way wen husband and wife go take join bodi togeda for deir mind and as dem dey take sleep today as husband and wife naim bi today mata. Today message of Hope say make we put God fess for hawa life and God go bless us yanfu-yanfu.

View Details

Hawa praya today na make God put hand for hawa family dem make dem for no scatar bicos of all de wahala wen dey de life now. Today message of Hope dey tell us say God dey gidigba bicos na only God fit make all de tin wen we dey see for de world.

View Details

De song "Only by Grace" and "Notin but de Blood" dey tell us say na only de blood of Jesus fit save we. Today message of Hope dey tell us say Salvation na de awuf wen Jesus take hin blood buy give we and if we believe we go save.

View Details

Begi-begi man wen no fit gada bodi stand like man with moni but e dey carri shoda go up dey proud na man wen go hard to marray. De message of Hope dey tell us say na de blood of Jesus commot hawa sin wen make we fit get peace for hawa sef and with God.

View Details

Wen woman don bon give him husband, dat kondishion fit make am go sleep with anoda man wen hin husband no go know put. De message of Hope dey tell us say hinside all de kata-kata wen dey dis life na only Jesus fit give us Peace.

View Details

Watin de sikness wen doktor dey call Fibriod bi and de kain tin wen fit make woman get am naim bi today mata. De message of Hope dey tell us say God Law no get koma, e pefet and God don write am for hawa hat make we for fit do am as God want.

View Details

De meni tin wen pipo wen dey carri bodi and shoda dey do wen we dey take know say dem get pride. Today message of Hope dey tell us say bicos pipo no dey do watin God say make dem do for hin Law, dem come dey do wicked tins wen devo send dem to do.

View Details

De way wen husband and wife go take join bodi togeda for de tin wen dem dey tink and tork naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say de salary for sin na say de sina go die and na de Law of God wen we break naim make we bi sina.

View Details

Hawa praya today na for God to hep us stop de kili-kili and boni-boni wen dey happun since muslim pipo take fire bon Deborah for Sokoto. De message of Hope dey tell us say wicked and bad tin dey happun bicos pipo don forget God and hin Law

View Details

Today song na for pigin and Ishan and de song dem tell us say na God dey make hawa life dey go jeje and dis God naim bi numba one God. De message of Hope dey tell us say make we train hawa pikin dem well so dat dem go fit make us happi wen we don old.

View Details

Hawa mata today na say eni man wen don marray but e still dey take hin mama gum bodi no go fit bi beta husband. Today message of Hope dey tell us say wen we get pikin make we take strong hand take hold dem make dem no come put us for wahala.

View Details

For de mata of de tin wen fit make woman get plenti husband, we see say wife wen hin husband dey carri-carri go go carri-carri too for revenge. De message of Hope dey advise us say make we pray make God for show us how we go take train hawa pikin dem.

View Details

Wen we no take hawa medcin as doktor tork, na Drug Abuse bi dat and e fit bring bad sikness come hawa bodi. Today message of Hope dey tell us how de wayo wen de pipo wen Bybbo call de Gibeonites play Joshua wen make dem bi slave foreva.

View Details

De differen differen tin dem wen we dey do wen dey show hawa carri bodi naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say make we no bi pipo wen no get liva like Aaron but make we stand gidigba for God.

View Details

We learn today say if husband and wife go join bodi togeda come bi one as God tork, dem musto leve deir papa and mama. De message of Hope tell us say na bicos Nadab and Abihu don drink brekete naim make dem no do watin God say make dem do.

View Details

Hawa praya today na for hawa soja dem make God for help dem and make dem strong make dem for no dey kill demsef. De message of Hope today dey tell us say wen we no do watin God say make we do, we fit die like Nadab and Abihu for Bybbo.

View Details

Today songs dem tell us say hawa God naim big pass and hin don win for we and e come make us winna kpatakpata. De message of Hope today dey tell us say na devol bi God enimi and devol sef na hawa enimi too.

View Details

Anoda kain man wen woman go luk welwel for marray mata na man wen want make pipo tink say hin bi beta pesin and de one wen resembo Esau for Bybbo. De message of Hope dey tell us say de beta beta tin wen God wan do for hawa life dey hinside de Bybbo.

View Details

For hinside de mata of woman dem wen get pass one husband, we see say woman wen no dey enjoy as hin husband dey sleep with an fit get anoda husband. De message of Hope dey tell us say God word get gidigba pawa and na de word God take make dis world.

View Details

De tin wen man wen get de sikness wen doktor dem dey call Prostrate cancer go do to take manage de sikness naim bi today tork. Today message of Hope dey tell us how we go take read de Bybbo and undastand am wel-wel.

View Details

De mata of pipo wen dey carri bodi, de carri shouda wen oyibo dey call Pride naim bi hawa tork today. Today message of Hope wen bi numba tiree for watin de Bybbo bi dey tell us say de Bybbo sef na hamma wen fit brake sin commot for hawa bodi.

View Details

De mata of the road wen husband and wife go waka wen dem go take fit bi one for hinside marrage naim bi today tork. Today message of Hope dey tell us say na de Bybbo bi de light wen dey show we de korret road to waka for dis life.

View Details

Today we pray for de praya rekwest dem wen pipo wen dey listin hawa program send come make God for make dem get moni. De message of Hope dey tell us say de Bybbo no bi ordinary buk but na God mind wen e tell hin pipo make dem write

View Details

Hawa fess song today na song wen we dey take tell God say we sorry for hawa sin and de second song de enkorrage us say God no go let us fall. De message of Hope dey show us true kristian dem wen dey for bybbo make we for bi like dem.

View Details

Eni man wen sabi spoil odar pipo and wen no want see say eni pesin beta pass am na man wen women go luk well-well bifor e marray am. De message of Hope dey tell us say de true kristian na pipo wen get de kain karacta wen Jesus get

View Details

De tin dem wen dey make woman marray husband and den e come get anoda man for outside naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say pesin wen bi God true pikin go get up from grave wen Jesus come and e go get de life wen no dey end

View Details

De tin wen man go see for hin bodi wen e go take know say e get de prostrate cancer sikness naim bi today tork. Today message of Hope dey tell us watin we go gain wen we bi true kristian.

View Details

De lesin for hawa pikin dem today na say wen fear God, dem go fit stand face eni wahala and dem no go fear. Today message of Hope wen bi numba tiree for de true kristian mata bi say make we dey do watin God tork.

View Details

Hawa family mata today na dey way wen husband and wife go take join bodi togeda come bi one for evrytin wen dem dey do. De message of Hope tell us say e get some kain tin wen we musto see for de life of pipo wen bi pipo wen dey tru-tru forlow God.

View Details

Today praya na still de univasiti teacha and govament mata and de eleshion wen dey come for 2023. De message of Hope dey tell us say de pipo wen we go call kristian today na pipo wen resembo Jesus.

View Details

Hawa fess song na kweshion wen say "God don wash you with Jesus Blood?" and de second one say "Fite de beta Fite" De message of Hope dey tell us say God pipo for de lass generashion go get Jesus kain karacta wen bi de ticket wen dem go take enta heaven.

View Details

Man wen sabi do good for outside but e no dey do for house and de one wen lazy na man wen go make marrage tiya woman. De message of Hope say de work wen Holy Spirit go do for de life of God pipo na anoda sign for de lass generashion.

View Details

Wen woman no born for marrage or e born so-so gel pikin, dat one fit make hin husband go marray anoda woman. De message of Hope dey tell us say anoda sign for de lass generashion bi say God pipo go dey preach hin word make pipo for save.

View Details

De sikness wen doktor dey call Prostrate Cancer wen dey do only man naim doktor forlow we tork today. Today message of Hope dey tell us say plenti sign dey wen we go see wen go hep us prepare bifor Jesus go come take us go heaven.

View Details

De message for hawa pikin dem na de lesin wen dem fit learn from de life of David and Goliath. Today message of Hope dey tell us say God pipo for de lass generashion go bi pipo wen dey pray and de commot bodi from sin.

View Details

De kain kain tin dem wen we sorpose dey pray make God do for hawa pikin dem life naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say de pipo wen go dey de last generashion go bi pipo wen no go dey swim hinside sin.

View Details

Hawa prayer today na for hawa univasiti dem, make God touch all de teacha dem plus govament make skool for open. De message of Hope dey tell us de kain pipo wen go bi God pipo for dis world bifor Jesus go come.

View Details

Hawa fess song today say make we do watin God tork "Obey de Lord" and de secon one say make we do God work "Work de Works". De message of Hope dey tell us say bifor Jesus go come make hawa life bi beta kristian life.

View Details

Man wen no sabi give woman moni or buy sometin for hin pipo na man wen woman sorpose look reach ground for de mata of marrage. De message of Hope dey tell us de kain kain tin dem wen we sorpose dey do as God pipo bifor Jesus go come.

View Details

Wen wife for house no dey do watin e sorpose do for hin husband, dat tin fit drive de man go enta anoda woman hand. De message of Hope dey tell us for bifor Jesus go come, God pipo sorpose Holy so dat dem go resembo God.

View Details

Headache na sometin wen dey do evrybodi, watin dey make head dey pain pesin and watin we fit do for dey mata naim bi today tork. De message of Hope dey tell us say bifor Jesus go come, God want make hin pipo piour for deir mind and watin dem dey do.

View Details

De tin wen we fit hep hawa pikin dem to do to take redi for de wahala wen dey front dey come naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say God want make hin pipo commot bodi from de yama-yama tin dem wen dey dis world.

View Details

Praya na de key wen fait dey take open door and wen husband and wife dey pray togeda, deir pikin dem no go fit loss. De message of Hope dey tell us say de way wen we dey live hawa life dey show de kain God wen hawa God bi.

View Details

Hawa praya today na for hawa family dem make husband and wife know God so dat fight no go dey deir house. De message of Hope dey tell us watin we go do wen go show say we tru-tru love God.

View Details

Today two songs dey tell us say wen wwe gada, God dey come meet us and wen we teach true God dey bless us. De message of Hope dey tell us say Jesus na de truth and wen we waka for truth we go get God beta korret life.

View Details

Man wen na only hinsef e dey tin for and wen dey carri shouda go up na man wen dey make marrage hard. De message of Hope dey tell us say pesin wen dey sabi forgive pipo wen do am bad tin na pesin wen get God beta korret life.

View Details

Anoda tin wen dey make man dem dey get plenti wife na de mind of "I musto do evrytin wen my mate dey do". Today message of Hope de numba five tin wen we must get if we wan get de beta korret life wen God dey give hin pipo na make we kontro hawasef.

View Details

De sikness wen we tork today na de one wen dey pain well well and e dey bend pesin hand and leg if dem no kwik treat am. Today message of Hope na say hawa sef must die so dat pipo go see God for hawa life if we want get God beta korret life

View Details

Na hawa mind we dey take do evrytin for dis life so make we no let yama-yama tin dey enta hawa mind. De message of Hope dey tell us say if we no get love for hawa life e no get enitin wen we go do wen go bi beta tin for God eye.

View Details

De kain karacta wen husband wen bi beta pastor for hin family sorpose get naim bi today mata. Today message of Hope say de beta korret waka wen we go forlow God waka musto make pesin bring hin bodi come ground and honbo.

View Details

Today praya na for hawa government pipo dem wen dey dey hawa borda, our govament and hawa soja dem make dem for work well make bad pipo no dey enta hawa kontree. De message of Hope say Love naim bi de beta korret road wen we go waka.

View Details

Today two songs na songs wen tork abat de pawa wen dey hinside God word and dem bi "Forever O Lord" and "Lord, I live by your Word" De message of Hope today dey tell us say plenti beta, beta gain boku yanfu-yanfu wen we dey do watin God tork

View Details

Anoda kain man wen woman no sorpose marray na dat man we dey look hinsef like oga kpata-kpata wen naim know pass evrybodi. Today message of Hope dey tell us say God law naim dey commot pipo from wahala bicos who do watin de law tork no dey enta trobo.

View Details

Anoda risin wen make man de gada many woman for hin life na bicos e dey forlow bad friend wen dey do dat kain tin. Today message of Hope dey ansa de kweshion weda de Law go fit save pesin commot for sin?

View Details

Watin pesin go do to take manage sikla sikness plus watin pesin fit do make e no get sikla sikness naim we tork today. De message of Hope dey ansa de kweshion of de law wen Jesus nail for de cross as hin take die for de cross.

View Details

De mata of kwik moni wen hawa pikin dem dey fine and how dem dey deceive pipo with fone, dey kill pipo sef naim bi today mata. Today message of Hope dey ansa de kweshion of weda de law of God don dey since abi na de time of Moses naim law take come?

View Details

Watin and watin husband sorpose do as de pastor of hin family and how e go take do dis work naim bi today mata. De message of Hope today dey show us de type of Law wen God get for hin pipo to forlow make deir life for beta.

View Details

Today praya na make God hep us stop all de pipo from odar kontree wen dey come here come kidnapp pipo and scata hawa kontree. De message of Hope de ansa de kweshion weda we still sorpose dey do watin God say make we do for hin Law.

View Details

Today two songs wen bi "Great are you Lord" and "Bigger than any Mountain" dey tell us say hawa God na big ogbonge God. De message of Hope dey tell us say hawa God big pass enitin or enibodi wen we fit tink for hawa mind

View Details

De kain man dem wen woman no sorpose marray naim bi today tork. Today message of Hope dey tell us say God love you and me and we sef sorpose love God too.

View Details

De tin wen dey make man dey marray or dey sleep with plenti woman naim bi today tork. Today message of Hope say make we put hawa life for Jesus hand bicos naim bi de Rock wen fit hide us make de wahala of life no reach hawa bodi.

View Details

De sikness wen pipo de call Sikla wen dey do pipo wen get ss blood and how pipo wen get de sikness go take know naim we hear today. Today message of Hope dey tell us say de day dey come wen God go give evrybodi de salary for watin dem do for dis life.

View Details

De kain tin dem wen today pikin dem dey do to take get kwik moni wen no good naim bi de mata today. Today message of Hope de enkorrage us make we humbo and fear God make God for fit bless us.

View Details

De work of pastor wen husband go do for hin family wen hin family go take know and forlow God waka naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say make we dey close de door wen devil dey pass come deceive us to do watin God say make we no do.

View Details

Today praya na make God save de pipo wen dem kidnap for de kaduna train and make e confort de family dem wen deir pipo die for de train. De message of Hope today na de ansa for de kweshion of life wen pipo wen confuse dey ask.

View Details

Hawa fess song today say na Jesus bi de hope wen we get and de second song say Papa we praise you bicos hawa life don beta. De message of Hope dey tell us watin we go do if we tru-tru want make God bless us yanfu-yanfu.

View Details

Watin we go do wen God show say we tru-tru love God as God want make we love am naim bi hawa mata today. De message of Hope today na praya wen we dey pray make God for give us dat one tin wen we don dey ans am tay-tay.

View Details

Praya wen we go praya make hawa pikin dem for get beta korret fushure na part of de foundashion for hawa family. De message of Hope dey tell us say make we no dey get two mind for God mata but make we get fait.

View Details

Sleep na somtin wen we dey do but de korret way wen we go take sleep and watin dey happun for hawa bodi wen we no sleep well naim bi today mata. De message of Hope dey enkorrage pipo make we get hope bicos God dey

View Details

De bad way wen boy and girl take dey play love wen no bi as God tork naim bi de mata for hawa pikin dem korna today. Today message of Hope dey advice we say make we arrange hawa waka well bicos Jesus go soon come and beni-beni waka na hell e go end.

View Details

Watin God mean wen e say make husband love deir wife naim bi de mata for hawa family korna today. Today message of Hope na two kweshion wen bi where I go go and watin I go do.

View Details

Make God remove univasiti tesha strike, make Prof. Soludo beta govanor for Anambra and make God stop de war wen dey Ukrain naim bi today praya. De message of Hope say wen Jesus come again, pipo wen still dey take sin rob bodi, deir own don finish.

View Details

Hawa fess song na "Through it all" and de second song na We've been made more than Conquerors". De message of Hope dey tell us say we no go worri wen we get fait wen we go take jump pass all hawa wahala

View Details

As we dey know God, one big tin wen we musto know bi say God love us well well. De message of Hope say make we endure, make we get patience bicos God no de time to take bless us.

View Details

Praya wen we dey pray for hawa pikin dem na korret beta foundashion wen we must put for hawa family dis year. De message of Hope dey tell us say Faith for hawa life no go let us worri even if watin we dey see no bi like say God dey hear hawa praya.

View Details

Korfee na tea wen pipo dey like drink but no bi sometin wen good for hawa bodi, so make we no dey drink am. Today message of Hope say wen we stand gidigba for fait we no go worri bicos pesin wen get fait go get watin e want from God.

View Details

For hinside love mata wen dey happun for hawa pikin dem, dem musto know de one wen God want make dem put deir hand. De message of Hope dey tell us say if we no go worri, we musto get faith and waka faith waka make God for bless us.

View Details

De big work wen God give evry husband na make dem love deir wife as God take love de church. Today message of Hope say we no sorpose worri bicos God don give us blessing yanfu-yanfu.

View Details

Today praya na make God for put hin hand for de eleshion wen dey come ness year and give us beta leda for hawa kontree and make pipo no die bicos of de eleshion. De message of Hope dey tell us say make we no dey worri bicos God dey.

View Details

Today two song na de hymn "What a Friend we have in Jesus" wen dey enkorrage us make we let Jesus carri hawa wahala and "Ancient Words". De message of Hope de tell us say we must bi pipo wen know God word if we want get de beta korret life wen Daniel get.

View Details

For hawa woman mata today, e good make we know as woman say Jesus don alredi wen devil and e come give us dey victory so make we waka for dat victory. De message of Hope dey tell us say pawa dey hinside praya bicos na praya Daniel take win.

View Details

Hawa area of praya for hawa pikin dem today na de kain friend wen dem dey make bicos friend dey fit spoil pesin. De message of Hope say make we tell hawa sef for hawa mind say we no go take hawa sef do yeye.

View Details

Cold watar no bi beta tin for pesin to drink bicos e dey make hawa bodi no dey work as e sorpose work. Today message of Hope dey tell us say Babylon pipo change Daniel name bicos dem want make e forget hin God but Daniel no gree forget God.

View Details

De tin wen pesin go do to take commot for hinside drink botto and ciga, igbo, wen dey kontrol hin life. Today message of Hope tell us say evrytin wen Daniel see for Babylon no resembo watin e know for Israel but Daniel still believe God.

View Details

Today na de korret rizen wen make God give us marrage naim bi de mata. De message of Hope dey tell us say all de wahala wen Daniel see for Babylon no fit change am, e still hold God kokoroko and hin fait strong for God word.

View Details

Today praya na for hawa ibo pipo dem and all de wahala wen dem dey get for hinside deir biafra mata, make God for hep dem. De message of Hope dey tell us say God get beta korret life like de life wen Daniel get wen e wan give all hin pikin dem.

View Details

Today praya na make God bless hawa family with plenti moni, make hawa pipo well and make family no scatta. De message of Hope dey tell us say make we no join odar pipo dey do yeye tin but make we stand with Jesus make hawa life bi like Jesus life

View Details

We take today song dem take tell God say nobodi bi like am for hawa life and na hin bi hawa light. Today message of Hope dey tell us say wen we weak and we no get pawa to take waka for dis life, God go give us pawa yanfu-yanfu.

View Details

Wen sin no dey hawa life, God go hear hawa praya and e go fight hawa fight dem and we no go dey run forlow wayo pastor dem. De message of Hope dey enkorrage us say wen we get troubo for hawa life, God go give us hin pawa take commot for de troubo.

View Details

As we go take pray for hawa pikin dem make dem come know Jesus even wen dem bi small pikin naim we learn today. Today message of Hope dey tell us say God dey give hin pikin dem pawa to take jump temtashion pass.

View Details

De beta beta tin wen fruits like orange, paw-paw, and all de odar one dem dey do for hawa bodi wen we eat dem. Today message of Hope dey tell us say anoda tin wen God no like for hin pikin dem bodi na wen dem dey sitdown luk and dem no dey do enitin

View Details

De kain way wen some bad pikin take dey make good pikin dem do bad tin and watin papa and mama fit do for de mata naim bi de tork today. Today message of Hope na de numba tiree tin wen God no like and dat na holi-holi karacta wen Jesus hand no dey.

View Details

For de husband and wife mata today, we hear say make evry husband take hin wife take do hin best friend. De message of Hope tell us say de numba two tin wen God no want see for hin pikin dem na laziness.

View Details

Today praya na for husband and wife dem wen de waka-waka dey carri odar pipo make God for save dem and save deir marrage. De message of Hope say de numba one tin wen God no want see for him pikin dem life na carelessness and i-don-care.

View Details

Today two song na "I live by your word" naim bi say na God word bi hawa life and "I'm a new creation" wen mean say we bi new pipo hinside Jesus. De message of Hope dey tell us say wen we dey do God work, we go dey young and God go make hawa life new.

View Details

Anoda tin wen we as woman go know abat God bi say God dey fit make hawa wahala ton to blessing for we. De message of Hope say make we no let de tins wen dey dis world dey hawa mind pass de tins of God

View Details

De kain praya wen we go pray for all hawa pikin dem wen dey go skool naim bi today mata for hinside hawa family foundashion. Today message of Hope dey tell us say God say make we no like de yama-yama tin dem wen dey dis world

View Details

Food wen we dey chop get hand for weda we well or we sick and light food na one beta food wen go make hawa bodi well and strong. Today message of Hope say make we redi to do watin God want even if hawa bodi no carri we.

View Details

Wen jogba don enta pesin blood, oyibo dey call am "addiction" and God fit save pesin wen jogba dey hin blood. De message of Hope dey tell us say de numba tiree work wen God want make we do na make we put God fess for hawa life.

View Details

De tin dem wen God want make husband and wife dey do for hinside marrage naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say anoda work wen God want make we do bi say make we give am all hawa life.

View Details

Today praya na make God con commot de strike wen ASUU take close univasiti and de petrol wen govament don add moni join. De message of Hope dey tell us say na de merci of God make us bi pipo wen dey do watin God want.

View Details

Hawa fess song today say make we dey do watin God tork "Obey Obey" and de second song say make we bi like de good samaritan "The good samaritan's song". De message of Hope dey tell us say God bless us make e for fit use us take bless odar pipo.

View Details

Anoda tin wen we as woman go musto know abat God bi say God no go give us load wen big pass we make we carri. De message of Hope dey tell us say God put hin propati dem for hawa hand make we take dem take make hawa life and odar pipo life beta.

View Details

De praya wen papa and mama go pray for deir babi wen dem just bon and deir small pikin dem naim bi today mata. Today message of Hope tell us say de pipo wen dey God kindom of Grace musto bi pipo wen de Holy Spirit dey change deir karacta.

View Details

De kain tin dem wen fit happon for hawa bodi if we dey soso dey chop meat naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say enibodi wen dey God kindom of Grace now musto dey do watin God say make e do.

View Details

De mata of jogba, watin e bi, watin dey make pipo dey do am and how e take bi bad tin for God eye naim bi today mata. Today message of Hope na de numba tiree for de tin wen God pikin dem sorpose know and do if dem wan go heaven wen Jesus come

View Details

Marrage as God plan am na make man and woman commot for deir papa and mama house come form deir own. Today message of Hope dey tell us say de beta tin for God kindom na de Word of God bicos na de Word dey change we.

View Details

Today praya na for hawa pikin dem make de yama-yama tin dem wen dey happon now no carry dem go hell. De message of Hope today na de parabo wen Jesus tell us wen e take show us how de kindom of God bi.

View Details

Today two songs na hymns abat fait wen we get for God and dem bi "My faith looks up to Thee" and "Standing on the Promises". De message of Hope dey tell us say make we take hawa fait take hold God bicos God go do watin e tork.

View Details

Make hawa woman dem know say God no get pesin wen dey advise am bicos hin na God and na hin plan hin dey do. De message of Hope dey enkorrage we say make we trust God bicos God no go eva leave we.

View Details

Praya for hawa pikin dem wen dem still dey hinside hawa belle na beta korret foundashion for hawa family. Today message of Hope dey tell us say make we no forget all de beta tin dem wen God don do for we bifor.

View Details

Make hawa bodi for well kankpe, today advise na for fat pipo and watin dem fit do to commot some fat from deir bodi. De message of Hope today de advise we make we believe God word and hin promise bicos if God tork am, e go do am.

View Details

De message for hawa pikin dem today na say God no want make dem dey put eye for feem wen man and woman for naked dey sleep togeda. Today message of Hope dey tell us say God na tork-na-do and hn promise dem no dey fail.

View Details

De korret way wen we go take tell hawa wife say we sorri if we do dem bad tin wen go make dem forgive we naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us as watin we go do wen hawa fait go take big as God want make e big.

View Details

Today praya na for de boko haram, kidnapping and all de odar kata-kata wen dey happon for hawa kontree make God for stop dem. De message of Hope today dey tell us watin fait bi and we must get fait to fit forlow God waka.

View Details

Today two songs na "Thy Word" wen mean "God Word" and "In times like these" wen mean "for de kain time wen we dey now". De message of Hope na de numba two for how we go take know true prophet and wayo prophet make nobodi for deceve we.

View Details

Make woman dem know say God pawa na de ogbonge pawa wen e dey take hold us so dat we no go fear enitin, we no go fall and we no go lost. Today message of Hope dey tell us say God word give us watin we go take know true prophet from wayo prophet.

View Details

Praya wen we go pray for hawa pikin dem dey de mata of beta foundashion wen we go put for hawa family. De message of Hope na de numba two wen we take hear how we go take forlow de truth

View Details

De kain korret beta food wen pesin sorpose chop wen oyibo dey call balanced diet naim bi hawa mata today. Today message of Hope dey tell us say God want make we forlow God true and Jesus wen bi de Truth.

View Details

De kain tin wen hawa pikin dem sorpose put for frong wen dem dey plan watin dem go do for fushure naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say God beta korret Spirit no bi de one wen pesin dey take fight, lie and tief take get

View Details

De kain kain tin dem wen husband fit do wen e go take setto wahala, fight and kakata for hin family naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us watin we go do to take get de beta korret Spirit wen God dey give hin pikin dem.

View Details

Today praya na make God touch hin pikin dem make dem commot deir hand from sin and make dem come bi like Jesus. De message of Hope dey tell us say God go give us hin beta korret Spirit wen Daniel and Joseph get.

View Details

Hawa two song today na message abat how God take give us de Sabat and watin and watin e say make we take de Sabat take do. Today message of Hope dey tell us say pipo sef wen forlow Jesus waka dem kontinue to kip de Sabat afta Jesus don go heaven

View Details

Make evry woman know say God dey fight for hin pikin dem so make we sef know say God go fight hawa fight for we. Today message of Hope dey tell us say God still want make we rememba de sabat and make we kip am as e say make we kip am

View Details

Make pipo wen de plan to marray take deir time look ground well to take choose de pesin dem go marray naim bi today mata. De message of Hope dey tell us say God rememba de Sabat and hin want make we too rememba de Sabat and kip am

View Details

De tin wen pesin wen get HIV sikness go fit do wen de HIV no go come ton to AIDS come kill de pesin naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say God rememba Rachael come giam pikin afta e don marray tay no born.

View Details

De lesin for hawa pikin dem today na how dem go take manage de bad vexnashion wen dem dey vex. Today message of Hope dey tell us say hawa God wen rememba hin pipo Israel for Egypt con send Moses go commot dem from suffa, go rememba you.

View Details

De kain tin dem wen husband fit do to take setto kata-kata for hin family naim bi de mata for ground today. Today message of Hope dey tell us say God no dey forget hin pipo and hin promise naim make am rememba Joseph con commot am from prison.

View Details

Hawa praya today na mke God hep make wicked pipo no dey kill hawa pikin dem for skool and make God put hand for de Sylvester wen dem kill case. Today message of Hope dey tell us say God dey rememba hin pipo and hin promise and God rememba Noah.

View Details

Today two songs na "In de Garden" wen bi song abat how we dey pray by hawa sef and "Now to Him" wen we take praise God bicos naim fit do evrytin for we. De message of Hope dey tell us say God want make we kontinue dey pray and make we no stop hawa praya.

View Details

Test and temtashion na part of life and God dey let dem happon bicos de tin we learn from dem dey make we beta pipo. De message of Hope dey tell us say wen we pray, hawa praya dey make us near God and know God well well.

View Details

De kain friend wen we choose to forlow waka go fit make we bi beta pipo or bad pipo so make we pray and choose beta friend. Today message of Hope dey tell us say if we want make God ansa hawa praya make we get patience.

View Details

De tin wen pesin wen get HIV sikness go see for hin bodi and watin we fit do make we no get HIV naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say even wen e bi like say God no dey ansa us, make we kontinue hawa praya as we dey wait for God

View Details

Vexnashion no be beta tin to get for hawa life bicos e no dey let us bi de pipo wen God want make we bi. De message of Hope dey tell us say if we want make God ansa hawa praya, we no go let fear enta hawa praya

View Details

Wen pesin get kata-kata for marrage no bi bad tin but how you take setto dey kata-kata naim bi de koko of de mata. De message of Hope dey tell us say if we want make God hear hawa voice and ansa hawa praya, we musto commot sin for hawa heart.

View Details

Today praya na bicos of petrol wen govment wan put for the moni, make God no let govment do watin dem plan make pipo for no suffa. De message of Hope dey tell us say if we sabi pray as God want, God go hear hawa voice for heaven and come ansa hawa praya.

View Details

Hawa fess song today na de song "Watin we don do" and de second song na "Hush". De message of Hope dey show us de praya wen Ezra pray wen God take protect am and all de pipo wen e carry commot for Babylon come back to Jerusalem.

View Details

Woman wen know God musto know say time go come wen e go bi like say God siddon for hin hand make e for no touch you. Today message of Hope dey show us how King Hezekiah take pray wen God come fight for am and de pipo of Israel.

View Details

Hawa life bi as e bi bicos of de kain tin dem wen we dey choose so for we to get beta life dis year make we choose watin God want make we choose. De message of Hope dey show we as Elijah take pray wen God take ansa hin praya with beta fire.

View Details

HIV na de sikness wen dey enta pesin bodi from blood and de sleep wen man and woman dey sleep togeda. Today message of Hope dey show us de kain praya wen King Solomon pray wen God take ansa am come give am watin e ask God.

View Details

Hawa pikin dem sorpose know say God get plan for deir life so make dem ask God for de plan and make dem forlow am. Today message of Hope dey show us as Prophet Samuel take pray amd make sacrifice wen God take from heaven scata de enimi of Israel.

View Details

De two tins wen remain for de five tins wen wife dem want make deir husband do for dem na say make moni dey and make deir marrage no scata. Today message of Hope dey show us as Hannah take pray wen God take ansa am give am pikin.

View Details

Today praya na for hawa family dem make God for join husband and wife togeda and put hand for deir plan dis year. De message of Hope today dey show us all de pipo for bybbo like Moses wen pray ogbonge beta praya wen God ansa shap-shap.

View Details

Hawa two praise song today na "On Christ de Solid Rock" and "Heaven come Down" De message of Hope de show us watin go dey happon for hawa life wen God Spirit tru-tru born we.

View Details

Today enkorragment na say make evry woman know say God dey see am and God know watin de happon and e know watin e go do wen life go take beta. De message of Hope de tell us say de Spirit of God musto born we and den we baptize.

View Details

Evrybodi want beta Change and wen we forlow God waka and do watin e say make we do, beta change go happon for hawa life dis year. Today message of Hope dey tell us say e no get eni sin wen God big forgiveness no fit commot for hawa bodi.

View Details

De kain way wen we sorpose to dey take drink minira and chop food naim bi doktor advice today. Today message of Hope dey hinkorrage us say God want make we de konfess hawa sin and if we konfess, God go forgive us.

View Details

Dey lesin for hawa pikin dem today na how dem go take commot deir ear from jaga-jaga music wen God no like. Today message of Hope dey tell us say we musto repent and repentance na say we turn commot for de road of sin con forlow God road.

View Details

Today family mata na five tins wen evry wife want make hin husband dey do for am. De message of Hope dey tell us how we go take get fait and den come make de fait grow make e for bi big fait.

View Details

Today praya na for de pipo wen dey manage moni mata for hawa kontree, small-small bizness dem make God give pipo sense wen go let moni mata beta dis year. De message of Hope dey tell us watin fait bi and how we go do wen go show say we get fait.

View Details

Today two songs na "Hawa hep dey hinside God name" and "God wen bi hawa hep". De message of Hope dey tell us say na God bi hawa hep.

View Details

Make evry woman know say de world no balance bicos na devil de kontrol de tin dem wen de happon for de world. Today message of Hope dey tell us say God plan wen e make us na say make we dey do watin go make God happi with hawa life.

View Details

Anoda tin wen we go know and do for hawa family wen family go take sweet na say dis life no balance and God get time for evrytin. De message of Hope dey tell us say we musto get sef Kontro and na de Holy Sirit fit go give us if we ask am.

View Details

De wahala wen fit happon for pesin bodi if e dey drink all dis mineral and malt dem enihow naim bi today mata. Today message of Hope dey ask us why we dey fear? God no want make we fear bicos hin dey hawa side.

View Details

De mata of dress and watin God wan see we dey wear naim still bi de message for hawa pikin dem today. Today message of Hope na kweshion abat watin de Cross wen Jesus for die mean for hawa life?

View Details

Na de tiree tins wen eni husband wen want make happiness dey hin house go know and go do naim bi today mata. De message of Hope dey tell us say e get de fait wen dey save pesin and na dat fait we sorpose get.

View Details

All skool don dey resume so we pray make God take hawa pikin dem go skool jeje, make God kip dem safe for deir skool and make strike no dey dis year. De message of Hope dey tell us say wahala full life but if we get Jesus for hawa life we go dey save.

View Details

Hawa two song today na "Emmanuel, God wen dey with us" and "Hawa God wen big gidigba". De message of Hope say God dey with us and e dey for us so no shaking. Hawa God, big, e strong kakaraka and e dey with us kokoroko

View Details

Make evry woman know say na God naim make am and na God naim get am so dat we go live de kain life wen God want dis year. Today message of Hope say na God dey hep us for evrytin we dey do but we no dey see God with hawa kro-kro eye.

View Details

God don bring we come new year but for de year to beta, we must luk as God take start life for Genesis take start hawa new year. De message of Hope say na Jesus bi hawa DaySpring wen come save us so make we forlow am waka so hawa life go get light.

View Details

De kain-kain tin dem wen we fit do wen no go let us fet dis sikness wen dey dey for de road wen piss dey pass for hawa bodi naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say na only hinside God naim we go fit happi and no get long throat.

View Details

God say make we wear dress wen go cova hawa bodi, wen we go take fine and wen go make pipo praise God. De message of Hope dey tell us say we get God wen we no dey see with hawa krokro eye but naim dey lead and guide we for dis life.

View Details

De komandment numba 10 and 11 wen husband wen wan happi for hin marrage sorpose know and do naim bi today mata. Today message of Hope say make we put hawa fait for god bicos God no dey fail lye-lye.

View Details

Today praya na thanksgiving praya say we don enta 2022 and make God do hin will for hawa life for de new year. De message of Hope dey tell us say we fit do all de beta tin wen we wan do if God put hin hand for hawa life.

View Details

Hawa fess song say hinside Jesus, we bi new pipo and de second song say Jesus naim bi de pesin wen dey carri us waka as hausa dey carri melu waka. De message of Hope say na only as we dey hinside Jesus Christ we go get pawa take bi beta christian.

View Details

De kain tin dem wen fit make kata-kata enta hinside de plan of man and woman wen dey plan to marray naim bi hawa tork today. Today message of Hope say de pawa wen we go take stand wen temtashion come dey for de praya we pray bifor de temtashion come.

View Details

De kain kain tin dem wen dey happon for de nite of hawa marrage naim bi today family mata. Today message of Hope dey tell us say make we no put anoda tin for God place for hawa life and make we no love dis world.

View Details

De tin dem wen dey make pipo dey get sikness for de area of deir bodi wen dem dey take piss and watin dem fit do make dem no get dis sikness naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say make we put God for de numba one posishion for hawa life

View Details

De lesin for hawa pikin dem bi say God no want make dem dey play wayo for exam but make dem read and God go hep dem. Today message of Hope say anoda tin wen bi numba for hawa life na make we teach de pipo we bring come church how to stay hinside Jesus.

View Details

De commandment numba 6 go reach 9 for de kain tin wen husband wen want make hin wife forlow am joli-joli sorpose know naim bi toady mata. Today message of Hope dey tell us say anoda tin wen we go put as numba one for hawa life na to tell pipo abat Jesus.

View Details

Today praya na for God to torsh de moslem pipo wen dey listin for hawa program and make God kip pipo safe as dem de travo and from fire. De message of Hope say make we do de first tin wen God want make we do dis year and dat na to preach hin word.

View Details

As today na new year, hawa two praise song for God na "God we carri you go up" and "Papa we praise You" Today message of Hope say as we enta new year so, make we waka and dey pray togeda as God pipo.

View Details

De tin dem wen man and woman wen wan marray go do for deir lass waka to take arrange deir marrage naim we tork today. Today message of Hope dey tell us say we musto commot yama-yama from hawa life and put God fess if we wan bi God beta pikin.

View Details

De tin den wen dey happon for hinside de evening of hawa marrage naim we tork for here today oh. Today message of Hope dey tell us say God fit come hinside hawa wahala come save we if we call am.

View Details

De mata today na de sikness wen consign de part of hawa bodi wen we dey take piss and how we go take know if we get am. Today message of Hope say make we no let yama-yama tin dem dey enta hawa mind.

View Details

De lesin for hawa pikin dem today na say God want make dem stand gidigba for God like Daniel and hin friend dem for Babylon. Today message of Hope dey tell us say we nid ondastanding for God word to take forlow God waka well.

View Details

De tin den wen husband wen want make hin wife forlow am happi and wen want make hin marrage sweet naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say bifor Jesus go come, plenti pipo go like de tin den wen dey dis world pass God.

View Details

Today praya na make God hep pipo wen dey owe odar pipo moni make dem fit pay and make God kip hin pipo for North safe. De message of Hope dey tell us say God don do all de work wen go make we fit go heaven so we no sorpose miss heaven.

View Details

Today fess song na "Halleluyah, Salvation and Glory" and de second song na "Jesus is coming". De message of Hope dey tell us say as we dey travo go home make we no let eni tin make us commot hawa trust from Jesus.

View Details

Courtship na time wen woman go take luk de man wen e like well well make e for know weda dem two go fit marray. De message of Hope dey show us two kain people wen pray and we learn say God dey ansa all hawa praya so make we try pray beta praya

View Details

Wen hawa pikin dem don big abd dem dey univasiti go up, we sorpose be deir friend so dat dem go fit dey forlow us tork well well. Today message of Hope dey tell us say God Holy and we wen bi God pikin musto holy too.

View Details

How we go take manage hawa stress sikness with de kain food wen we dey chop naim bi today mata. De message of Hope dey tell us say God get beta tins wen e wan give us wen we give Jesus hawa life.

View Details

De way wen we go take fit like de pipo wen no like us wen God say make we do naim bi de lesin for hawa pikin dem today. Today message of Hope say God as hawa beta papa get de diffren diffren kain way wen bi like kane wen e dey take korret we.

View Details

How we go take bi friend with pipo en no like us weh bi watin god want make we do naim bi de lesin for hawa pikin dem today. De message of Hope dey tell us say God as hawa beta papa dey let some kain tin happon for us wen bi like kain to korret we.

View Details

Hawa praya today na for all dey politics and de pipo wen dey hinside politics plus all hawa judge dem bicos of 2023 elekshion. De message of Hope dey show we as we go take resembo God for hin karacta.

View Details

Hawa fess song today na "It is so" wen bi "Na So" and hawa second song na "His Name is Jesus" wen bi "Hin name na Jesus". De message of Hope dey tell us say wen we dey pray make we tell God watin e tell us for hin word for hawa praya.

View Details

De kain tin wen woman sorpose know as e dey forlow man waka dey do frien-frien bifor dem marray naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us how we go take kontinue to live and pray as de Holy Spirit don show us.

View Details

De wahala wen moni mata and plenti pipo for house dey bring for de aftanoon of marrage naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say dey pesin wen sorranda hin life give de Holy Spirit naim bi spiritual pesin.

View Details

Today we learn say na stress sikness naim de make some small pikin dey sork hand, dey piss for bed and plenti odar tin dem wen hawa pikin dem dey do. De message of Hope dey tell us say God no dey ansa praya wen konsign only hawa belle.

View Details

Hawa pikin dem mata today na how dem go take make friend and de kain friend wen dem sorpose get. Today message of Hope dey tell us say we go sorranda hawa life kpata-kpata give de Holy Spirit make only hin dey lead we.

View Details

God say make we forgive and eni husband wen wan happi and wen wan make God ansa hin praya musto dey forgive hin wife wen e do a bad tin. De message of Hope dey tell us say God want make we know de Holy Spirit and make we dey do watin e tell us.

View Details

Today praya na for hawa pikin dem make God for protect dem for dis sesin so and make God give dem beta work for 2022. De message of Hope dey tell us say praya and de Holy Spirit na two beta gift wen God give us make we for fit bi God beta pikin.

View Details

Today fess song na "I bi new pesin" and de second song na de word of Joshua wen e tell hin pipo say "hin and hin family go serve God" De message of Hope na still de vow wen Joshua make for de front of hin pipo say hin and hin family go serve God.

View Details

De kain tin dem wen hawa girl pikin wen do commot for skool and don reach to marray sorpose know naim bi today mata. Today message of Hope dey show us how we go take fit beta pass as we bi and come bi de pipo wen god want make we bi.

View Details

Family dey change as woman dey bon pikin and as de family dey plenti na so de work sef dey plenti and dis one fit cus wahala for de house. De message of Hope dey tell us say wen we give hawa life to Jesus we musto grow con resembo Jesus.

View Details

De diffren kain stress sikness wen dey and de kain kain tin dem wen de make stress sikness dey do pipo naim bi today mata. Today message of Hope say make we no bi like de pipo of Israel wen no gree belive say God pawa fit give dem de promise land.

View Details

God want make hawa word dey make pipo life sweet like as salt dey make food sweet. Today message of Hope dey tell us say God dey see we and e know evrytin wen dey happon for hawa life.

View Details

Man wen wan make hin marrage sweet go give hin wife respet as e dey take tork to hin wife and plan de family with am. Today message of Hope dey enkorage us make we kontinue to pray even wen e bi like say God no dey hear.

View Details

As Christmas dey come, moni wahala go come full house so we dey pray make God for put peace for hawa family. De message of Hope today dey tell us say make we no dey worri for enitin bicos God fit give us watin we want.

View Details

Hawa fess song say "my soul dey quiet" and de second song say "God go take care of you" De message of Hope tell us say Daniel na pesin wen know God word and if we sef go know God word we go get de koret beta life of Daniel

View Details

Watin mama and papa wen get girl pikin wen dey univasiti sorpose do wen go make de pikin bi beta pikin naim bi today mata. De message of Hope tell us say praya na one big tin wen make Daniel get de koret beta life wen e get.

View Details

Weda wife sabi cook and weda e fit cook de kain food wen hin husband mama cook dey train hin pikin na sometin wen woman sorpose know. De message of Hope tell us say Daniel get beta plan for hin life and e no gree do bad tin wen odar pipo dey do.

View Details

Watin be stress and how pesin wen get stress go take know say hin get stress naim be today mata. De message of Hope na de numba four lesin wen we see for the life of Daniel wen make am get de koret beta life wen God sef want make we get.

View Details

God make de world with hin word and den e make us make we resembo am so we sef get pawa for de word wen we dey tork. De message of Hope na de numba tiree for de koret beta life wen Daniel get and how we sef go fit get dat life.

View Details

De kain way wen husband sorpose to take forlow hin wife waka for marrage for evrytin weh e dey plan and do naim bi today mata. Today message of Hope na de numba two for hinside de mata of de koret beta life wen Daniel get.

View Details

De wahala wen dey hawa life now dey make pipo wan krase so naim make we pray today say make God give us peace for hawa mind. Today message of Hope na de koret beta life wen God give Daniel and how we sef go fit get dat life.

View Details

Hawa fess song today say God big pass eni wahala wen we fit get and de second song say make we put hawa bodi for God hand wen dey gidigba. De message of Hope say Jesus hawa shepad dey protect us make notin like wahala or kata-kata for do we.

View Details

De kain tin wen mama wen get girl pikin wen don get brest and don dey ton to woman sorpose tell hin pikin naim bi today mata. Today message of Hope say Jesus hawa Shepad dey give us rest from all de wahala wen dey dis life and de rest na de Sabat.

View Details

De wahala wen woman dey see wen e no kwik bon pikin and watin we fit do for dat kain wahala naim bi hawa family mata today. Today message of Hope dey tell us say Jesus wen bi hawa shepad naim dey give us pawa nd dey make us strong.

View Details

De tin wen all os us fit do wen no go let us get dis kouf sikness wen dem dey call tobakolosis naim bi hawa mata today. Today message of Hope say Jesus dey gada we wen bi hin sheep make we no for scata, make we no for loss.

View Details

De kain sense wen pesin wen get handwork sorpose get wen go make am fit use de handwork take do beta tin naim bi today mata. Today message of Hope say Jesus wen be hawa Shepad no dey let us hungry bicos hin dey give we beta food to chop.

View Details

God want make husband dem put all deir mind and bodi for hinside deir marrage and make dem carri deir wife for deir hat. Today message of Hope say Jesus wen bi hawa shepherd dey commot we from evry wahala and kata-kata.

View Details

Today praya na make God bless hawa pipo with moni to take chop and make pipo marrage and family no scata. De message of Hope say Jesus na hawa shepherd and e come dis world come look for us to save us.

View Details

Hawa fess song say we go enta God gate with praise and de second song say wen we reach heaven, evrybodi go happi for deir. Today message of Hope say de numba seven work wen de Holy Spiirt dey do bi say naim dey make us know say we bi God pikin

View Details

Papa and mama go buy de diffren tin wen girl pikin sorpose get as e dey big make de girl pikin for bi beta pikin tomoro. De message of Hope wen bi de numba six work wen de Holy Spirit dey do bi say e dey hide we hinside Jesus.

View Details

De way wen family pipo and friend take dey chuk mout for pipo marrage wen fit scata marrage naim bi today family mata. Today message of Hope say de numba five tin wen de Holy Spirit dey do for we bi say e dey put us hinside Jesus Christ as we baptise.

View Details

Today na de kouf sikness wen doktor dey call tubakolosis, how de sikness bi, and how pesin go know if e get am naim bi hawa mata. De message of Hope wen bi numba four for de work wen Holy Spiirt dey do for we na say e dey hep we pray.

View Details

We hear today say oyibo skool good to go but we musto get handwork wen we go take sorpot oyibo skool. Today message of Hope dey tell us say de numba tiree work wen de Holy Spirit dey do for we bi say e dey show us how we go take waka.

View Details

Today, de beta beta tin wen go happon for pikin wen get beta papa and watin e go enjoy for dis life naim bi hawa mata. De message of Hope say de numba two tin wen de Holy Spirit dey do bi say e dey take God word take hep us commot sin for hawa life.

View Details

Today praya na for pipo wen get sikness like diabetis, cancer, etc make God heal dem and make God remove covid from hawa world. De message of Hope dey tell us say one work wen de Holy Spirit dey do bi say e dey make us know wen we sin so we go repent.

View Details

Today song dem na praise for hawa God wen bi de only true God and make we get de hat to dey worship God. De message of Hope dey tell us say make we dey do good for pipo.

View Details

De wahala wen dey for girl pikin life and watin evry mama go fit do make hin pikin for no see wahala naim be today mata. Today message of Hope say make we find God and forlow am as we dey read hawa Bybo and dey pray.

View Details

Today na some of de wahala wen husband and wife dey see for de morning of deir marrage naim we tork. De message of Hope dey tell us say e get de repent wen be de corret repent wen God want make we do.

View Details

How we go cook hawa food wen we go take get de vitamin wen dey to take hep de soja wen dey hawa bodi naim bi hawa mata today. De message of Hope dey tell us say make we no dey take hawa mind do sometin but make we do watin God word want make we do.

View Details

We hear today say oyibo skool na beta tin and pikin wen go skool de sabi do beta tin. Today messae of Hope say God dey with us for all de tin wen we dey see and wen dey wahala us so make we get strong mind bicos God dey with us.

View Details

De resin wen make am bi say pikin musto get beta papa naim bi de mata today. Today message of Hope say God dey happi wen we dey do watin e say make we do.

View Details

Hawa praya today na make God put hand for hin work make pipo for give deir life to Jesus and make pastors for dey preach trut. De message of Hope dey tell us say God put pawa for hawa mout so make we no use an enihow.

View Details

Hawa two song today na abat how we go take put hawa hat and life for God hand. "Humbo my hat" and "I sorenda" nai be de song dem. De message of Hope na de numba two for hinside de message of how we go take trust God and de plan wen e get for hawa life.

View Details

De tin wen dey man mind abat woman naim de show for how man dem dey do eni woman wen dem see and de one wen dey deir family. Today message of Hope dey tell us say make we trust God with hawa life and make we belive say God plan naim beta pass for we.

View Details

For hawa family mata today, na as husband and wife do take join bodi and bi one as god want naim we tork. Today message of Hope dey tell us how we go take fit know watin bi God plan for hawa life.

View Details

De tin wen we fit do and wen we fit chop wen go make de soja wen dey hawa bodi strong kakaraka naim bi hawa mata today. Today message of Hope na how we go take know watin bi God plan for hawa life.

View Details

Today we hear say as we dey wear dress for bodi na so hawa spirit sef sorpose wear dress and de dress of hawa spirit na praye and God word. De message of Hope today na abat how we go take fit do de tin dem wen dey hinside god plan for hawa life.

View Details

De kain tin dem wen beta papa go dey do wen hin and hin pikin dem go take fit waka sweet waka togeda. Today message of Hope say Jesus do all de tin wen hin papa God plan for hin life and we do go fit do watin God plan for hawa life.

View Details

Today praya na for hawa leda dem from oga presido Buhari go and all de pipo wen dey forlow am work and hawa judge dem too. De message of Hope dey tell us say god get beta plan of watin hin go do for hawa life so make we no fear.

View Details

Today fess song say make we look as God big reach "Behold" and de second song say make we try dey kind to pipo. De message of Hope tell us say Jesus want make ebi say we dey do for pipo de kain tin wen we hawasef go like make pipo do for we.

View Details

De kain kain wahala wen woman dey get for dis world bicos dem bon am as woman naim be hawa mata today. Today message of Hope dey tell us say wahala dey front dey come and only de pesin wen hin life dey hinside Jesus our Rock naim go fit stand.

View Details

De diffren levo wen dey marrage, de wahala wen dey and watin we fit do make hawa marrage no scata naim be de mata today. Today message of Hope say na only two road naim dey; make we choose de one wen we go take get life even wen plenti pipo no dey deir.

View Details

Doktor advise na say make pipo go take de korona sikness injekshion so dat dem no go sik reach where hospito and oxygen go enta deir mata. Today message of Hope say de small small beta beta tin wen we dey do God dey see am and e go bless us.

View Details

De message for hawa pikin dem bi say make dem no dey drink bad drink and make dem no smoke bicos bad drink and cigar dey scata bodi. Today message of Hope say hawa good karacta and work wen we dey do naim dey show Jesus light for de world.

View Details

De tin wen papa fit do wen hin and hin pikin dem go take bi paddy-paddy. Today message of Hope say God pipo naim bi de salt wen dey make de world beta place bicos of de good good tin wen dem dey do for de world.

View Details

Today praya na make God bless hawa friend dem wen dey listin for deir work and make God protect dem make wahala nor reach were dem dey. De message of Hope say God get beta blessing for hin pipo wen devo dey wahala and kill bicos dem dey forlow Jesus.

View Details

Today fess song na "O Lord, You kind" and de second song na "To know you". De message of Hope dey tell us say wen we dey obey God Law, e dey show say we know who God bi and as we know who hin bi, we no go do watin go vex am.

View Details

De kain tin wen woman fit do wen e see sign say trobo won enta and scata hin marrage naim bi hawa mata today. Today message of Hope tell us say wen we dey kip God commandment, we dey take am tell God say we love am.

View Details

De fight for pawa for hawa house dey bring kata-kata, make husband and wife bring deir bodi come ground for each odar make marrage no scata. Today message of Hope say God don give us pawa wen we go take fit obey hin Law and dat pawa na God Grace.

View Details

Watin we see for dis covid-19 mata today bi say virus don dey with us since and na so dem de change so dat we no go fit kill dem. Today message of Hope dey tell us say na de ten commandment wen bi God Law naim e go take judge evrybodi.

View Details

Today message of hawa pikin dem bi say make dem no dey worri bicos worri no go fit change eni tin for deir life but make dem trust God. De message of Hope wen be numba tiree for God Law dey tell us watin make God give us hin Law.

View Details

De mata for de papa mata today bi say pikin sorpose get beta papa wen go fit help de pikin be beta pikin tomoro. Today message of Hope dey tell us say na de 10 commandment naim bi God Law wen e take love take give us.

View Details

Today praya na still de mata of how God go take stop de kilikili and help bring de pikin dem wen dem carri come back. De message of Hope dey tell us say God give us hin Law bicos e love us.

View Details

Hawa fess song today na song wen we take tell Jesus all de bad tin wen we do "Konfeshion song" and hawa second song na "I be new pesin" Today message of Hope dey tell us say wen we give hawa yama-yama life to Jesus, hin go come give us new and beta life.

View Details

For hawa woman mata today, we tork abat de kain kain sign dem wen we fit see wen go tell us say kata-kata won happon for hawa marrage. De message of Hope say God na Love and God sef want make we waka for hinside love bicos we be hin pikin.

View Details

Pesin wen say e know watin e no know dey bring wahala for marrage; e beta make we ask kweshion, make we tork togeda make we for know. Today message of Hope say make stay for church with God pipo make we for no loss for dey wahala wen dey come for front.

View Details

De kain sikness wen dis covid-19 sikness bi and watin dey injeshion wen dem say make we take so go do naim bi de mata today. Today message of Hope say God don dey mark dey pipo wen bi hin own as e make dem for Egypt for Moses.

View Details

Hawa pikin lesin today bi say make dem dey do beta tin bicos enitin wen dem do today go wait for dem for front tomoro. Today message of Hope dey tell us say good and bad, God and devil dey fight for hawa life and na dis be de big wahala wen we dey.

View Details

De message for hawa papa dem today na say make dem dey live de kain life wen dem pikin go fit imitate. Today message of Hope tell us say na only Jesus go fit commot de sikness of sin for hawa bodi and na dat be de corret healing wen God wan give us.

View Details

Today praya na for all de trobo wen IPOB dey do for South-East of niajeria, bizness wen no dey waka for dat side and for eleshion for Anambra. De message of Hope today na kweshion weda we go gree give hawa life to Jesus make we for save.

View Details

Today fess song na "My God make I near you wel-wel" and de second song na "I dey waka and I no go look back" De message of Hope say as we dey hinside Jesus dey waka with am make we shine hawa eye make notin commot us from Jesus.

View Details

Make woman no commot for marrage bicos hin husband no dey do watin e sorpose do for am but make e pray and God go chang hin husband. Today message of Hope say God don give us watin we go wear wen go give us pawa take fight and win de devil.

View Details

Wen sorri-hat no dey for marrage e dey bring wahala but make we no bicos of dat one scata marrage, make we pray and God go hear. De message of Hope say wen we dey hinside Jesus, satan go dey fight us but make we no fear, Jesus dey with us and we don win

View Details

De place wen fat dey dey for hawa bodi, watin de fat dey scata for hawa bodi and watin we fit do naim doktor tell us today. Today message of Hope say wen we dey hinside Jesus, the Holy Spirit go work for hawa life.

View Details

Eni pikin wen won bi beta pikin go read de Bybo bicos na only de Bybo fit change bad pikin to be good pikin. Today message of Hope say wen we dey hinside Jesus, de Holy Spirit go dey hinside we and e go dey make us resembo Jesus for hawa life.

View Details

De numba one work wen God give papa na make e teach hin pikin make de pikin know God and forlow God. Today message of Hope say wen we dey hinside Jesus and we read de word of God, God go take hin word take wash sin commot for hawa life.

View Details

Today praya na for God to come help we commot for all de sikness dem like cholera wen de kill pipo for hawa kontree. De message of Hope say make we dey hinside Jesus like branch of tree dey gun de tree.

View Details

Today fess song na "Hin name na Jesus" and de second song na "Nobodi bi like Jesus". De message of Hope tell us say Jesus na de only road wen we fit waka pass go mit God.

View Details

Woman wen bicos hin husband dey carri plenti woman commot for hin marrage no wise and dat no be beta tin to do. Today message of Hope tell us say na war front we dey and make we wear de army dress wen God give us make we for fit fight hawa fight well.

View Details

Jesus advise na make we love hawa nebo as we love hawa sef, na dat bi de cure for family wen one pesin dey tink of only hin sef. Today message of Hope tell us say na Heaven sin for stat wen Lucifa forlow Jesus fight and God con drive an commot for Heaven.

View Details

Plenti fat for bodi na wahala for who get am bicos e fit make pesin get sikness wen cure no dey and e fit kill pesin too. Today message of Hope dey tell us say Lucifa,with hin long trot naim bring sin but Jesus come save us commot for sin.

View Details

De lesin for hawa pikin dem today na say wen pesin do dem bad tin make dem forgive de pesin make God for fit forgive dem too wen dem sin. Today message of Hope dey tell us say wen God tork, hin word musto happon as e tork am.

View Details

Evry pesin get papa but how man take dey be papa and watin be de work wen papa sorpose do as papa? De message of Hope dey tell us say make we know watin dey de word of God and make we put de word for hawa hat and do watin e say make we do.

View Details

Today praya na for pipo wen dey sick, pipo wen get accident and doktors wen dey strike make God make dem come back. De message of Hope dey tell us say God word dey change pipo, dey make hawa life beta for here and go give we life wen no dey end.

View Details

Hawa fess song na "I just wan dey where you dey" and de second song say "Jesus dey come" De message of Hope dey tell us say time no dey again, Jesus go soon come so make we use hawa time take do beta tin for God.

View Details

Pikin wen woman no bon foe hin husband fit make deir marrage scata but God no want dat kain tin. Make dem adopt pikin. Today message of Hope dey tell us say de die wen Jesus die na to commot us from sin so make we no dey waka for sin again.

View Details

Make we commot bad belle wen we no know watin bring am come make we for fit waka well for hinside hawa marrage. De message of Hope dey tell us say wen we dey de place wen God day, we go get strong hat and fait to do watin God say make we do.

View Details

De kain tin wen we go fit do for pipo wen bad medcin wen dem take don dey worri naim doktor tork today. Today message of Hope dey tell us say if we put God word for hinside hawa hat, devil no go fit commot us from de place wen God dey.

View Details

De kain dress wen God want make we wear na dress wen fine and wen go make pipo praise God. Today message of Hope dey tell us say wen we dey de place wen God dey, we and God go con bi padi and God go dey forlow us tork.

View Details

Man wen no like to change from hin old life and wen like de tin dem wen dey dis world pass God no go fit be pastor for hin family. Today message of Hope dey tell us say if we dey de place wen God dey, God go setto eni wahala wen we get and we no go fear.

View Details

Today praya na say make God scata bandits wen dey plan to enta Christian side for Nigeria. De message of Hope dey tell us say make de won tin wen we go porsue for dis life bi make we fit dey for de place wen God dey.

View Details

Today songs na "More precious than Gold" and "The Law of the Lord". De message of Hope say sabat make we remeba say na God make we and God still dey make pipo today as e dey commot bad tin for pipo life.

View Details

Woman wen chuk leg for horside go sleep with anoda man na woman wen hin husband fit drive commot for marrage. Today message of Hope dey tell us say as God no dey change and e no dey die na so hin Sabat Law sef no dey change and e no go die.

View Details

We hear today say if we know watin we sorpose know for marrage, we no go dey get Kata-kata wen fit scata marrage. De message of Hope show us today de Law wen aposto paul say Jesus nail for hin cross for hinside Col. 2:14-17.

View Details

De kain medcin wen pipo dey carri take like brukutu, ogogoro wen dey scata pesin bodi naim doktor tork today. Today message of Hope dey tell us say de day wen we dey take go church naim dey show weda we dey obey God or human being.

View Details

De lesin for hawa pikin dem today na say make dem know say pawa dey deir word so make dem no tork enihow bicos watin dem tork fit happon. Today message of Hope for de mata of de sabat wen world pipo change, we don see de wayo wen dem take change de sabat.

View Details

Man wen luk hinsef say hin no bi beta pesin wen God go like no go fit forlow God waka and e no go fit bi pastor for hin house. Today message of Hope na still de mata of God sabat wen e give human being wen world pipo change.

View Details

Today praya na for God to commot all de kata-kata wen don scata plenti family make husband and wife con come togeda again. De message of Hope na de mata of de day wen God say make we take go church wen pipo change from satorday go sunday.

View Details

Hawa fess song today na "hawa life dey stat for God hand" and de sakond song say "Papa, we praise You bicos you don make hawa life beta". De message of Hope say God no change de sabat and bifor Jesus go come again, hin pipo go kip hin sabat.

View Details

De kain kain tin wen fit make man waka commot for marrage give hin wife naim bi hawa mata today. Today message of Hope dey tell us say God give we Sabat make we for rest an even for de new heaven, we go still kip de sabat.

View Details

One tin wen we musto do if we wan setto kata-kata for family na make we dey bear de tin dem wen we no go fit change by hawasef. Today message of Hope dey tell us say Jesus aposo dem kip de sabat even afta Jesus don go heaven.

View Details

De kain kain sign dem wen we go see for de bodi of eni pesin wen don dey take medcin wen e no sorpose take naim doktor tork today. Today message of Hope hep we know de tru-tru day wen bi de sabat day wen God say make we for rest.

View Details

God wen make human being, get plan for am and if we go gree forlow God plan for hawa life, we go get beta life bicos na God get de ogbonge plan for hawa life. Today message of Hope say de sabat na de mark wen God dey mark hin pikin dem wen dey dis world.

View Details

We don hear say na man be pastor of hin family but many man no be pastor for deir family bicos dem no get sweet belle for God mata. De message of Hope dey tell us say God make rest take dash human being for de day seven wen e don make evrytin finish.

View Details

Today praya na for hawa fama dem make God bless watin dem plant and make melu fulani dem no carri deir melu go scata fam dem. De message of Hope dey tell us say God make rest forlow de tin dem wen e make for de gaden of eden.

View Details

Today two song na "De Biatitudes" and "kount yor Blessing". De message of Hope, de numba seven for de pipo wen God tru-tru bless na de pipo wen dey do peace for eniwere dem dey.

View Details

Today advice na for old mama dem wen deir husband die leave and de kain kain tin wen deir pikin fit do for dem wen go make dem happi. De message of Hope wen be numba six for de pipo wen God tru-tru bless na de pipo wen get piour hat.

View Details

De tin wen pesin won see for hin marrage wen no dey deir today, go fit dey tumoro if we pray and trust God. Today message of Hope, de numba five pipo wen God tru-tru bless na pipo wen get sorri hat for odar pipo dey show meci.

View Details

Wen pipo take medsin wen doktor no say make dem take, na drug abuse dem dey call an and naim be hawa mata today. De message of Hope, de numba four kain pipo wen God tru-tru bless na de pipo wen dey do evrytin make dem for resembo Jesus.

View Details

De lesin for hawa pikin dem today na make dem hear deir papa and mama word make watin do Samson no go do dem. Today message of Hope de numba tiree pipo wen God tru-tru bless na pipo wen resembo Jesus for de way dem dey forlow odar pipo waka.

View Details

Won big work wen God give man as husband and papa na make e dey show beta exampo of how God bi give hin family. De message of Hope, de numba two for de pipo wen God tru-tru bless na de pipo wen dey cry and wen sorri for de bad-bad tin wen dem do

View Details

Today praya na for all hawa pikin dem wen dey write exam now make God let dem pass beta pass wen dem go take go de ness klass. De message of Hope dey tell us de pipo wen God go bless and today na de pipo wen know say na only Jesus fit save dem.

View Details

Today two songs na Blessed be the Lord God Almighty and de song of praya make God draw we hinside were hin dey. De message of Hope dey tell us say na now now we sorpose give hawa life to Jesus bicos e no go tay now probation go close and Jesus go come

View Details

Today advice naim be numba two for de kain tin wen woman wen wan marray again afta hin fest husband die sorpose know. De message of Hope de tell us say we don dey see evrytin wen Jesus say go happon bifor hin come so make we repent forlow Jesus

View Details

To setto kata-kata for family, e go good make we tork watin dey hawa belle bicos na tork dem take dey setto mata. Today message of Hope dey tell us say plenti wahala dey front so make we shine hawa eye and pray as Jesus say mke we do.

View Details

De kain kain tin dem wen fit make pesin get hipotenshion and how we go take manage de sikness naim doktor tell us today. Today message of Hope, de numba two for de praya wen God de ansa dey tell us say if we true true pray, God go ansa.

View Details

Today, na de life of Joseph naim we for learn lesin for de mata of watin you plant naim you go avest. De message of Hope today dey tell us say make we be pipo wen dey pray like Jesus bicos na only praya we go take ovacome temtashion.

View Details

De work of pastor for family wen God want make evryman do and how man go fit take do de pastor work naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say as we dey wait for Jesus, make we shine hawa eye make we for no fall hinside sin.

View Details

Today praya na for de Covid-19 sikness wen still dey evrywere de kill pipo and for hawa doktor dem wen don commot hand for work. De message of Hope de tell us say one big true wen we sorpose know bi say Jesus con commot us for sin.

View Details

Today two song make us rememba how we happi wen Jesus save we and we go get dat kain happiness wen we reach heaven. De message of Hope dey tell us say God love naim make Jesus die for we and dat love go make am give us enitin we ask am.

View Details

De tin wen yong woman wen hin husband don die sorpose know if e say e wan marray anoda husband naim be today mata. Today message of Hope na de numba two for watin make God love us and dey tke care of us.

View Details

Watin we go do as wife wen we go take setto kata-kata wen we dey forlow hawa husband get naim be hawa mata today. De message of Hope dey tell us say God love we pass bird dem wen dey fly and e go give we watin we want if we ask am.

View Details

De small broda of Hipatenshion wen doktor call Hipotenshion, watin e bi and how e dey do pesin naim be hawa mata today. Today message of Hope dey tell us say Jesus naim be hawa shephad and e no go leave us and e no go forget us.

View Details

For hinside de mata of watin we plant naim we go avest, de wahala wen King David bring for hin family naim we look today. Today message of Hope na Jesus parabo of de pikin wen waka commot for house and we see say hin papa run go bring am come house.

View Details

God get plan and work wen make am make man as husband and papa and na dis God plan naim we wan to dey tork for here. Today messge of Hope na still watin God do and watin e fit do to take save sinna as we see for de parabo of moni wen loss.

View Details

Today praya na for hawa big pikin dem make God give dem beta work and make dem fit marray beta marray. De message of Hope na Jesus parabo wen sheep for loss wen show us say God don do evrytin and e still de do evrytin to save we

View Details

Today song "Marvelous Grace" and "Only be Grace" dey tell us say na only God Grace go save we. De message of Hope na de ansa wen bybo get for pipo wen dey ask say watin dem go get if dem kip God law sef?

View Details

Hawa message today na for hawa sista dem wen no dey deir husband house but deir marrage neva scata finish. Today message of Hope na de ansa wen tell us why bybo say de commandment na law wen dey free us.

View Details

Wen meni wife dey vex for deir husband, dem no go gree sleep with am, dat na deir beta koboko to pornish deir husband. Today message of Hope na ansa for de kweshion wen say, if de Law no fit save pesin, why God say make we still kip de Law sef?

View Details

Watin pesin go do wen e no go take krase and watin pipo wen get krase for family fit do to manage de mata make e no spoil naim be doktor advise today. De message of Hope na de ansa for de kweshion of whish law naim bybo tork say dem nail put for de cross?

View Details

De lesin of watin pesin plant naim e go harvest naim we see for the life of Cain and Abel wen be Adam and Eve pikin. Today message of Hope show us de diffren-diffren kain of Law wen God get and we see say na de ten commandment be de ogbonge one.

View Details

Family mata today na advise wen no go let husband and wife get kata-kata wen man take dey beat wife for family. Today message of Hope na de ansa for de kweshion wen pipo dey ask say weda de commandment dem dey bifor God write am give Moses?

View Details

Today praya na for all hawa man dem make dem for know Go and make God for bless dem with plenti moni. De message of Hope today na ansa for de kweshion of weda we still sorpose dey kip God law for dis new testament church.

View Details

Hawa songs dem today wen consign de word of God na "De word of God na pure word" and "Foreva, God word don settle". De message of Hope na watin God tork say make we do for hinside hin commandment number nine and ten.

View Details

De tin wen make we get plenti women wen neva marray and watin dis hawa sista dem fit do wen go make dem marray naim be hawa mata today. Today message of Hope na watin God tork for hinside hin commandment numba six, seven and eight wen e want make we do.

View Details

De kain kain tin dem wen wife dem take dey punish deir husband wen fit bring kata-kata come dey marrage. Today message of Hope na watin God tell us for hinside commandment four and five for de ten commandment

View Details

Doktor tork today na de kain krase wen fit do woman we bon pikin and de one wen dey make pesin dey see and hear watin doar pipo no dey see and hear. Today message of Hope na de fess tiree commandment for de ten wen God give us and watin dem mean.

View Details

De lesin for hawa pikin den today na say wen dem go shuch, make dem rememba say God dey deir, make dem no dey do enihow. Today message of Hope dey tell us say Jesus die for us and we born again no mean say we no go obey God Law.

View Details

Family mata today bi say husband and wife sorpose mit but no bi say man go do am like eba and egusi wen pesin go chop evryday. Today message of Hope say God law wen e give us dey save hawa life like fence for brige wen no dey let motor cova side for riva.

View Details

Today praya na for all de Baptist skool pikin to come back and make boko haram no stat deir wahala again for Borno state. De message of Hope today say de law of God and love dey waka togeda and you no go fit get one wen de odar one no dey

View Details

Song numba one today na "we dey here to praise You Baba God" and de numba two song na "make we carry Jesus name go up". De message of Hope na de numba tiree wen God take dey tell us say make we no get long trot for bad tin make we no for die bad die.

View Details

Hawa woman mata today na special message for hawa sista dem wen no dey husband house. God want make dem marry. De message of Hope na still de mata of long trot and we hear say we fit get long trot to know and do watin God tork for hin word.

View Details

Some woman dey wen get pawa and dem dey fit beat deir husband. Watin husband go do dat kain wife wen go make de wife beat am naim be today mata. De message of today na de numba two for de mata of long trot for bad tin wen God no want make we get

View Details

De kain tin dem wen fit make pesin head ton con make am dey krase naim be watin doktor tork today. Today message of Hope dey tell us say make we no get long trot for watin God no give us and watin God no wan make we get.

View Details

De mata for hawa pikin dem today na say enitin wen you do go come back come meet you. Pesin no go plant pepe come harvest yam so make we wise. Today message of Hope de show us de kain fast wen God wan make we dey fast.

View Details

For hinside de kata-kata wen dey dey for marrage, husband dem wen no dey take care of deir wife naim be de mata wen we put mout today. De message of Hope say de numba one tin for hawa life na make we find God kindom and waka hinside.

View Details

De praya dem wen hawa pipo wen dey listin for de program send come say make God give dem work and make e repair deir marrage naim we pray today. Today message of Hope say make we put hawa mind (trust)for God; make we no waka hawa own waka.

View Details

Hawa two song today na abat de word of God. De fess one na Give me de Bybo and de sekon one na Take de word of God with you. De message of Hope dey tell us say na only de pipo wen do watin God tork go enta heaven and na dem go chop from de tree of life.

View Details

De story of de woman wen do watin hin husband tork and how God con take dat one take save hin husband teach we say God dey bless pipo wen dey obey hin word. Today message of Hope dey tell us say na only Jesus fit save bad pipo and commot dem from bad tin.

View Details

Today mata na de kain tin dem wen wife dem ike make deir husband do for dem wen go tortorri dem wen bodi go take sweet. De message of Hope say bad pipo dey do bad tin bicos dem don troway God Law and dem no dey gree do watin God tork.

View Details

Today, doktor dey tell we say plenti tin fit happon for pesin brain wen fit no be say de pesin dey krace bot na still wahala e bi. De message of Hope dey tell us say na bicos pipo no dey fear God naim make dem bad and dey do bad bad tin for kontree.

View Details

De lesin for hinside dis David and Goliath story today na make we know de word of God bicos naim be de sword wen we go take win de devil. Today message of Hope na de five step wen we go take get savashion wen be de gift wen Jesus give us by hin grace.

View Details

Wen sontin happon and husband no gree tork hin mind and con dey forlow hin wife kip enimi for house na bad wahala be dat. Today message of Hope say na Jesus naim die for hawa sin and na only hin blood fit klin hawa sin and give us peace with God.

View Details

Praya today na make God give hawa govonor dem for North beta sense and make God give hawa pipo beta pawa make dem fit win dis bandit wahala. De message of Hope dey tell us say na Jesus be de pesin wen fit give we peace for hinside dis kata-kata world.

View Details

De song dem wen we take praise God today say make we no let stone take hawa chance wen we dey praise God and God na God wen dey up up. Today message of Hope say make we kontinue dey grow for hinside praise and make praise no finish for hawa mout.

View Details

De lesin for hawa story today na say God go fiate hawa fiate if we quiet and let am fiate for we. Today message of Hope say make we kontinue to dey do de work of God and come resembo Jesus wen hin food na to do God work.

View Details

Meni man like deir work pass deir wife and pikin and dis one no bi beta tin bicos work and moni no go fit do watin human being go do. De message of Hope say god want make we grow for hinside praya and make we come dey pray as Jesus pray.

View Details

We hear today say wen pesin too sleep, e go good make dey pesin see doktor bicos dat tin fit bring big wahala come for bodi. De message of Hope say make we grow for hinside de good news wen bybbo dey call Gospel as we dey forlow Jesus.

View Details

We learn today say wen we get watin we wan do make we no let family pipo or friend dem diskorage us. De message of Hope say make we kontinue to dey grow for hinside Love so dat we go resembo God wen bi Love.

View Details

Wen man dey lie for hin wife head wen oyibo dey call false accusation dey bring kata-kata wen bad reach fight for family. Today message of Hope say God want say as we dey forlow am, make hawa faith sef dey big.

View Details

Today praya na make God commot all de pikin dem wen still dey for kidnappers hand, Leah Shaibu and make god scata de pipo wen dey sell human being body like meat. De message of Hope dey tell us say God want make hin pikin dem de grow for hinside grace.

View Details

Wahala dey come and hawa two song "Stand on de Rock" and "Shelta for de tyme of wahala" dey let hawa fait strong for God. De message of Hope say God pipo wen go dey de world wen Jesus come go be pipo wen resembo Jesus for evrytin.

View Details

De story of wicked papa wife wen God let hin wickedness fall for hin head dey teach us say God dey see and God go pay us for de tin dem wen we dey do. Today message of Hope say de Holy Spirit go helep we so dat de devil no go fit make us fall.

View Details

Wen woman no like de kain friend wen hin husband get and de husband no gree leave de friend dem, e dey bring wahala come de house. De message of Hope dey tell us say de ogbonge tin dem wen dey tell us say Jesus dey come don dey happon.

View Details

Doktor message today na watin pesin fit do wen go make am fit sleep beta sleep. De message of Hope dey helep we rememba say Jesus don tell us de tin dem wen go happon bifor hin go come.

View Details

De lesin today na say wen we know watin God fit do make we no dey fear but make we stand with fait. Today message of Hope, dey tell us say de last pipo wen go stand for God for dis world go be pipo wen no go dey swim for hinside sin.

View Details

De kain Kata-kata wen fit happon for house wen husband dey curse hin wife enihow. Today message of Hope na de numba two for de mata of de kain pipo wen go be God pipo for dis world bifor Jesus go come.

View Details

Today praya na for hawa pikin dem wen dey for skoul make God no let kidnapa reach where dem dey. De message of Hope dey tell us say God pipo wen go dey dis world wen Jesus come go bi pipo wen resembo Elijah

View Details

Today song na "Precious Lord, take my hand" and "Days of Elijah" and dem be song wen we take put hawa fait for Jesus. De message of Hope dey tell us say Grace door go close so make we forlow God well well.

View Details

Hawa story na de story of woman wen no wise come let anoda woman nearly commot am for hin husband house. De message of Hope wen be numba six dey tell us say de pipo wen Jesus go come take go hin kindom na pipo wen go get Jesus kain karacta.

View Details

Man wen dey let hin family dey take hin wife no slipas no be beta man wen woman sorpose marray. Make man be man for hin house. De message of Hope wen be numba five say as we dey ready for Jesus to come make we begin resembo Jesus for hawa karacta.

View Details

De kain-kain tin dem wen fit happon for pesin bodi if e no dey sleep beta sleep naim be de mata today. Today message of Hope na de numba four and we dey hear say na special pipo wen God go take hin spirit mark naim e go take go heaven.

View Details

De ogbonge lesin for hawa pikin dem bi say make dem put deir trust and fait for God and only God. Today message of Hope, de numba tiree say e no go tay now Jesus go come bicos all de sign wen we sorpose see don dey happon finish.

View Details

Stress fit make man beat hin wife but we dey advise say make man manage hin stress bicos evrybodi naim get stress. Today message of Hope wen be de saycon one dey tell us say make we be like Esta for bybo wen tanda for God wen kata-kata come.

View Details

Today praya na for Imo state and de wahala wen dey happon for dat side make God for elp commot de wahala. De message of Hope dey tell us say de tyme wen we dey now na wahala time and na only as we put hawa life for Jesus hand we go dey fit tanda.

View Details

Hawa two song dem bi de hymn "Nearer my God to Thee" and "Trust and Obey". De message of Hope dey tell us say make hawa waka with God no bi like de farisee dem own but make hawa rightousness bi de one wen Jesus dey give.

View Details

We fit see trobo but make we no fear becos God dey hawa side and e go deliva we from eni wahala wen devo bring come. De message of Hope dey tell us say wen we stay hinside Christ, we go get de righteousness wen Jesus dey give

View Details

Man wen dey tork plenti tork, wen hin word no dey finish na man wen hin wife and pikin dem no go fit respet. De message of Hope tell us say Jesus put hin God pawa for korna come be human being like we make e for fit show us exampo to take forlow God.

View Details

De tiree levo wen dey dis sicness wen dey do pesin wen no dey sleep beta sleep naim bi de mata wen doktor tork. Today message of Hope tell us say Jesus na God and na still human being and even say we no fit undastand am, na watin God do to save us be dat.

View Details

Today lesin for hawa pikin dem bi say, make dem fear God, make dem no put hand for sin and God go fight deir fight for dem. De message of Hope say make we know Jesus and make we get strong mind for watin Jesus do for we so dat we go get hin righteousness.

View Details

Man wen wise no go take de tork wen odar man dem tork for beer parlor take manage hin family. De message of Hope say na Jesus Christ be hawa righteousness and if we accept Jesus with fait, God go give us hin righteousness

View Details

We still dey pray for de pipo wen dey for South-East wen be Ibo pipo make God for commot kata-kata from deir land. De message of Hope today say righteousness and work be like 5 and 6 for hawa life and na faith we go take do dem two.

View Details

Hawa fest song say nothing go fit commot we from Jesus and hawa song song say make we stand on tope of the Rock wen be Jesus. De message of Hope say make we no doubt watin God tork becos enitin God tork say e go do, e go tru-tru doam.

View Details

Hawa story today na de story of two pipo wen believe say if Jesus say Yes for sometin, nobodi go fit say No. De message of Hope dey henkorage us make we get strong mind for God and hold hin word tight and we go see mirako wen God go do for hawa life

View Details

Man wen dey carri shoda go up get pride and pride no go let am be beta husband and papa for hin family. Today message of Hope dey tell us say pesin wen no rememba watin God do for am yestaday no go fit get enitin from God today.

View Details

Insomnia na de sicness wen dey do pipo wen no dey sleep beta sleep and deir sleep no dey plenti reach watin deir bodi want. De message of Hope today say God choose we and e love we with de love wen no go finish for dis life

View Details

Wen lion shout pipo dey fear and na Jesus be de korret Lion wen beat de devil scatta so make we no dey fear de devil empty shout. De message of Hope dey give us strong mind for God becos we know way God no go ton hin back for hin pipo

View Details

Wen husband and wife no fit tork de same tin and dem no get de same mind naim be misundastanding and na de numba three tin wen de make husband beat wife. Today message of Hope say we fit put hawa fate for God promise becos God na tork and do.

View Details

Today praya na for hawa ibo pipo dem wen dey for Anambra make God for commot all de wahala and kili-kili wen dey deir. De message of Hope say make we know watin God say e go do for we for hin word and make we put hawa fate for dat hin word.

View Details

Today two song dey tell us say God word no dey change ( Forever O Lord...) and hawa God naim strong pass (Our God is Stronger). De message of Hope tell us say wen we sick, God reddi to make us well becos naim be hawa healla.

View Details

Wen Jesus say "Yes", human being no go fit say "No" and na dat strong mind de sista for hawa story take marray hin husband. Today message of Hope dey tell us from de Bybbo say God want make we hep de poor pipo wen dey hawa family and community.

View Details

Man Jealousy don make some man kill deir wife so make evry man commot hin hand from jealousy make family for no scata. Today message of Hope dey tell us say Jesus naim be de beta friend and hepa wen we get so make we give am hawa wahala.

View Details

De advise for hawa tongue mata today na watin we go dey do make hawa tongue for well so dat we go fit use am wel-wel. Today message of Hope show us for Bybbo say repentance na make we commot for bad tin and bad waka come forlow God.

View Details

De numba seven tin wen God no wan see na aproko and tafia wen dey fit scata friend and family. Today message of Hope dey show us say God want make we get strong mind for hin word and if we no get dat strong mind, we no go fit forlow God waka.

View Details

Today na de kain tin dem wen dey cause de kata-kata for family wen husband dey take beat wife naim we tork. De message of Hope today dey show us how bad tin take enta hawa world and hawa life and who devil be.

View Details

Today praya na for all hawa Vigilante, Police, Air force and Army, make God protect dem from pipo wen dey carray kill dem. De message of Hope today dey tell us saw pawa det hinside de word of God so make we believe God word.

View Details

Hawa hymns today na "More about Jesus" and Nearer My God to Thee" and dis na songs wen dey make us put hawa eye for Jesus. Today message of Hope say make we dey with Jesus and wen Jesus come e go take us go stay with am.

View Details

Hawa story today na de story of husband and wife wen waka kurukere waka wen dem two take born pikin for howside but God help dem fit forgive each odar. Today message of Hope dey tell us say even wen life hard, we fit still happi becos we get Jesus.

View Details

Man wen get vision na man wen know watin e wan take hin life do and how e go manage hin family well and dis kain man dey make hin wife happi. De message of Hope today say make hawa waka with Jesus resembo Jesus waka for dis world.

View Details

De kain tin dem wen dey happon for hawa tongue wen fit make de tongue no do dey work wen God put am for hawa mouth make e do naim be today mata. Today message of Hope say make we carri Jesus go up make pipo see Jesus for hawa life.

View Details

De numba six tin wen God no wan take eye see na lie-lie pesin and God want make we dey always tork true. Today message of Hope say make we be like Jesus becos say we be christian mean say we be like Jesus

View Details

For hinside de family mata today, we hear say de way wen wife dem de take tork to deir husband naim dey bring beat come meet dem. Today message of Hope say make we win Christ. Dat one mean say make we do evrytin to take get Jesus for hawa life.

View Details

Today praya na for de pipo wen book haram and bandit don drive commot for deir village and de pipo wen dey help govment wen wahala happon for kontree. De message of Hope today dey tell us say make we know Jesus.

View Details

Today two songs na "Oh Lord How you kind reach' and "Turn your eye look Jesus". De message of Hope na de word of God wen go help pesin wen man take byforce forlow sleep so dat de pesin no go tink say hin own don finish for dis life.

View Details

To see beta friend today hard but hawa story na de story of beta friend wen help save hin friend marrage wen be won scata. De message of Hope na God advise for pipo wen don marray wen go make deir marrage no scata.

View Details

Husband wen no want wahala for hin house musto get plan for hin own life and plan too wen e go take make hin family beta. Today message na advise from God word wen pipo go take arrange deir marrage make deir marrage no for scata.

View Details

De tongue na special part of hawa bodi and change for de color and size of de tongue de show say sicness don enta bodi. Today message of Hope na God word wen go help pipo wen dey drink dey fall for gutta commot for hinside de drink wahala.

View Details

De message for hawa pikin dem be say God no like pipo wen dey run go do bad tin so make hawa pikin dem dey mind where dem dey waka go. De message of Hope na God advise for papa and mama wen get pikin wen no dey hear word, wen stubborn.

View Details

For family mata today, we hear say make man no dey beat hin wife and even wen e dey beat pikin, make e no wound am. Today message of Hope dey enkorrage we say if hawa pesin die and na christian, we go see am again wen Jesus come.

View Details

Today praya na for God to commot pipo wen dey kill and kidnap from hawa kontree and make God help all de pipo wen dis wahala don reach deir bodi. De message of Hope today dey tell us say de only tin wen go fit make hawa life beta na wen Jesus come.

View Details

Today two songs na "Shoe wen we dey take travel" and "My home wen Joy dey". De second song na Itsekiri song. De message of Hope na de parabo wen Jesus take show us watin go happon to evrybodi wen hin come again.

View Details

Today story na how one family with God love take put girl wen be ashawo, for deir house, come send am go skool and today de girl don be beta pesin. De message of Hope say, before Jesus go come, hawa world go bad like as e bad for Noah.

View Details

Wen woman lazy for family, plenti tins go spoil, de husband and pikin dem go suffa and wahala wen fit take life fit happon for de family. Today message of Hope tell us say plenti wahala go happon to christians before Jesus go come so make we get faith.

View Details

Hawa tongue and de kain tin dem wen fit happon to hawa tongue naim be de mata today. Today message of Hope dey tell us say pipo wen be hawa family and friend for church go fit do us bad tin but make we no let dat one commot us from church.

View Details

De numba four tin we God no wan take eye see na pipo wen dey siddown dey plan bad tin for deir mind. Today message of Hope dey tell us say de kain tin wen pastor and prophet dey do naim we go take know weda dem be beta pastor and prophet.

View Details

Today mata na de kain kata-kata wen man dey give hin wife and pikin dem wen fit be fight, beat wen no good, wen dey happon for family. De message of Hope dey tell us say wayo pastor and prophet go plenti before Jesus go come.

View Details

Today praya na for de moni mata becos now de kontree don borrow full ground and wahala dey front dey come. De message of Hope dey tell us say for hinside de kata-kata wen go shele before Jesus go come make we no fear, make we get strong hat.

View Details

Hawa two song today na "How I go take fit tru-tru tell Jesus say I love am" and de hymn wen say "Jesus I dey commot for my sin and yama-yama come meet you" De message of Hope dey tell us how we go take commot from enitin wen put us for de prison of sin.

View Details

De lesin for today story na say make mama put eye for hin pikin make bad tin no for do hawa pikin. Today message of Hope dey call evry bodi wen dey jump pian-pian-pian, dey sleep with enitin make e come meet Jesus wen dey commot pesin from sin

View Details

Laziness na bad tin for man and e dey pain woman well well wen hin husband no dey do enitin to bring moni come de house. De message of Hope dey tell us say de good news wen we dey call de Gospel get pawa to take commot pesin from sin and fear.

View Details

De bad stress dey fit make husband and wife no born pikin and e get hand too for many bad sicness wen no get cure. Today message of Hope make us know say Jesus go come and wen e come e go build hin kingdom we hin pipo go dey.

View Details

Anoda tin wen dey ton God belle na pipo wen dey open eye kill pesin wen no do dem enitin as Cain do take kill Abel for Bybo. De message of Hope dey tell us say enibodi wen dey do watin God say make e do, God dey bless dat pesin

View Details

For hinside de mata of how hawa husband dem go take safe, de advise be say make dem no take pesin wen dey vex hot vex take do friend. Today message of Hope dey enkorrage us make we decide for hawa mind watin we go do and make we do am.

View Details

Today praya na say make God come help us fight dis pipo wen we no know wen dey worry de full Nigeria. De message of Hope dey tell us say na God word be watin we fit take fight de devil so make we put God word for hawa heart.

View Details

Today two songs, "Dis na my papa world" and "Na only God" na songs wen we take praise God becos naim make evrytin wen we dey see. De message of Hope wen be numba seven for de tin wen God do wen life start be say God bless evrytin e make.

View Details

Today story na de story of mama wen take bad word wen e dey tell hin pikin take push de pikin go kill hinsef. De message of Hope, numba six tin wen God do be say God divide day and night. God na day, devil na night, God no want make we waka for night.

View Details

De wayo face wen we dey take hide hawa true karacta as we dey pretend na sometin wen dey vex pipo. Today message of Hope na de numba five tin wen God do wen life start and na say God call de tin wen e make and God dey still de call us today.

View Details

De bad stress wen doktor call Chronic stress and watin we go do make we no get am naim be de mata today. Today message of Hope na de numba four tin we God do wen life start and na say God look see say evrtin wen e make good

View Details

De second tin wen God no like na tongue wen dey tork lie and na only God Spirit fit teach us how to tork true. Today message of Hope na de numba three tin wen God do wen life start and na say God tork and as e tork na so de tin dem be.

View Details

For de mata of how man go take save, make man no wicked anoda pesin becos e tink say e get pawa and nobodi fit doam enitin. De message of Hope say for de seven tin wen God do wen life start, de numba two tin be say God make diffren diffren tins.

View Details

Today praya na make hawa pikin dem for beta, make de one wen finish skool get work and make God commot boko haram and dem pipo from hawa kontree De message of Hope say God do seven tin wen life start and de numba one tin na say e make evrytin.

View Details

Today two songs say we get 10,000 reason to take praise God and hawa God na big God. De message of Hope dey tell us say God mercy no dey look as we bad reach. Enitime we come meet God with sorray hat, e go forgive us.

View Details

De lesin for today story be say make we no tork watin we no know and make we no dey spoil pesin name with lie-lie story. Today message of Hope de encourage us say God mercy plenty well well and e fit forgive all hawa sin if we come meet am.

View Details

E good make woman undawear dem dey klin make de woman for no smell or get sicness and make hin husband for happi. De message of Hope dey ginger us say e no mata how many sin we do, God still readi to save we if we come meet am.

View Details

De two kain stress and de diffren area for hawa life wen we for dey get stress naim doktor forlow us tork today. Today message of Hope dey tell us say make we live hawa life de way God want so dat de day God go open hawa book we no go cry.

View Details

De lesin for hawa pikin dem today na say God no dey like pipo wen dey carri shoda go up de proud. Today message of Hope de tell us say God dey see evrytin we dey do and one day we go tell God how we waka for dis life.

View Details

For hinside dis mata of how man go take dey safe, make man no dey do gbagbati for area but make e dey do peace. Today message of Hope say make we rememba say God don put one day wen we go take tell am watin we take hawa life do

View Details

Today again we pray for de family dem wen husband and wife for get kata-kata and for bandit wahala for Nigeria. De message of Hope dey tell us say one day we go tell God how we waka and watin we do with the life wen e give us.

View Details

Today two songs wen we take praise God na "We go sing" and God pawa pass all odar pawa". De message of Hope dey still dey tell us say make we shine hawa eye becos many wayo pipo dey now wen dey say dem be Jesus christ and prophet.

View Details

De woman wen be beta woman wen want make pipo take beta eye take look am go be woman wen sabi kontro hinsef. Today message of Hope say make we dey shine hawa eye becos wayo pipo dey evrywere. Make we no let enibodi play us wayo

View Details

Dirty no good for pesin bodi becos dirty dey bring sicness. How pesin go take klin for hin bodi and cloth wen e dey wear naim be hawa mata today. Today message of Hope say na two kain pipo dey hear God word and de beta one na de one wen do watin e hear.

View Details

Stress na de sicness wen dey enta bodi wen pesin no fit manage de chemica wen God put for hawa bodi to help us wen we see watin make us fear or worry. De message of Hope dey tell us say Jesus say make we shine hawa eye make wayo prophet dem no deceive us.

View Details

God part for de moni and odar blessing wen e give us naim we dey call tithe and God want make we giam hin tithe. De message of Hope for de sermon wen Jesus preach for de mountain say make we struggle to enta heaven becos de road no go easy.