yellowplaylist is host by pidginradio.com giving you topten Nigerian songs.
if you love Nigerian Music and you want to know the song that is trendning . and what people are saying about trending songs you need to listen through and if you love pidgin English you need to listen too.
Yellowplaylist na programme inside we radio Listen via www.pidginradio.com where we dey talk about top 10 most listened and trending Nigeria songs .
and our special guest go dey yarn us about ,the bad the truth and the ugly about the songs,
this week episode na jim donnet come join us for we radio ,
oya Listen make you hear wetin jim talk about all this 10 songs .
With all the all things wey dey shele inside the naija music industry, and how e dey affect everybody wey dey involve, Babatunde Makinde Williams aka Gidi, don yarn say all artistes are ungrateful. Person wey be Artiste manager, media business guru and CEO of Gidioti Empire, talk dis on top the YellowPlaylist show wey Mary Arobo aka Dauntless host for Pidgin Radio.
He come as ogbonge guest to gist and talk about the ten trending songs wey make am to the playlist. He talk yafun yafun tins about Artistes and their songs. " All Artistes are ungrateful, as a talent manger , have another hustle that brings income apart from the management, if you do this, your artiste will respect you"
He yarn about celebrities and their lifestyle. He talk say e dey wrong say artiste go sign another artiste wey dey sound like am. He talk say such artistes no fit grow their brands and make cool money. " If you sign an artiste that has your sound, then you don't want his growth, sign different artiste wey him brand fit kpake money and deals apart from music ". He talk say C black na wrong signing for Naira Marley record label wey be Marlians Records.
Gidioti kon do wella, by saying Naija music don travel without visa. Afro music don dey recognize, but everybody- Artistes, managers, and Publicist get more work to do. He advise all upcoming Artistes to choose a sound, know their market and believe wetin Dem do.
Yellowplaylist is a radio program by www.pidginradio.com
is radio show talking about the top10 Nigerian Songs
where you learn and we criticize there songs .
if you want to learn about Nigeria Pidgin english
you will need to listen .