Pidgin Parlor na centre of crypto education and culture for the African pipul wey dey speak Pidgin. The show go dey break down plenti crypto concepts wey just dey confuse person into simple forms wey everyday African go fit dey relate with. And all these things go dey for pidgin, the localized language wey over 75 million Africans dey speak. This pidgin parlour crypto podcast dey bring crypto education and culture come inside street."Pidgin Parlour is the centre of crypto education and culture for the everyday pidgin-speaking African. The show breaks down complex crypto concepts into bite-size, easy and simple-to-digest content for the everyday African. And this is all done in pidgin, a localised English spoken by over 75 million Africans. Piding Parlour Crypto Podcast brings crypto education and culture to the streets"
As bull run don show, mani pipo go like shook head for inside the crypto market becos plenty opportunity don come, however as una dey plan to make moni, na so scammer dey also plan to scam mani Pipo.
Na why e better make una sabi di tinz wey you suppose know for di market and una fit DYOR so una no go shook your leg inside scammer trap.
For dis episode we gada talk:
1.)Wetin be bull run
2.)Di first tin wey you suppose sabi if you go shook your moni inside any project.
3.) How you fit DYOR and ape in correctly.
4.)Di tools wey you go need to do well.
If dis mata interest you, make una download and listen.
Enjoy this episode🎉
Disclaimer - beware
Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.
Thank you
Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour
Subscribe to our newsletter : https://pidginparlour.substack.com/
Join us on telegram https://t.me/pidginparlour
Real world Assets
Who go believe say dem go ever approve ETF for di crypto space, dis mata go loud!.
As you don hear say dem don approve BITCOIN ETF, e just be like say dem dey cap cause ETF na mata wey dey popular with Stock, bond, and other investment fund and no be Crypto.
However, as dem don approve dis model, everibodi dey happy because e mean say plenti Pipo go like shook mouth for inside crypto.
For dis episode we gada talk:
If dis mata interest you, make una download and listen.
Enjoy this episode🎉
Disclaimer - beware
Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.
Thank you
Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour
Subscribe to our newsletter :https://pidginparlour.substack.com/
Join us on telegramhttps://t.me/pidginparlour
Happy new year all of na wey dey follow us for Africa and we dey happy say all of una don enter 2024 and you dey kampe.
As our culture be for pidgin parlor we go like give una update for everything wey we do for 2023 and wetin you suppose expect for di new year.
So make una sit down as we gada reason wetin dey happen for pidgin parlour.
Oya download, make una listen and give your Pipo too.
Enjoy this episode🎉
Disclaimer - beware
Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.
Thank you
Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour
Follow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z
Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w
Learn more about crypto and web3 on awa websitehttps://banklessafrica.com
Join us on telegramhttps://t.me/pidginparlour
How pesin go pay $1million for pictures, wey una fit just carry anywhere?
Na wetin layman dey ask be dat when dem hear about NFT, so today we wan check wetin be NFT and how una fit profit from dis mata in crypto.
We don go carry Arrow come studio today as Im dey give us NFT alpha for dis episode
For dis episode, una go understand.
If dis mata interest you, make una download and listen.
Enjoy this episode🎉
Disclaimer - beware
Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.
Thank you
Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour
Follow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z
Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w
Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/
Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S
Join us on telegram
https://t.me/pidginparlour
ReFi, wey oyinbo Pipo dey call Regenerative Finance, dey change di world. Dis one no be lie o, na correct matter.
Many Pipo wey dey web3 dey do DeFi, Desci, NFT, Degen, but only small % dey reason ReFi…
Di reason be say ReFi no dey run as others dey behave, but as una go dey hear for dis episode ReFi dey change Pipo life and many Pipo no even sabi…
Na why I call one maxi wey dey di ReFi space make Im come tell us about am.
For dis episode, una go learn…
If dis mata interest you, make una download and listen.
Enjoy this episode🎉
Disclaimer - beware
Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.
Thank you
Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour
Follow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z
Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w
Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/
Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S
Join us on telegram
https://t.me/pidginparlour
If you no know, Pipo wey dey outside web3 don dey shook dia moni inside di market now…
As everywhere don dey green small small, one question wey una dey ask be say where all dis moni dey come from…
Na where Assets wey dey for correct world(Real World Asset) show face be that.
Dem dey give Pipo wey dey outside web3 chance to shook dia money inside di market. Una dey feel di gist Che?
So for dis episode we gather reason.
If dis mata interest you, make una download and listen.
Enjoy this episode🎉
Disclaimer - beware
Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.
Thank you
Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour
Follow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z
Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w
Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/
Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S
Join us on telegramhttps://t.me/pidginparlour
Una don hear about De-Fi, Re-Fi and De-sci, but today we wan talk about Social-Fi. If you dey CryptoX, you go realize say this narrative dey common as everyone dey talk about it and many founders too dey create product along this line.
Na why I follow Scar reason this mata be dis, as we talk about.
If dis mata interest you, make una download and listen.
Enjoy this episode🎉
Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.
Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica
Wetin una dey do every day na im dey make Pipo achieve success, oyinbo Pipo dey call am "Consistency". Even for dis web3, if una go make am, u no fit do without am. For dis episode our ogbonge host and Vykthur_X gada discuss di mata of consistency. You go learn :* Wetin consistency be and how u fit run am. * 2 things you must know about web3 if you go dey consistent. * How you fit show up daily even if you dey busy
If dis mata interest you, make una download and listen. Enjoy this episode.Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica
Una don hear about De-Fi, Re-Fi and De-sci, but today we wan talk about Social-Fi. If you dey CryptoX, you go realize say this narrative dey common as everyone dey talk about it and many founders too dey create product along this line. Na why I follow Jay-1 reason this mata be dis, as we talk about.* Wetin we social-Fi and how e dey work? * Wetin be solid examples of social-fi and how we fit position for dem. * Wetin be di future of dis niche for blockchain industry.
If dis mata interest you, make una download and listen. Enjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica
Hope dem neva collect your iris take give you token?? Haha, Oya relax make we gather reason dis mata, una don hear the buzz of dis world coin mata as e fill di internet. Every one dey reason say wetin di founder of dis project dey try do, some Pipo dey bullish about di project, while others just dey vex for di idea. Na why I follow my guy "Scar" discuss for dis episode be that on top dis World Coin mata. We Join reason:* Who be di founder of this project? * Wetin be di idea behind dis project? * Wetin be Pipo concern about it? * E go succedd or e go fail?
If dis mata interest you, make una download and listen. Enjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica
Money mata for web3 na serious talk, cause e dey possible make a person wey be founder get beta project idea wey go bring beta solution for dis space, but if e no get money. Dat idea don die before dem begin. So for dis episode, we gather talk how founders fit get access to beta funding for dis web3 space. You go learn :
If this mata interest you, make una download and listen. Oya go download and listenEnjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica
As we don talk am before say blockchain get plenty things wey we fit use am for. Many Pipo don hear about DeFi, NFT, and others, but una don hear about "DESCI". Wetin dey sup? For dis episode our guest na di founder of Desci Africa, dem dey try build Desci for Africa - dis one go make research wey dey happen for science decentralized. Omo, dis one shook me for body… For dis episode you go learn:* Wetin be decentralized science. * Di problem wey im dey try solve. * Some projects wey don dey do well under dis niche. * How you fit begin to contribute for dis mata.
If this mata interest you, make una download and listen. Oya go download and listenEnjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica
Una don see hear wetin we talk for the 1st part of this topic, how tokenomics dey important for di success of any project. Today we go dey reason Optimism ecosystem and see wetin dey happen for their tokenomics and wetin one or two projects fit learn about thier ecosystem tokenomics You go learn:* Some terms for tokenomics wey go let you understand the subject better. * How Optimism Tokenomics dey work. * Wetin be the downside of tokenomics. * How you fit shook your money inside di ecosystem, if you want buy(NFA)
If this mata interest you, make una download and listen. Oya go download and listenEnjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegramhttps://t.me/banklessafrica
If any project /pesin go win for this web3 dem suppose understand wetin be branding and how dem suppose make people like dem. All dis thing na im dey call branding, and na di difference between pesin wey go charge $5k or someone wey go charge $5.For dis episode, Our guest wey be branding expert, tell us how pesin fit begin and grow their brand for dis web3 space. You go learn:
If dis mata interest you, oya go download and listen. Enjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica
If you wan understand if any crypto project na ogbonge, you must to understand the tokenomics. This matter no dey complex at all, yet im be like say many pipo no under am. If una remember how dem teach us economics for primary school, na dat same model tokenomics follow dey work. As an investor, if you know Sabi wetin tokenomics be, you fit go put your money for wetin go burn your finger, na why for this episode Crossvic & Bintuparis gather discuss dis mata. If una listen to dis episode you go learn :
If you wan understand this Matter in toto, Oya click the link and download, you go thank us later. Oya go download and listenEnjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica
Edon tey wey Pipo don dey talk about regulations for the crypto space. Some Pipo talk say the thing dey too risky and e suppose dey regulated, others believe say if dem regulate am e no go make sense again. But wetin we see for dis past few days NAWA!! Im be like say village Pipo remember "CZ" wey be binance CEO, the regulatory body just dey drag am say Im dey do anyhow for the crypto space, this Matter cause plenty kasala for the market as we see pepper for everywhere. That one never finish, one company for Nigeria talk say "CZ" na Im papa😂. Na here we dey so for the crypto space, na Im make we shook mouth on top this matter for today's episode.. Our guest na beta guru for the space and Im give us insider information as to wetin dey happen. If you wan understand this Matter in toto, Oya click the link and download, you go thank us later. Oya go download and listenEnjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica
Everyday we dey see new things for the crypto space, but dis one wey we wan talk na new thing entirely because many Pipo wey dey crypto Twitter don talk say Im no fit happen.You dey wonder say wetin happen? Na bitcoin blockchain launch token o, and everybody dey surprised because Pipo don talk say Bitcoin na just store of value, others even talk say na shitcoin. But as dem launch dis "BRC20 TOKEN", many Pipo eye don open and dem begin dey reason Bitcoin blockchain again. So for this episode Crossvic and Aishat gather discuss:
If you don dey reason dis matter, this episode na for you.
Oya go download and listen.
Enjoy this episode🎉
Disclaimer - beware nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.
Thank you Follow our Twitter :
https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica
Research don talk say Africa dey middle of blockchain revolution wey dey happen for the world as blockchain education dey happen for everywhere across Africa. Pipo, they put dia money for ground make plenti Pipo learn about this new technology and on top today's episode we get "Ezenmo Blockchain" wey be the co-founder of Blockchain UNN come share with us about how this blockchain fit touch every area of the human life. For this episode you learn:
As the gist dey hot, dis mata go open your eye. Oya go download and listenEnjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica
Many pipo don assume say when we dey talk tech mata, Web3 or blockchain talk make women no put mouth because Im be like na only men dey rule the space. Especially for Africa, di mata na serious one as Im be like say na only for kitchen women suppose dey shine. Na dis matter our guest for today's episode see wey make am say although life no balance originally but for this mata "Things suppose balance". Women suppose dey inside tech, dis passion push am make im establish I'm company "Web3 woman hub" and since dey don enter market, many women don enter web3 space through our guest.Una go learn plenty things for this episode wey go jinja you say nothing dey impossible. If you be woman wey dey build for the space or you get woman wey dey reason say I no fit enter blockchain, Lydia tori go show you the way to go. Oya go download and listenEnjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica
If una don dey follow our podcast on top the optimism ecosystem I know say today gist go sweet una for body as many pipo don ask us say how we fit know if this Optimism wey you dey talk na beta project wey I fit shook my mouth. Na dis question we wan ansa dis week for pidgin palour as Crossvic and Bintuparis take break down the metrics on top Optimism blockchain. For dis episode, you go learn:* The on-chain metrics wey you suppose know about Optimism * Wetin be this Bedrock laucnch wey Optimism dey plan and how im take concern you. * How dem wan take OP stack re-arrange the future of Layer2 solutions * You go also get little gist about Dia Retroactive public good funding.
If you get interest for all dis gist, oya go download and listen to dis episode. Enjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa -https://discord.gg/p
Optimism na one of the major layer 2 solutions wey dem build to solve the problem of Ethereum scalability. Dis ecosystem good so tey im dey attract several builders wey dey build their project on top am. If you no understand how Optimism take enter market, today's episode go teach you everything wey you suppose know about the optimism ecosystem. You go learn things like:
If this mata dey sweet for your heart, oya go download and listen. Enjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegramhttps://t.me/banklessafrica
Sui network don cause kasala for Twitter last week as many pipo dey rant say dem no dey do airdrop. Before we talk airdrop mata, di first be be say:
If you dey interested in this new blockchain wey dey cause kasala for everywhere, Aishat and Crossvic don bring beta gist on top dis mata for today's episode. No be only your ears go hear am, oya go download and give una neighbors. Oya download and listen Enjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica
If you no sabi how you fit sell your project to pipo for dis web3 space, poverty go chop your eye. No cap! But the challenge for many pipo be say dem dey use the marketing strategy wey dem sabi for web2 inside web3 and im dey flop most of the times. Na why we bring Olabisi come this show today (web3 growth marketer) make im explain to us how im dey do marketing for web3 and how any project fit do well for this space. We answer questions like. Wetin be marketing and wetin you suppose know for your marketing to succeed for web3Wetin be the importance of community for dis space and how you fit build active community. Wetin be the active way projects fot grow their social media platforms for this web3Wetin be the best channel to promote your product for this space. If you be Builder for this space or your wan go into web3 marketing, this episode na for you. Oya download and listen Enjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica
Several innovation don come out since the beginning of dis layer 2 scaling solutions.Na there you go find innovations like - Sidechains, Rollups, plasma and channels and all of dem dey come to solve the wahala of scalability on top the blockchain. As all dis innovation dey so, people come dey further ask say which one better pass for all the Layer 2 scaling solutions, na the thing wey I and my co- host(bintu_paris) gather yarn for this episode. So if you get question like:
Dis episode na for you, because una go enjoy the gist and una go learn in a fun way. Oya download and listen Enjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica
As Una don know say if any blockchain ecosystem go dey perfect, im suppose get 3 things wey be :decentralization, security and scalability. However, no blockchain don get dis features complete.The best of them wey be "Ethereum" get 2 out the 3 features: Decentralization and Security but I'm no dey scalable. Na why transactions dey slow on top ethereum and if im go fast, you go pay plenty gas feeMany pipo don dey find solutions to this problem, na wetin dey bring layer 2 solutions to the limelight be that. So if you no understand wetin Layer 2 be, this episode go show you...* Wetin be layer 2 solutions * why we need layer 2 solutions * The difference between layer 1 and layer 2 solutions * Layer 2 projects wey dey make wave currently
So if any of dis be your concern, this episode na for you.Oya download and listen Enjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica
Di secrets of pipo wey don make am dey inside dia tori, if you wan do wetin dem dey do, the best thing to do na to listen to their tori. On dis Pidgin Palour Crypto podcast episode we bin get deep conversation with di founder of Astut Community management agency (Denise). Im na young founder wey dey do big things for the web3 space. Im achievement at a very young age na thing wey dey cause many put eye on top wetin she dey do. For this episode, "Denise" open all Im secrets for us so the public fit learn. As you wan listen to this episode, you go learn:♦️ How Im begin her career for the web3 space. ♦️How you fit land gigs for the web3 space. ♦️The importance of social media as una dey build yourself in the space. ♦️Di wahala wey im face wen im start im journey begin for the space. ♦️Wetin dey give this young founder confidence in her journey.E be true say glory no dey without tori. Make you get inspiration as you listen to dis episode.Oya download and listen Enjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica
Oppression full street last week as many airdrop hunter wey partake of arbitrum airdrop no let us rest for Twitter. Dem just dey buga for everywhere say dey don blow. As una don know say dis life no balance. As many people dey rejoice, some people dey sad say dem no dey qualified. Questions come dey fly everywhere about Airdrops and how dem they work, na him make we bring a senior hunter for this episode where answer questions like. * Wetin be airdrop and how dem dey work. * How you fit do your research to identify projects wey go do airdrop * Wetin you suppose do to dey qualified for a projects airdrop. * How to ensure say you go avoid hackers as you dey hunt for airdrop.
This and more na im we discuss for dis episode, so if you dey curious and wan sabi how airdrop dey work. This episode na for you. Oya download and listen Enjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow us for Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us for linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join us for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us for telegram https://t.me/banklessafrica
Kasala burst for street between the 9th of March to the 13th of March as news enter street say USDC wey suppose be stable coin don dey shake and silicon valley bank shut down operations!.
Fear meet everyone, FUD dey everywhere, dem talk say yawa don gas many people don put their live savings for this stable coin, this cry na him make us go bring this industry expert "Aisha" come pidgin Parlour crypto podcast make she come answer the many questions wey pipo dey ask us.
So if you don dey ask say:
Our guest give answer to all this questions and more.
Oya download and listen
Enjoy this episode🎉
Disclaimer - beware
Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.
Thank you
Follow us for Twitter : https://twitter.com/PidginParlour
Follow us for linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z
Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w
Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/
Come join us for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S
Join us for telegram https://t.me/banklessafrica
Na every day we dey see the massive change wey blockchain dey cause for our world today.
He don dey clear say this innovation pass cryptocurrency alone, Im impact reach Medicine, Agriculture, Digital artistry and many sectors wey we no fit mention.
For this episode our guest "divine gift" share with us how blockchain dey change the medical sector, the thing wey Im share for this episode go answer plenti questions wey dey your mind especially about the mata of record keeping in the health sector. You go learn how dem dey take blockchain dey take solve this issue and many others.
You go get answer to questions like:
So, if you wan take your blockchain education and adventure to the next level, this episode na the real deal for you
Oya download and listen
Enjoy this episode🎉
Disclaimer - beware
Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.
Thank you
Follow us for Twitter : https://twitter.com/PidginParlour
Follow us for linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z
Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w
Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/
Come join us for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S
Join us for telegram https://t.me/banklessafrica
Una don hear say blockchain no be cryptocurrency and cryptocurrency no be blockchain.
The next question wey plenti people dey usually ask be say, if blockchain no be crypto, wetin dem fit use blockchain do again wey no be crypto?
Make we shock you!!!!
Dem don dey play game on top blockchain and this kain game dey different from wetin you don know, the real gist be say "as una dey play this one, you go dey make moni"
Dem call am "play to earn". You dey ask wetin be this?. Na why we go carry Marablossom of Women in DeFi make Im come explain how and why dem create dis games.
For this episode, we ansa questions like
So, if you wan take your blockchain education and adventure to the next level, this episode na the real deal for you
Oya download and listen
Enjoy this episode🎉
Disclaimer - beware
Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.
Thank you
Follow us for Twitter : https://twitter.com/PidginParlour
Follow us for linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z
Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w
Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/
Come join us for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S
Join us for telegram https://t.me/banklessafrica
E no dey possible make we desire say crypto suppose reach every corner for street and we no go go big on education…
Just like una don sabi say, education na the concrete wey this web3 adoption go stand on, na him make we go bring one "Coin Lord" for this particular episode.
Paulito, na O. G for this space especially wen im come to coin mata. So if una don dey ask say "Tokens, Coins, altcoins, Shitcoins - wetin be all these?.
This episode go give you all the answers wey you need. We follow answer questions like:
♦️ Wetin be cryptocurrency and how Im dey take work?
♦️ We don hear about Coin, tokens and altcoin, dem be the same thing or dem different?
♦️How we dey sure say this cryptocurrency no go fade away, wetin make them valuable for the market?
♦️ If I be newbie and I Wan buy my first cryptocurrency, where I fit buy am.
If you get any of this question for mind or una wan brush up wetin you don know, this episode na correct one for you.
Oya download and listen
Enjoy this episode🎉
Disclaimer - beware
Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.
Thank you
Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour
Follow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z
Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w
Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/
Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S
Join us on telegram https://t.me/banklessafrica
Di secrets of pipo wey don make am dey inside dia tori, if you wan do wetin dem dey do, the best thing to do na to listen to their tori.
On dis Pidgin Palour Crypto podcast episode we bin get deep conversation with di founder of Carp_ex. "Big carp" na 22 years old founder wey start im crypto journey wen im be 18 years old!!!
Im tell us the problem wey im face as he dey start out, you see the way wey im tori take be go make you get hope for your mind.
♦️E tell us wetin carry am enta web3 space when he still dey school
♦️Why mentor dey important for your journey
♦️Di wahala wey im face wen im start im journey wen e be 18.
♦️And wetin e dey build now for di space.
♦️ Finally, im come tell us how anybody fit start OTC trading
E be true say glory no dey without tori. Make you get inspiration as you listen to dis episode.
Oya download and listen
Enjoy this episode🎉
Disclaimer - beware
Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.
Thank you
Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour
Follow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z
Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w
Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/
Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S
Join us on telegram https://t.me/banklessafrica
Many pipo still never understand the mata of this blockchain wey we dey yarn, dem truly dey wonda why everybodi dey mention am for street and wetin dey be say, if dem no understand how this thing dey work, he go dey difficult make dem use am or tell their neighbor about this new technology.
Na why for this particular episode of the Pidgin Palour podcast, we further go into details of :
♦️Wetin be blockchain and why dem create am?
♦️Dis blockchain get any problem so or na perfect technology?
♦️Wetin be blockchain trilemma?
♦️How Ethereum blockchain dey take solve this trilemma?
♦️How this merge wey Ethereum don do take affect their project and wetin other projects fit learn from them?
Na this things and more wey we discuss for this episode, when you don finish listening to this episode, your confidence and knowledge for this space go don increase.
Oya download and listen
Enjoy this episode🎉
Disclaimer - beware
Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.
Thank you
Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour
Follow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z
Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w
Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/
Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S
Join us on telegramhttps://t.me/banklessafrica
Security na one big matter for the world wey we dey today, everybodi dey find better way take protect their goods, possessions, loved ones and their assets.
So, in don dey important make we talk about Web3 security and how person fit protect him identity and asset for this space.
Na the koko of our gist for this particular episode be this, as our guest "salvi_cee" open our eye for the plenti ways pipo dey loose diar money for web3 and you fit avoid am.
We cover ma like :
Why him dey important make we talk about Web3 security?
Wetin be digital wallet and how hin dey take work
Wallet strategies person fit use stay SAFU and how you fit recover from scam if you Don fall victim before.
Oya go download, listen and share give your family and friends because if anything happen for this to your asset for his, customer support no dey to call.
Stay SAFU💯
Thank you
Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour
Follow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z
Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w
Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/
Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S
Join us on telegram https://t.me/banklessafrica
Plenty people don dey shook eye inside web3 for this 2023 because say the news about the industry don dey sweet for the street.
People bin ask us about whether e go possible to make strong career inside blockchain without buying or selling or coding? Na the question we don answer for today's show.
My guest na today na one ogbonge web3 writer wey dey build correct career for this space and she share hin story gives us, how she started and wetin she don do to build hin career.
She answer questions like - -
♦️Wetin be blockchain career?
♦️Wetin make person go choose this way?
♦️Examples of work wey dey inside blockchain?
♦️Jobs dey truly for crypto space?
♦️Where person go find these opportunities?
♦️Wetin person need to start?
Go carry your sit, get Una pen because as you finish this episode, your eye go clear as you see say you Don dey leave plenty money for table.
Enjoy🎉🎉
Follow Pidgin Parlour for all platform
Follow our Twitter https://twitter.com/PidginParlour
Follow us on linkedIn
https://www.linkedin.com/in/bankless-africa-799178233
Subscribe to our newsletter https://banklessafrica.substack.com/s/pidgin-parlour
Learn more about crypto and web 3 on our website https://banklessafrica.com/
Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S
Join us on telegram https://t.me/banklessafrica
Person wey no understand how cryptocurrency dey work go think say the people wey dey win for the space just get luck.
However, no be so he dey happen - - as many newbie dey always ask us say when the current bear market wey dey for street go finish?
For this episode of the Pidgin Parlour Crypto podcast, we bring Mr Chiakwa - An OG for Technical and Fundamental Analysis wey answer many questions wey dey your mind on how you go remain profitable for any season for cryptocurrency.
He follow us answer questions like:
Wetin dey cause bear and bull season in cryptocurrency?
Wetin be the best practices for investors in this seasons?
As we dey bear season now, how we fit know when bull season go be?
As market don red, wetin I suppose know to make money for this bear season?
If you get any question concerning wetin go happen for the crypto space for 2023, this episode give you correct overview of wetin the market go talk.
Listen and tell your frens say update don dey!
Follow Pidgin Parlour for all platform
Follow our Twitter https://twitter.com/PidginParlour
Follow us on linkedIn
https://www.linkedin.com/in/bankless-africa-799178233
Subscribe to our newsletter https://banklessafrica.substack.com/s/pidgin-parlour
Learn more about crypto and web 3 on our website https://banklessafrica.com/
Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S
Join us on telegram https://t.me/banklessafrica
"Decentralized Finance (DeFi) na financial system wey dey operate on top decentralized network, like blockchain. DeFi wan provide financial services wey dey open, transparent, and accessible to everybody, no need for intermediaries like banks or financial institutions. DeFi allow users access financial services like borrowing, lending, trading, and payment processing directly on top blockchain, wey go allow dem interact with each other directly and without need for trust. DeFi get the potential to disrupt traditional financial systems and create financial system wey go include everybody."
Ever since FTX and many of the centralized finance platform show us shege through out this year, many people don dey remove their mind small small for Centralized Finance come Decentralized Finance because as you and I Sabi say nobody wan chop breakfast twice, na why we begin a new series this week for the Pidgin Palour Crypto podcast where we begin dey talk about Decentralized Finance.
For this episode, our guest na one ogbonge for the DEFI space, hin name na KING JOSH and he go teach us why decentralized finance dey important and how any newbie fit begin their journey for the space.
Nothing beta pass make you see person wey don dey trenches before wey come become big man because of web3 and DeFi share the tori of hin journey with you.
Na wetin King Josh do for this space be that, so jump on it and learn for yourself how you fit use DeFi make your life beta.
Hope say you enjoy this episode.
We beg, make you share, download, rate and leave review for hear so say we go fit make this podcast better. Thank you🫱🏾🫲🏾🎉😉
Follow Pidgin Parlour for all platform
Follow our Twitter https://twitter.com/PidginParlour
Follow us on linkedIn
https://www.linkedin.com/in/bankless-africa-799178233
Subscribe to our newsletter https://banklessafrica.substack.com/s/pidgin-parlour
Learn more about crypto and web 3 on our website https://banklessafrica.com/
Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S
Join us on telegram https://t.me/banklessafrica
If you no know wetin dey happen for street, dem go carry wetin be your own give another person wey get street sense.
Na him be say dem don shop your eye free of charge.
Because, we no won make you be victim, na why we bring the Lady Hayley for this latest episode as she open eye for us intoto everything wey dey happen for crypto space.
All the way go the fall of "Terra, 3AC, Celsius and the latest kasala wey burst for street - - FTX debacle.
Our guest talk plenty tori upon this matter but I go just say a few point wey she talk…
Finally, she talk say if SBF get good relationship with CZ, fire for no burn SBF but as rivalry don enter amidst dem and CZ collect him money wey dey FTX the market shook and all the small small trader follow the Jagaban.
One wisdom she close with be say, relationship dey important for anything wey we dey do for this life.
hear this episode for full gist!
Follow Pidgin Parlour for all platform
Follow our Twitter https://twitter.com/PidginParlour
Follow us on linkedIn
https://www.linkedin.com/in/bankless-africa-799178233
Subscribe to our newsletter https://banklessafrica.substack.com/s/pidgin-parlour
Learn more about crypto and web 3 on our website https://banklessafrica.com/
Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S
Join us on telegram https://t.me/banklessafrica
For this episode, we dey feature Igwenagu Emmanuel Chinecherem, founder and CEO of Gentle Crypto. Gentle Crypto nah organization wey dey provide financial and crypto education and more.
Crypto no be just about trading and thinking of making quick money! It's about understanding wetin the technology be for and how best you fit adopt am and thrive in chaotic times.
Emmanuel talk about him journey into the world of crypto and how e don grow to appreciate the technology since joining.
Emmanuel talk say after them scam am plenty plenty for so called crypto investment platform, him don tire for inside crypto space him come decide to dey run things by himself and nah wetin make am start Gentle crypto, so that him go fit help other people avoid the kind shege wey him see for inside the crypto space.
Hin talk say him motivation na say him don get strong mind about crypto via all the knowledge wey him don gather and whether bear or bull market him no go shake. Hin talk say hin dey tell people say if you go survive for inside the crypto space you gats get strong mind. Whether you win or lose always dey positive.
The advantage and disadvantage wey dey for buying crypto dey depend on when you buy am if you buy am when e dey low you get high chances to dey on profit for long, if you buy when e dey high, you go dey patience to gain. Emmanuel drop plenty practices for this episode inside wey go fit help everyone survive and thrive for crypto inside.
Enjoy 💯🎊✌🏾
If you enjoy the episode; no forget to download am, rate us and share with your people dem.
The Pidgin Parlor crypto show dey educate the everyday African on Web3 and crypto topics, dey yarn them the latest updates and tori for the crypto ecosystem, dey highlight projects, ecosystems and man dem wey dey impact and drive the crypto adoption for these African streets. The Pidgin Parlor Crypto Podcast na your plug if you wan dey informed on all things wey concern Bitcoin, DeFi, NFTs, Web3 and others, even as it take dey enter streets inside!
Disclaimer:
Nothing wey anybody talk for this show na financial advice. Every man wey come talk for this show just dey come yarn hin own opinions. Remember say the number one rule for this Web3 street na to run your own research!
Make we connect💯💯🎊
Follow our Twitter https://twitter.com/PidginParlour
Follow us on linkedIn https://tinyurl.com/yzjwjd53
Subscribe to our newsletter https://banklessafrica.substack.com/s/pidgin-parlour
Learn more about crypto and web 3 on our website https://banklessafrica.com/
Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S
Join us on telegram https://t.me/banklessafrica
Na interview with Paulito for this episode sha.Paulito na BanklessDAO/Bankless Africa contributor, hin dey crypto space for long, wey hin gather plenty experience for huge crypto organizations like Revewz and DIA.
edey well known say even people wey don dey inside Web3 and crypto street no too dey understand cryptocurrencies. Paulito for this interview, yarn us for pidgin wey be say people wey dey streets and all man wey sabi speak pidgin go understand wetin blockchain technology be, how dem take arrange(build) am, how it take dey work and how this blockchain technology take dey power crypto.
If you enjoy the episode; no forget to download am, rate us and share with your people dem.
The Pidgin Parlor crypto show dey educate the average African on Web3 and crypto topics, dey yarn them the latest updates and tori for the crypto ecosystem, dey highlight projects, ecosystems and man dem wey dey impact and drive the crypto adoption for these African streets. The Pidgin Parlor Crypto Podcast na your plug if you wan dey informed on all things wey concern Bitcoin, DeFi, NFTs, Web3 and others, even as it take dey enter streets inside!
Disclaimer:
Nothing wey anybody talk for this show na financial advice. Every man wey come talk for this show just dey come yarn hin own opinions. Remember say the number one rule for this Web3 street na to run your own research!
Follow our Twitter https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn https://www.linkedin.com/in/bankless-africa-799178233 Join us on telegram https://t.me/banklessafrica
Subscribe to our newsletter https://banklessafrica.substack.com/s/pidgin-parlour
Learn more about crypto and web 3 on our website https://banklessafrica.com/
Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S
Crypto don dey change many lives around the world, but how many of our own African people dey get proper education and updates about this crypto level wey, everybody, don dey yarn?
Na with this fact in mind why Bankless Africa dey introduce the Pidgin Parlor Crypto podcast.
Podcast wey we go dey gather talk all things crypto and web3 so our listeners and everyday Africans for street no go carry last.
For every episode, Pidgin Parlor Crypto Podcast go dey sama una with latest crypto tori, updates, and interviews with ogs dem for inside this crypto space.
So make una dey anticipate as Pidgin Parlor Crypto Podcast go carry una on a crypto journey wey una no go ever forget.DisclaimerBut make una know say nothing wey we go yarn for any episode of the pidgin parlor podcast be financial advise. Make una always run una own research.Pidgin Parlour Crypto Podcast na Bankless Africa podcast we dey bring crypto/web3 education and culture to over 75 million pidgin speakers in and outside Africa.