Hi, i'm Yakubu Umar Omede. Through this podcast i would be bringing you exciting football news using the pidgin language. In this podcast i'm going to be talking about game in the Europe top 5 leagues and also the Uefa competitions (Uefa Champions League and the Europa League). Join us every Friday as we bring you exciting football stories. God bless una.
For this episode of Konfam Futubol,we go take una through the journey of football tactics, from the old-school 4-4-2 formation to the modern-day style wey Pep Guardiola don bring come football. We go gist about how Guardiola don change the game with him play-from-the-back approach and how teams all over the world dey try copy am, whether e dey work or e no dey work. If you wan sabi how football tactics don evolve and wetin the future fit hold, then this episode na for you!
UEFA passed a judgement that they would not impose any sanctions on teams that decides to join a new competition that is not under UEFA. This ruling has brought back the talks of the super league, but it has received a lot of backlash. Find out all about the ESL
This season no wan set for Ten Hag and him boys, as e be say dem don lose 9 out of 17 matches. Also I chook mouth ontop the latest things wey VAR dey do
This particular episode is special to me, because I have an uprising baller who would soon grace the world’s biggest stage. This is the story of Adeboye Ridwan, A passionate footballer who would stop until he achieves his footballing dreams.
A whole lot has been going on in the beautiful game of football, as City and Real are set to battle for a spot in the UCL final, and also the battle of Milan, as Inter Milan face off with Ac Milan. Naglesman confirmed he wouldn’t take the chelsea job, so what’s next for Chelsea? Kompany or Poch? The two horse race in the league is heating up as Arsenal are beginning to falter, with Pep and his boys breathing down their neck.
Graham Potter couldn’t replicate the magic of Harry Potter, which has now led to his dismissal as Chelsea boss after an abysmal performance in recent months. Who is the best man for the chelsea job?
Chelsea have found themselves in an unwanted situation this season and fans are calling for Graham Potter to be sacked. Would Boehly heed to that?? Firmino also set to leave Liverpool at the end of the season
And then there were 8!!! The quater finals of the FIFA World Cup is upon us, and heavyweights like Portugal, Brazil, and Argentina are in the line up. But there is Morocco, who only became jus the fourth African team to make it to the semis, so the question is that would a shock the world once more???
Konfam Futubol don show once again, and this time, na world cup I dey shook mouth inside. Teams don digger am out with themselves and now everybody just wan enter round 16. Some don qualify, while others still dey battle. How this qualification go sup and who go face who?--- This episode is sponsored by · Anchor: The easiest way to make a podcast. https://anchor.fm/app
After plenty months wey our dear football season finish, we don dey find one or two things do, but last last, the new season don show. This season go hot wella.
17 league goals for a 37 year old player na one thing wey dey hard to see for football nowadays, but Ronaldo dey do am with ease. Why some united fans dey say naim be the problem?
The ogas dem for inside Old Trafford don identify four person wey fit be the club new coachee next season, Pochettino, Enrique, Ten Hag and Lopetegui na d names. Who go be the manager las las...... The Jollof Derby dey sup today 🇬🇭 VS 🇳🇬 for world cup spot
I throway salute to my konfam listeners. With the kitikiti katata wey dey shele between Ukraine and Russia, the UK government con decide to sanction people wey get close link with Russia president, & Chelse owner (Abramovich) dey among. Wetin this sanction mean for the team?
Na Kourt Zouma dey trend for internet in the last few days, on to say e kick him cat. No be say wetin Zouma do good o, but the things wey con dey come after the incident naim worst. How racism wan con take end?
Ijora Badia!!!! A suburb area in Lagos, Nigeria... How would a bus conductor be fighting you on a Monday morning 🤣🤣🤣🤣
Twale to my konfam listeners, as e dey be like this en, group stage games don finish for AFCON oo, and some teams don qualify for round 16. Nigeria, Senegal, Egypt, Mali and some other teams don qualify. Make e for no loss, how the round 16 games go be?
Zazuuuu Zeehhh!!!! One time, 3 gbosa to my konfam listeners. I salute all of una. I wan appreciate all of una for listening to my podcast, as e be say una make 2021 a great year. God go bless all of una. As e be, AFCON 2022 go soon start for Cameroon, and e sure me say e go be bang. For the final episode of the year, i talk about the groups, and also some big name players to watch. Make una listen and Share.
This episode is sponsored by · Anchor: The easiest way to make a podcast. https://anchor.fm/app
Happy new month to my Konfam listeners 🙌🙌, una know as e dey be na, festive period football naim dey sweet pass, as una go dey chop chicken one side, dey watch una favorite team play for the other side. This December na, na we and football gather dey. No forget to follow United Tori page on Instagram @UnitedTori and biko sharply go subscribe to United Tori YouTube channel @UnitedToritv
Happy Friday to my Konfam Futubol!!! As e dey be like this en, Qatar, Denmark, Germany and Brazil don officially qualify for world cup wey dem go play inside Qatar next year. Other teams go digger am this weekend to book their own place for the world cup. Meanwhile, Stephen Gerrad don return back to the premier league
After 14 months in charge, Barcelona don finally tire for Koeman matter as dem kukuma say Oga, e don do, con dey go. Naso Dem take sack Koeman oo. Solksjaer yansh sef dey fire as Manchester United don give am 3 games to take do well. First of the games na against Tottenham on Saturday, how Ole go perform?
To my Konfam listeners, I hail o.. Dem just conclude the first leg for the league of the big boys (UCL), and for this weekend, domestic football dey come bigger and better. El Classico, Manchester United vs Liverpool and better better fixtures dey shele for Europe Leagues... Wetin go sup this weekend? Make una no forget to like United Tori page on Facebook, una fit also follow United Tori on Twitter and Instagram @UnitedTori. God bless una.
HAPPY FRIDAY MY PEOPLE...No be small something happen during this last international break o, as e be say the G.O.A.Ts of football (Messi and Ronaldo) been break and set new records for their country...... Big congratulations also to France as dem don win nations league... The Koko now be say, Premier league don return. JOY CHOKE.
Chiefs and Oga madam dem, I throway salute for una o🙌🙌🙌.... This weekend of football wey just pass en, e no disappoint us at all... Plenty plenty tori just dey to talk about am.. make una listen to this episode to hear wetin sup for weekend.
Twale to my Konfam listeners🙌🙌🙌.... Ronaldo and Messi still prove to us why dem be the GOATs🐐🐐 of football as both of dem perform wonders for this week champions league.... Liverpool Vs Manchester City tomorrow, how e go be?
Arsenal say omo, we no wan dey play with anybody again, now seriousness choke for dem as dem don win 3 straight premier league games✔️✔️✔️..... Dem say Premier league title is the goal🏆🏆. Man U and Chelsea sef Jones this week
Shoutout to my Konfam listeners.Lukaku and Ronaldo carry their fight from Seria A come premier league..... Salah sef no dey Jones as e be say this season golden boot race go choke
My Konfam people, I hail o, una boy loyal.. This premier league season en, nobody know wetin go happen as e be say the league this year go choke wella. Man United, Man City, Liverpool and Chelsea, these team no come play.... Who among them go win league this season
Happy Friday to my Konfam listeners. As e be like this, no team come play for league o, as e be say all of them wan fight for the title especially the top 6 sides, Chelsea, Manchester United, Liverpool, Manchester City, Tottenham and Leicester . How the transfers wey Dem make go take help them win the league?
One time☝️ 3 gbosa 👊👊👊 for my konfam listeners, I dey hail oo. This transfer window wey just end shock every football fans bcos some kain transfers wey person no expect just shele...... How e go take get impact for the title race for Premier league and La Liga?
Shoutout to my wondaful listeners 🙌🤙👏, I dey hail oo. Referees now don join mouth together talk say make we change the way we take dey blow our whistle this season. Dis decision wey dem take, how e go take affect teams?
Twale🙌 to my Konfam listeners wey dey shine pass 🌟... Anoda Futubol weekend don show and joy just boku everywhere as we go sidown watch wetin we love. Another thing be say Arsenal no come play this season o, as e be say dem no dey play with anybody for this transfer window.
After plenty months wey we wait, football don finally come back and no be small sontin naim shele for this gameweek o as new boys Brentford nak on London team.
Joy choke for every football fans as e be say new season of Futubol don show. Premier league, La Liga and Bundesliga don come back.
This transfer window na one of the Ogbonge one wey we don see as some Kain surprise things dey shele. Just yesterday Barcelona konfam say Messi dey comot for the club and Man City also confirm the singing of Jack Grealish. Make una no also forget to register for United Tori fantasy league.
This Friday cold pass the penalty wey Jorginho and Fernandes dey score😁😁. For today episode, i been talk about wetin i feel say Varane go add to this Manchester United team as dem sign am, and i shook small mouth ontop transfer matter. You be King, and kings no dey fear anything..... Na why me i dey tell una wey be kings say make una register for United tori fantasy league and una fit dey win ogbonge prizes.
Joy choke for Man United fans as Dem don finally unveil But for the other Tori, na joy e dey be for anybody wey dey work to see positive result for him work. Every player prayer na to carry even if na one trophy for him team.... But e no dey like that for Harry Kane matter. Wetin dey shele?
This na konfam Futubol and for today episode, I bring una beta Tori wey concerning the premier league season wey go soon start and also the yanmayanma racism wey dey spoil football.
In this episode, i gave a rundown on the route to the Euro 2020 final and also some brief transfer news.
In this episode, I invited 2 guests to the podcast and we gave an analysis on the Away goal that was scrapped by UEFA recently
My thoughts and prayers are with Eriksen. This particular episode, I gave an analysis of the stats for the Euro 2020 ranging from the top scorers to the most clean sheets. The transfer window is also open so transfer news ain't out of it, as I also talked about the latest transfer news.
In today's episode, i gave a brief pre match review on teams playing in the Euro 2020, and i also talked about the Latest transfer news.
In this episode, i gave an in-depth analysis on Chelsea's journey to becoming champions of Europe
Football as a beautiful game, is a sport where the unexpected happens. In this episode, i talked about the just conclude Champions league and Europa league final. Listen, share and be blessed.
This episode is sponsored by · Anchor: The easiest way to make a podcast. https://anchor.fm/app
In this episode, i talked about the emergence of the European Super League, its rise and fall. I also talked about the new champions league format and ended it all with seniorman Kelz's fine form
This episode is sponsored by · Anchor: The easiest way to make a podcast. https://anchor.fm/app
in this episode, i talked about the uefa champions league games and the europa league. i also gave my brief overview on VAR.
This episode is sponsored by · Anchor: The easiest way to make a podcast. https://anchor.fm/app
In this episode, I talked about the uefa champions League draw and the Europa League draw. Also reports from the premier League and the Fa cup. Listen and be blessed
In this episode, i talked about the uefa champions league and gave a brief reports of the matches played and also how the return fixture is going to be
Hi guys, this is a pidgin podcast on football. In this podcast, we'd bring you news about all the happenings in football. Join us every Friday as we bring football news to your listening.